English,Pidgin "My people, good evening!","My people, good evening o!" Uh... my name is Kabiru Sule.,Ehm my name be Kabiru Sule. I come from Kastina State.,I dey hail from Katsina State. My mother is an Edo w-... is an Edo woman and my father is a Kastina man.,"My mama na Edo w-... na Edo woman, and my papa na Katsina man." Uh... I am thirty three years old.,Ehm my age be thirty three years old. I was born in nineteen eighty four.,Na nineteen eighty four wey de born me. "Uh... I want to tell you a story on, on how our establishment was kick started.","Ehm I be wan give una tory on, on how our establishment kick start." The thing started like uh... ten years ago.,Di ting start like ehm ten years ago. Uh... ninety... two thousand and seven.,"Ehm ninety, two thousand, and seven." Which means my mother likes to work out so much.,"Wey be sey, my mama like exercise well, well." "When she was young, before she even gave birth to us, she was an athlete.","When she dey young young, before she even born us, na athlete she be." "So, since she... since she's retired now and has given birth to us all, now she's set up the gym.","So as she, as she come retire, come born us finish, she come set up di gym." "Gradually, that is how we started.","Small, small, na so we start o." "My people, for your...","My people, for, na..." We started with four boys' quarters in our house.,We start with four boys quarter for our house. "Which means that if it rained, you would see the water get everywhere.","Wey be sey, if rain fall sef, you go see di water go soak everywhere." "That's how my brother and I, we were still little kids, (at that time, we were still in primary school) we would carry buckets of water with my mother.","Na so me, my broder, small children (dat time, we still dey primary school) we would carry bucket of water wit my mama." We would be carrying... we would be packing it.,"We go dey carry, we go dey pack am." "We would pack the water, climb the stairs and throw it away, climb the stairs and throw it away.","Pack am, pack am, pack di water, climb upstairs, troway am." "We would pack the water, and carry it.","Pack water, carry o." The same thing.,Di same ting. We would just rinse and repeat the proccess.,"We just dey rinse, and repeat di proccess." "So, as God blessed us, we started working hard. Then we started moving on.","So as God come bless us, we come dey work hard, we come dey push am." "Before we knew it, we found a place we could rent.","Before we know, we come find place wey be sey we go rent." But I'm in Kaduna now.,"But where I dey now, na Kaduna." "Now we're in Kaduna, in the North.","Where we dey now na Kaduna, for di North." "And in our stadium, there are places which they, which they are giving out, which they are renting out to people.","And for our stadium, e get places wey dem, wen de dey give out, wey be sey de dey rent out to people." "So, if you want to get... if you have one package that you want to run (maybe sports; maybe it's a dance studio you want to run), you will pay the... you will pay the Kaduna government.","So if you wan get, if you get one package wey you wan run (maybe na sport, maybe na dance studio you wan do), you go pay di, you go pay Kaduna Government." The Kaduna government will give you the place for maybe five or ten years.,"Kaduna Government go give you di place for maybe five, or ten years." "So, that's how we sat down, then we opened it, and then we talked to a lawyer.","So na so we con sit down, we come open am, we come talk to one lawyer." "So, the lawyer now, as we were opening it, we... he asked us what name we would want to give it.","So di lawyer now, as we dey open am, we, im tell us sey which name we wan give am?" What name do we want to give the business?,Which name wan give di business? My mother said that...,My mama talk sey... "Because at that point, it wasn't like my mother didn't love me.","Because at dat point, no be sey my mama no love me o." "Uhuh, my people, my mother loves me a lot but her favorite is my brother, Muhammed.","Ehen my people, my mama love me well, well, ehn but her favourite na my broder Muhammed." "So, as they asked her, then the lawyer...","So as de come ask am, di lawyer come..." "When the lawyer asked my mother what she wanted to call gym, she said, ""Muhammed Gymnasium is what we want to name it.""","As di lawyer come ask my mama wetin you wan call dis gym, she come talk sey na Muhammed Gymnasium we wan give am." Momo's Gym.,Momo'S Gym. "Me, a grown-up, I didn't even have a problem with it like ""ah, why didn't they name it after me?""","Me, elder man, me, I no even get problem say ah why de no call am my name o?" Give it another name!,Give am one oder name! "But at that point, me, I just knew that we were starting a business and we would not be packing...","But at dat point, me, I just know sey we dey open business, and we no go dey pack..." "We would not be using buckets, water buckets to remove water from our gym any more.","We no go dey use bucket of water, bucket to dey pack water from our gym any more." "So, before we knew it, the lawyer said well, the place, the stadium where we were is called Murtala Muhammed, Murtala Muhammed uh... Stadium.","So before we know, di lawyer come yarn sey toh di place, di stadium wey we dey is call Murtala Muhammed, Murtala Muhammed ehm Stadium mtschew." "So, the lawyer said well, if we put my brother's name there, then it w-... it will be like this Murtala Muhammed owns the place.","So di lawyer come talk sey toh if we put my broder name for dere, den e go, e go look like sey na di Murtala Muhammed wey own di place." He asked how many children she had.,Sey how many children she get? So my mother told the lawyer she had two sons.,Naim my mama come tell di lawyer sey she get two sons. What is the other son's name?,Wetin be oder son name? Kabiru.,Kabiru. "At the time, I didn't know whether the guy was just fooling my mother.","At dat time, me, I no know wheder di guy just dey scope my mama o." "He told her, ""well, Kabiru. People don't really use Kabiru that way, for business.""","Im tell her sey toh Kabiru, de no dey too use Kabiru like dat for business." "Use Kabiru for business, for business.","Use Kabiru for business, for di business!" "So, that's how the story goes.",So na so di story be. How they started calling the place Kabiru Gymnasium.,How de start to dey call di place Kabiru Gymnasium. It's not like it's really a fantastic thing.,No be sey na one kind fantastic ting. "Because people, I have heard people say...","Cause people, I don hear people dey talk sey..." "That's how it is, my, my people, you should hear the story.","Na so my, my people, make you hear di story o!" "I was in the gym one day, I was working.","I dey gym one day, I dey work." I know I have gone off course from what I was... wanted to tell you.,I know sey I don derail from wetin I dey give you. "It's history but, I just do, want to tell you...","Na di history, but I just do, want give you..." It's one very good example now.,Na one better example now. There was a day I was working hard in the gym.,E get one day wey I dey work hard for gym. "The clients that were there, who come to work out with us, they didn't know that me, I was, I was the owner's son.","Di clients wey dey dere, wey dey come dey work out wit us, de no know sey me, I be, I be madam pikin." "And me, I don't like to show off anywhere I go.","And me, I no like to dey show mysef anywhere I go." "I like to be humble, be quiet, without telling people that...","I like to dey humble, dey quiet, make people no know sey..." "So that way, you will, you will know who is who.","So dat way, you go, you go know who be who." "As I sat down, this one client was trying to get to know me.","As I sit down, na so one client come dey meet me." Then he started telling me some funny gossip.,E come start dey give me one kind gist. I just looked at the guy.,I just look di guy. "The gossip is that, he said, ahah!",Di gist be sey e say a'ah. "He heard that the woman who owns this place (he didn't know she was my mother), he said that the woman who owns this place, that she only has one child.","Sey im hear sey di woman wey own dis place (im no know sey na my mama), sey di woman wey own dis place sey na only one pikin she get." Ahah!,A'Ah! "I said, ahah, Simbo what's this guy saying?",I say haba Simbo wetin dis guy dey talk? She has only one child?,Only one pikin she get? "And she doesn't have a husband, and it's her boyfriend...","And she no get husband, and na her boy friend..." She is... she is sleeping with all these young men.,"She dey, she dey sleep wit all dese young, young men." And he's the one giving it to her.,And na im dey give am. "My people, do you see this kind of problem?","My people, you see dis kind problem?" I don't know...,I no know. Why rumours?,Why rumours? Why do we really like spreading rumours?,Why we too dey carry rumours? You don't have the facts.,You no know your fact. You don't know anything.,You no know anyting. "Now, I called this guy later on.",Now I con call dis guy later on. "The next day, I let him say all he had to say.","Di next day, I leave am make im dey talk im talk." We laughed all through.,"We laugh, laugh, laugh." "Then the next day, I called him aside.","Next day, I come call am aside." "I said, come let me...","I say come, make me!.." "Ah, come on boss, come, let's talk, let's talk.","Ah my, my, my chairman, come, moh we talk, moh we yarn!" "I then pulled him to one side and told him ""look, that story of yours you heard, that you... that you were telling me yesterday... that story you told me yesterday, it did not please me.""","I come pull am to one side, tell am sey see dat your story wey you hear, wey you, wey you dey yarn yesterday, dat tory you tell me yesterday, di ting no sweet me." """Because this gym, is my mother's gym.""","Because, dis gym, na my mama gym." """First and foremost, she has children.""","First of, she get children." """She doesn’t have just one child.""",No be just one pikin she get. """She has several children.""",She get children. """I am her last child.""",I be her last pikin. """And me, talking to you, I am older than you by two or three years.""","And me wey dey talk to you, I senior you wit like two, three years." """We have four more...""",We get oder four... """I have four siblings.""",I get four siblings. """Some of them are married with children.""","Some of dem don marry, don get children finish." """So... and the fact that... you were saying that she is chasing after young men, my mother is happily married.""","So and di fact wey be sey de talk sey she dey follow young men, my mama is happily married." """My father is alive.""",My papa dey alive. "So, that's how one thing led to another and I then I became good friends with this client.","So na so one tin led to anoder, I con become good friends wit dis client." "And uh... as God blessed us even more, we moved from Murtala Square.","And ehm as God con bless us extra, we con move from Murtala Square." "God blessed us, then we bought our land and we built our structure on it.","God bless us, we con buy our land, we come build our structure ontop am." "Even today, this client still comes in, still comes to this gym and, he has become, like a part of our family now.","Till today, dis client still dey come, still dey come dis gym, and im don become like family to us now." My name is Adeniyi Moruf Mustapha.,My name na Adeniyi Moruf Mustapha. "Uh... my... I, I... my State is Oyo State.","Eh my, I, I, my state na Oyo State." "Although I was born in Lagos and everything about me is in Lagos, I do it... I, I attended uh... CMS [Church Missionary Society] Primary School, which is in Bariga.","Aldough na Lagos dem born me, and everyting about me, na Lagos I do am, I, I go to eh CMS primary school wey dey Bariga." "And uh... from there, I attended uh... CMS Grammar School, which is also in Bariga.","And eh from dere too, I go to eh CMS grammar school wey dey Bariga too." "And myself, where I am staying is very close to... is very close to Bariga.","And even me sef, where I dey stay, very close to, e dey close to Bariga." So Bariga is not my birth place!,And so I no be Bariga born o. "Ab-... I mean, I am not a ga-... Bariga boy.",Ab-... as in I no be ga-... Bariga boy. But in one way or the o-...,"But one way, or di o-..." "Uh somehow, somehow I will say uhuh, I am with Bariga in a way... in a way.","Eh somehow, somehow I go say ehen I dey wit Bariga somehow, somehow." So there was a time that my father felt I was not doing well in CMS where I was.,So e get one time wey be sey my papa feel sey I no do well for CMS wey I dey. Then he decided to take me to uh... a boarding school.,E come look say okay make im carry me go eh boarding school. Maybe that will help me improve.,Maybe dat one go help me take improve myself. So I went to...,So I go to... Then he took me to Ibadan.,Den e come carry me go Ibadan. So I went to Emmanuel College High School.,So I go Emmanuel College High School. Uh... from there... I spent only one year.,Eh from dere I spend only one year. "Afterwards, it looks like he was not really happy with the thing.","After, e be like sey di ting no come sweet im belle well, well." "Then he said, okay, it looks like I, I, I, I n-... I, I still wasn't performing like he wanted.","E come say, okay e be like sey I, I, I, I n-... I, I still no do wetin im want make I..." "That's m-... uh... I mean, my result happened to show that I was not up to the standard I should have been.","Dat'S m-... eh as in be sey, my result say di ting never dey kajad as e suppose be." So he brought me back to Lagos.,E come carry me come back come Lagos. Then I went to a Muslim School.,Den I come go one Muslim School like dat. The name is Toyyibat Comprehensive High School.,Di name na Tayyibaat Comprehensive High School. And that was where I finished my Secondary School education.,And na dere I come finish my secondary school. But what I will remember... why...,"But di ting wey I go remember, why..." Because I studied...,Because I studied... Uh... I studied Accounting in school.,Ehm I read accounting for school. "But if I remember well enough what led me into studying this subject... because the thing that, that I really wanted to do was Electrical Engineering.","But wetin I go remember wey make me read dis course, because di ting wey, wey really sweet my belle make I do for my life, na electrical engineer." Because I remember that I used to get my hands into everything uh... electrical when I was a kid.,"Because I remember dat time when I dey small, everyting wey concern eh electric, na im I dey put hand." "And I, I really love the job.","And I, I like di job well, well." So he called me this one day.,"So e come get one day, e come call me." When I was...,When I dey... I think I was in Senior Secondary School [SS] One.,E be like sey I dey SS one. He called to ask what profession I would like to go into.,E come call me sey wetin be di job wey I wan do? If I... If I wanted to go to school...,"If I, if I want go school..." "And myself uh... when, when...","And me eh when, when..." "Before he took me to Ibadan, I was in CMS.","Before im carry me go Ibadan, I dey CMS." "B-... uhuh... before he took me to Ibadan, when I was in CMS, I...","B-... ehen before im carry me go Ibadan, when I dey CMS, I..." "After my uh... JSS three, when I came back, I was about to start SS.","After my eh JSS three wey I come, I want enter SS." So I remember that I didn't... I didn't continue.,"So I remember sey I no, I no resume." Maybe I may...,Maybe I may... What I can... I can say I was responsible for is that I did not resume for the SS [Senior Secondary] classes on time.,"Di ting wey I go fit, wey I go fit talk sey e cause am be sey I no resume SS one on time." "So by the time I decided to resume studying, the science class which should have led me into the path of Electrical Engineering was already in full swing.","So by di time wey I go say make I go resume, di science class wey suppose put me for electrical, de don start." "So when I attended classes with them for like uh... almost... nearly a month had passed already, mstchew!","So when I come stay dere for like eh almost, one month don nearly knock mtschew!" I just felt like I wasn't understanding what they were doing.,I just observe sey e be like sey I no grab wetin de dey do. I just took my chair to uh... art... uh... art class.,"I just carry my chair go eh art eh, art class." No.,No. Art class!,Art class! So I was done with the second term when my dad called me.,"So after wey I don finish second term, naim my papa come call me." "And I know that what t-... led to this again was that there was no one to tell me that if you want to do such and such thing, don't leave the...","And I know sey di ting wey t-... cause am too again be sey nobody wey go fit tell me sey, if you want do so, so, so ting o, no comot for." "So since I had moved into the art class, he asked, ""what exactly do you want to do?""","So as I don go art class, e come ask sey wetin you want do sef?" Then I said electrical engineering.,I come say na electric. "He said uh... ""you are fooling yourself!""",E say eh you dey fool yourself! """Electrical engineering?""",Electrical? """And you are in art class?""",And you dey art? "He said, ""you've missed it, that means you won't be able to go for it.""","E say you don miss am, na, na im be sey you no go fit go." "He said I should think of uh... anything... another thing I will be able to do, which will be in line with my current class.","Sey make I tink of eh anyting, anoda ting wey I go fit do, wey go relate to di class wey I dey now." "Then I said it's banking, and finance.","I come say na banking, and finance." He said he didn't like banking and finance.,"E say im no like banking, and finance." It will just tie me to one place.,Sey di tin go just tie me for one place. I won't be able to...,I no go fit... "That I'll only be in the bank, and uh... these people who are into money, money things, mstchew.","Sey na only bank, and eh dese people wey de do money, money tin, na dere I go dey mtschew." So he said...,So he now said... "In fact, it was my father who picked accounting for me.",In fact na my papa choose dis account for me. "Because he felt that with accounting, you can work anywhere.","Because im feel sey account, you fit work for anywhere." "So from there, when I finished in uh... in Toyibat... luckily, when I finished in two thousand and... nineteen ninety four, by nineteen ninety five, early uh... in uh...","So from dere, when I come finish for, eh for Tayyibaat, luckily, when I finish in two thousand and, nineteen ninety four, by nineteen ninety five, early eh in eh..." "When it was (uh... I think) January nineteen ninety five, or ninety... in February, I got into Oko Polytechnic.","When e don reach (eh I tink) January nineteen ninety five, or ninety February, I enter Oko Poly." Oko Polytechnic is a small school in Anambra State.,Oko Poly na small school for Anambra State. "Uh... Federal Polytechnic, Oko... I had my ND [National Diploma] education there.","Eh Federal Polytechnic Oko, na dere I come do my ND." "Then I had my uh... IT [Industrial Training] in a Federal, Federal Ministry.","Den I do my eh IT for one Federal, Federal ministry like dat." "After which I came to Yaba Tech, for my HND.","Den after which I come go Yaba Tech, go do my HND." And I...,And I... It was accounting I studied.,Na di accounting wey a-... I read all through. "Then, later, I went to Imo for my Service.","Den later, I go serve for Imo." But there was a time I had a fire accident.,But e get one time wey I get fire accident. So I still had the injury I got from that fire accident when I reported for service.,So dat fire accident injury still dey my body when I go serve. "So... and because I didn't want to stay there, I wrote a letter to them saying I have uh... medical issues.","So and because I no wan stay for dat side, I come write letter give dem say see o, I get eh medical challenge o." So they should post me back to...,So sey meh dem return me back to... That was how the whole thing worked out fine.,Na so di tin come jell. I was posted back to Lagos.,De come return me back to Lagos. "So I finished my, my uh... service in Lagos.","So I finish my, my eh service for Lagos." "Then, my father was someone who really loved education.","Den my papa na somebody wey be sey e love book well, well." "He loved education, which means that the... he knew he made a mistake by not... by not putting me in the right place from the beginning.","Love book, wey be sey di, e know sey im do mistake for not, for not putting me for right place from beginning o." "But after that, he started monitoring my education.","But after dat time, im come dey follow me for my education." "Said he wanted... he wanted to make sure that this profession I'm in, the highest... the, the level which anyone who is into this course reaches, reaches, you will also get there and he will not let me rest.","Sey im wan, im want make sure sey dis one wey I dey do, di highest, di, di level wey person wey do dis course dey dey, you go reach am, and im no dey leave my neck." So I got uh... a job in Lagos State.,So I come gain eh job for Lagos State. "But when I got to Lagos State, the salary wasn't great.","But when I come reach Lagos State, di salary no good." "And if you want to go for that kind of course, it requires a lot of money.","And if you want do dat kind course, na money." "And my father mstchew, he didn't as have much on him as when he... when we were little.","And my papa mtschew, tings no dey im pocket like, as e dey when im, when we dey small." "So he b-... he was like ""you've started working, right?",So e b-... e feel say shebi you don dey work? """You, you, you are able to... you are able to support yourself to, you know, wherever you want to go.""","You, you, you fit, you fit sponsor yourself go (you know) where you want go." "So he has been on my neck since then because I started this job in two thousand, and one.","So e come dey my neck since because I enter dis job for two thousand, and one." So he was on my neck.,So e come dey my neck. "So every year, he will be telling you haven't taken your ICAN [Institute of Chartered Accountants of Nigeria] exams.","Every year like dat, im go dey tell me sey you never do your ICAN." "That you're, you're just like someone who... you're in a pool with everyone else.","Sey you are, you just be like person wey all of una dey inside water." "If you... if you qualified as a member of ICAN, that means you'd stand out from the others.","If you, if you get your ICAN, na im be sey your own head go comot pass every oda person head." He kept giving me that until one day when one mir-... when there was a miracle in my life.,"Im dey give me dat until one day, one mir-... one day wey miracle come happen for my life." "Because anytime I want to start this exam, I get held back by a lack of money.","Because anytime wey I want start dis exam, na money dey tie me down." I don't have money.,I no dey get money. "I even met with my boss saying, ""boss, please lend me some money so I can start this thing!""","I even go meet my oga say oga, abeg, borrow me some money make I take start dis tin!" He said uh... said uh... he didn't know what I wanted to do with the ICAN thing.,"E say ehn, say ehn im no know wetin me dey go do for di ICAN tin." That people who do ANAN can also make it.,"Sey people wey dey do ANAN, de dey make am." "In fact, at that time, I had even given up saying, ""okay, let me do this ANAN.""","Pa-... infact, dat time, I even don give up say okay make I do di ANAN." Then I was told that I would need to wait another eight months before I could join ANAN.,De come tell me sey I go need to wait for anoda eight month before I go fit join ANAN. "So I figured instead of waiting for eight months, why don't I just start the uh... ICAN?","Naim I come look say ehe for me, to dey wait for eight month, why not kukuma start dis eh ICAN?" "This particular one, I can start right away.","Dis one, I fit start am now." That's what took my mind off ANAN.,Na im make me comot my mind for ANAN. So I waited for two years after that before I could get money.,"So I come stay two years after dat time, before I come even get money." How did it happen?,How di tin come happen? "That day, I just got married.","Dat day, I just marry." "I got married in two thousand, and eight.","I marry two thousand, and eight." "My, my first kid was born in two thousand, and nine","My, my first pikin, for two thousand, and nine." "So I can remember that on a particular Sunday when my ki-... mstchew, when there was no money to eat.",So I could remember dat e get one Sunday like dat wey my pik-... mtschew wey money no dey to even chop dat day. I was just staring blankly.,I come dey look. "Ah God, I said, ""what kind of life is this?""","Ah God, I say which kind life be dis?" "So from that point, I also believed that mstchew... this job I'm doing isn't what I'm meant to be doing.","So from dere, me too believe sey mtschew dis job wey I dey do no be di job wey I suppose to dey do." "That if I just got my ICAN certificate now I could leave this place and go to another company, where I will get paid better.","Sey if to say I don get dis ICAN now, I fit comot here go anoda company wey be sey go dey fetch me better money." "Mstchew, so I was thinking on that particular day.","Mtschew so dat day, I come dey tink." So I got to the office on Monday.,"So for Monday, I come reach office." And I am not bragging.,And no be sey I dey brag. I'm the hardworking type.,I be type wey be sey I dey hardworking. "But on that day, I was restless and mtschew... I couldn't do much.","But dat day, di tin come affect me, wey be sey mtschew I no fit do much." Okay.,Okay. "I was in the office, working.",I just dey office dey do my work. "And then one, one of my...","Naim one, one of my..." "The woman is older than me, but I am her senior...","Di woman senior me, but I senior am..." "She is older than me in age, but my rank at work is higher than hers.","E senior me for age, but I senior am for level." "So she told me uh... Mr Mustapha, will you take part in this uh... this uh... I dont know what... how they call it... these uh... monthly money contributions where someone will collect all the money contributed this month and another will collect...","E come tell me sey eh Mr Mustapha wheda I go do dis, eh dis eh I no know wetin, how dem dey call am, dis eh contribution wey be sey somebody go carry dis month, anoda person go carry?" "I said, ""look, mstchew... I don't have time.""","I say wo, mtschew I no get time." "Me, how much money will I make?","Me, wey be sey how much be my salary?" Eleven thousand naira.,Eleven thousand naira. So now I'll get into this kind of mstchew...,Naim I go come put head for dis kind mtschew... "So on second thought, I reconsidered it and thought okay.","So on a second, I come look say okay." "I figured that uh... even if I don't... if, if it's not my turn the first month, I can beg the person who is to collect the first one.","I come tink am sey ah even if I no, if, if no be my turn for dis first time, I fit beg person wey be first time." He should give me his own portion.,Make e give me im own portion. "When it's my turn, he will collect it.","When e come to my turn, im go carry am." "At least, I should take...","At least, make I take..." Maybe this will help me start the ICAN examination.,Maybe dis one go help me start di ICAN. "So mstchew... I said, ""okay, I will take part in it.""","So mtschew I come say okay, I go do." So they said we will pick numbers.,So de come say na through ballot we go pick. So they put num-... they wrote numbers on a paper.,So de come put num-... de come put number for paper. They rolled them up and put them in a plastic container.,"Roll am, put am for one plastic." They asked us to start picking the numbers.,De say make we dey pick. When it was...,When e don... "When the third person picked, then they all said that... the remaining two people said that if I don't pick...","When di third person don pick, naim all of dem come talk sey, di remaining two come talk sey if I no pick..." "That they... if I don't pick mine, they would not pick theirs.","Sey de, if I no pick, de no go pick." "Mstchew, I just prayed to God saying, ""God, I am in your hands!""","Mtschew I just pray to God sey God, I dey your hand o!" So I picked mine.,I come pick. "So when we all picked the numbers, we started showing the numbers.","So after wey all of us don pick, we come dey show." "Everyone started opening the papers, saying uh... someone picked second.",Everybody come dey open say ah one person pick second. "I said, ""uh... supposing I was the one who picked the second number, I would have loved it.""","I say eh if to say na dat seconds, I for like am o." Another person picked number five.,Anoda person pick five. Then I was asked to accept my fate.,Naim dem say make I gba. "I said, ""oh, why do you want me to open mine now?""",I say oh why be sey you want make I open my own now? "They said, ""why?""",De say why? "As soon as I opened it, number one.","As I just open like dis, number one." That was how I started my ICAN exams that time.,Na so my ICAN start dat time. So I met with my father.,So I come go meet my papa. "I told him ""you were the one who wanted me to start these exams.""",Tell am sey na you want make I start dis tin o. I have thirty thousand and I want to start lectures.,"I don get thirty thousand, and I wan start lecture." I need i-... fifty five or so.,I need i-... fifty five something. "Then he, he wrote me a check that day.","E come, e come write check give me dat day." That's how I just started.,Na so I just start. "And under... wi-... eh... within two years, I made it.","And under, wi-... eh within two years, I don make am." So that's my ICAN story.,So na so my ICAN history be. And I was so brilliant that time.,And I bin so dey kajad dat time sha. Thank God!,Tank God! So...,So... "My people, what I want to tell you about now, now uh... yes, is about the ghetto life.","My people, wetin I wan tell una now, now eh ehen, na ghetto life o." "If you've never lived in the ghetto, wow, mstchew, you are missing out.","You never live for ghetto before, hm mtschew you dey miss." I say ghetto life is legit.,"I say ghetto life, na legit." This is the place to be.,Ah na dere na im be confirm eh. "Because that's where you'll learn other languages, uh... you'll learn slang.","Because na dere wey you go learn language, eh you go learn slangs." I'm telling you.,I dey tell you. "As soon as you come to where they... the street guys are mixing things together uh... mstchew, you will be amazed like you're a spoiled brat.","As you come where de, di niggers dey brew like dis eh, mtschew you go begin open your eye like sey you be ajebo." "And the fact is that the spoilt brats can't mix with the ghet-... uh, the underprivileged.",And one ting be sey ajebo no go fit mix with ghet-... eh kpako. "You know that the rich ones pretend... they act like morons, they act like momma's boys.","You know sey ajebo dey form, de dey form galadima, galadima, dey form mummies pet." The poor people don’t have time for that.,Kpako no get time for dat one o. Those of us who are poor don’t have the time to act like momma's boys.,"We wey be kpako, we no get time to con form mummies pet." Who will give you the chance to act like a momma's boy?,Where we wan form mummies pet for now? Or do you wanna act like one in front of your dad?,Abi you wan form am for your papa? Your dad will bring you back to reality.,Your papa go wake you up now. He'll do it with a big slap.,"By waking you up, na hot slap o." "And another thing is that as you go into a ghetto, you need to be really, really, really, really, really alert so that the street guys don’t make fun of you.","And anoder ting wey dey dere be sey as you go ghetto, you go shine your eye well, well, well, well, well, well make niggers no use you catch fun." "Because when they make fun of you, you'll look an moron, clueless.","Because when de use you catch fun sef, you go be like sey you be galadima o, danjuma." "It's only you and them, you'll just be clueless.",Na una dere now wey you go dey look. "So, ghetto life... the truth about ghetto life is that you will learn a lot.","So, ghetto life, wetin dey for ghetto life true, true be sey ghetto life, you go learn." "If you were brought up in the ghetto, you will learn a lot.","If de bring you up for ghetto, you go learn well." You'll know a lot of things.,"You go sabi tings well, well." You'll be strong.,You go strong. I say you'll understand so many things.,I say you go know tings. "Your buddies won't be able to play on your intelligence, other guys won't get to swindle you.","Your fellow man no go fit chance you, your fellow man no go fit chop you." Because you will be one step ahead of them,"Because as your fellow man don talk one, you, you don talk two." You've already read their mind.,You don know wetin im wan tell you. "As he observes you, you are also observing him.","As im observe you, you observe am." Another thing about the place is the bad lifestyles; all kinds of bad things.,"Anoder ting dere be sey bad life, bad tings dey." You will know the difference between good and evil.,"You go know wetin get bad, wetin dey good." The ghetto life involves of a whole lot of things.,"For ghetto life, tings dey." Everyone is struggling; you will struggle.,"Everybody dey struggle, you go struggle." "If you feel that you don’t have anything to eat, you will eat garri.","If you feel sey you no fit chop, you go chop garri." You will see little boys have already gulped down some garri.,You go see small boy don wack garri. He has drunk garri.,E don drink garri. "As soon as he drinks garri, he gets strength.","As im drink garri, im get strength." He will dare you who who's eaten rice; you who brags that your father gives you rice and chicken.,"Im go face you wey you don chop rice, wey you dey say your papa dey give you rice, and chicken." "As a fool, he'll wake you up.","As a mumu, im wake you up." That’s no child's play.,"Dat one now, no be childs play." "And as I'm saying this uh... white man, you're laughing too.","And as I dey talk am now eh, Oyibo, you, you dey laugh kwa." That’s the proper thing to do.,Na im be di legit ting. "You, you know it too.","You, you know now." Uhuh!,Ehen. "You're just there, watching us.",Carry your hand dey put for your cheek. No problem!,No wahm! It's true!,Na confirm! "So in here, we have the downtown area, it's a ghetto.","So for here, e get down wey dey for here, na ghetto." If you go there right now uh... you will see all those guys who have had homemade gin.,To go dere now ehn you go see all dose men wey don drink kaikai. Do you know what homemade gin is?,You know wetin be kaikai? Yes!,Ehen! A well brewed palmwine.,Palmy wey de cook well. You will take it fresh.,"As de cook am, you go brew am." "But since it rained today, you go and take a look at the men.","But today wey rain fall, go see men now." "Everyone is there, and everyone is drunk.","Everybody don dey dere, and everybody don close eye." "There's something else which, which they will take later on.","E get one ting now wey, wey de go con knack." "Which means that now, as you... now... which is on the way... you're educated people.","Wey be sey now as you now wey dey come now, you be office." They've been watching you from a distance.,"From far now, de don dey hunt you." "Hey, who's there?",Heiss who goes dere? "As they watch you, who goes there? You know, you'll be afraid at first.","As de dey hunt you now (who goes dere now), you now, you go first kporo." "Yes, as privileged people you too, now it's... you the white man, who's already afraid, first you'll uh... first you'll take a look.","Ehen as ajebo wey you be now, na now you wey be Oyibo now, wey kporo, you go first eh, go first look." What are they saying?,What are de saying? What are...?,What are... ? "Shh, where are you?",Shh where you? Position!,Position! Which one is...?,Which one be... ? What are they saying?,What are de saying eh? We're not taking that.,We no dey for dat one. "Since you can't speak in a way they understand, they'll corner you.","As you no fit talk well, go cornerside you one side." "Uh... first of all, what's in your pocket?",Eh wetin dey your pocket first? "Your phone of course, that’s how they'll trick you into taking your phone.","Your phone now, see as de go scope collect your phone." "Ah, my brother, my man, actually, I like this phone of yours.","Ah nna my man, dis your phone sef, I like am." What model is this?,Na which make be dis one now? You'll say it's Infinix.,Go say na Infinix. Let me have a look!,Mey I see am now! "As the person is looking at it, he has seen it as well.","As di person dey see am now, im don look am." Mstchew!,Mtschew! "Saying, ""oh man, this phone is nice!""",Say oh boy dis phone go well o! """Let me make a call on it.""",Mey I use am make call. You'll give it to him so he can make a call with it.,You go give am mey im use make call. "He will say, ""oh, hello, hello, hello!""","Im go say oh hello, hello, hello!" "As he walks away, your phone goes with him!","As im waka, your phone don waka o!" "Yes, that’s it!",Ehen na so! That’s how life is.,Na im be di life be dat. Your phone is gone.,Your phone don waka. "And being a moron, you shout ""hey, where's my phone? Where's my phone? Where's my phone?"" and the next person you'll say ""this person took my phone"" to is a fraud, he'll tell you, ""hurry up and bring some money, so I can go and get it!""","And as you mumu (yeh where my phone, where my phone, where my phone), di next person wey you dey tell sey eiss dis person took my phone, (na lie) im go tell you sey oya bring money, make I go collect am!" Ehe!,Ehe! "Since you don't know any better, you'll want to get your phone, so you'll give him some money.","As eremu wey you be too, you wan collect your phone now, you go give am money." "And as soon as you give him some money, the money...","As you give am money too, di money..." "He will tell you, ""now, let me go and call him!""","Im go tell you sey oya wait, meh I go call am!" He disappears too.,Dat one don go be dat. That's life in the ghetto.,Na im be di ghetto life for you. How did I get into the ghetto life?,How I take enter ghetto life? "Myself, I'm really stubborn.","Me, I stubborn well, well o." Really stubborn.,"Stubborn well, well." "And me, I went to a private school, but...","And me, na private school wen I go but..." "While we were walking through the streets of Lagos, when we're coming back and speaking English...","For dat time now wey we dey waka for di street for Lagos, if we dey come back, we dey speak grammar." "But when you take a look at the Mechanic Village, you'll see guys smoking marijuana.","But when you look mechanic village, you go see men wey dey smoke igbo." "People smoke cigarettes, taking strong drinks.","People dey smoke cigar, dey drink deir shekpe." Everyone's talking.,Everybody talk. We also want to be accepted.,"We too, we wan feel among." "Then, we will be looking at them.",Den we go dey look dem. "Then we, we are pretending.","Den we, we dey form." "When we're pretending, they're calling us spoiled brats.","When we dey form now, de dey call us ajebo." And that pains us.,And dat ting dey pain us. Imagine some kid calling you a spoiled brat out of nowhere.,"Imagine how small boy now wey you go see, im go call you ajebo." "Sometimes when we want to play ball with them, they will tell you ""shh, come on, get out of here!""","Sometimes when we wan play ball with dem, de go tell you sey shh come on, comot here!" We will leave.,We go comot. Mstchew!,Mtschew! So the thing pains me.,So di ting come dey pain me. "I say this lifestyle, I will also have a taste of it.","I say dis life, me, I go experience am." "So from there, when we come back, just as we have come back now, mstchew, I will drop my books.","So from dere, when we come back, as we come back now, mtschew I go drop book." I will go with my... one small boy.,"I go follow my, one small boy." The son of the gateman who works there.,"Di gateman wey dey dere, im son." We will go there.,We go go dere. "When we get there, he would say, ""this is my friend.""","As we go dere, im go say dis one na my friend o." "As soon as he says, ""he's my friend"", they will say, ""what is your name?""","As im say na my friend, dey go say wetin be your name?" I will tell them that my name is Uche.,I go tell dem sey my name na Uche. We will say okay.,We go say okay. "We will be there, talking.","We go dey dere, we go talk." "From there, we will f-... head out and go to the canal to catch fish.","From dere, we go f-... comot, go canal, go catch fish." "As we go to the canal to catch fish... sometimes, we will leave the place and go under the bridge.","As we go go canal, go catch fish, sometimes we go comot dere, we go go under bridge." "When we go under the bridge, we will see...","When we go under bridge, we go see..." "Sometimes, the very first day I tried marijuana there, it was Ben who told that it was marijuana; they call it fish.","Sometimes, di very first day wey I taste igbo, dere na Ben even tell me sey na igbo, na fish de call am." "I was just... my friend told me, ""oh man, do you wanna eat fish?""","I just dey, my friend tell me sey o boy, you wan chop fish?" I said yes!,I say yes! He said...,Im say... "I... first of all, I asked him ""what kind of fish is that?""","I, I first ask am sey which kind fish be dat?" "He said, ""dried fish.""",Im say dry fish. "I said, ""bring it here.""",I say bring am now! I actually love dried fish.,Na dry fish I dey like sef. So they wrapped it up and brought it to me.,Naim de wrap am bring am. "When they brought it over, I looked at it.","As de bring am, I look am." "I said, ""this isn't fish!""",I say dis one no be di fish now! "He said, ""what else do you want? What do you think they call fish?""","E say wetin again now, wetin you tink sey de dey call fish?" """You try it.""",You go taste am. """You have to have it because I've wrapped it already.""",I don wrap am be sey I don wrap am. "And that day, as I tried it uh... my head swelled up.","And dat day, as I taste am eh, my head big." "As I was looking around, the ground... the ground... the ground seemed seven steps higher.","As I dey look, di ground, di ground, di ground be like sey de don carry seven step put." "And then my eyes teared up, my voice also changed.","Na so my eye come tear, my voice come change." Then I was afraid.,Fear con enter my body. "As I was walking, I was staggering... I was walking and I was staggering.","As I dey waka, I dey stagger, I dey waka, I dey stagger." "They said, ""oh man, this guy is gonna pass out.""",De say o boy dis guy go comot o. So they rushed to get me some garri on a plate.,Naim dey rush kukuma carry garri put for eh plate give me. I used my hands.,I carry my hand. I didn't even wait.,I no need to even wait. "I ate it fast, using my hands.",I use hand rush am. I was not satisfied.,Di ting no still weigh me. They went out to get me some coconut water.,De go find coconut water give me. "As soon as they got me the coconut water, I drank it.","As de find coconut water give me, naim I drink am." "Afterwards, I slept.","After I drink am, I go sleep." I didn’t wake up until the following morning.,I no wake up until di following morning. "And so my Aunt asked me, ""eh, where were you yesterday?'",Naim my aunty ask me eh where you go dat yesterday? Mstchew!,Mtschew! I told her that no... that I went to play ball and I was feeling weak.,"I tell am sey no, sey I go play ball, my body come weak." "She said, ""but when you came back, your voice was not...""","Im say but when you come back, your voice was not..." "I said, ""mstchew, auntie, don’t worry!""","I say mtschew aunty, no worry!" I was having a serious headache yesterday.,Dat yesterday ehn headache bin dey worry me. "She said, ""are you sure?""",Im say are you sure? I said yes!,I say yes! "She said, ""but you're alright now?""",Im say but you are okay now? "I said, ""yes, no worries!""","I say yes, no wahm!" "She, she left.","She, she comot." "So myself, I went back there because I wanted to try that stuff again.","Now me now, I come go back because me, I wan taste dat ting again." So I went back.,Naim I con go back. "So when I got back there, I tried it.","As I con go back again, I taste am." It had the same effect on me.,Im do me di same ting. "I said, ""no, I'm not gonna give up on this thing, I will overcome you, you won't be the one to overpower me every time.""","I say no, me, I no go give up dis ting, me, I go win you, no be every time you go dey win me." "From then on, we kept trying it for a long time and we became pros.","From dere, tah we con become professional." I started to get control over it.,I con dey win am. "As I was getting control over it, it was giving me joy in return.","As I dey win am, im dey give me joy." It was giving me joy uh... I was enjoying it.,"Im dey give me joy eh, I dey enjoy am." Mstchew!,Mtschew! "But at a time, we realised that nothing good was coming out of the experience.","But at a time, we con see sey dat ting, nothing come out." "When you take the stuff, you will start misbehaving.","Di stuff, wen you drink am now, you go go dey do misbehave." Doing weird things.,Dey do oder tings. So I stopped taking it.,"From dere, I come stop am." Thank God that it happened that way.,"Tank God, dat one dey." So that brought me into the ghetto.,Na im make I join ghetto life. Yes!,Ehen! Absolutely!,Confirm! "Well, the very first story I have for today is the one I'm talking about.","Toh di very first story wey dey my hand for today, na im dey yarn o." What is it?,Sey wetin? "It's here, it's in the open!","E don land o, e don show o!" "They told you it was on the way, right?",Shebi dem tell you sey e dey come? You thought they were lying again?,You tink sey na lie dem dey lie again? But this one's not a lie.,But dis one no be lie. "Baba has come, Daddy has arrived, Father hurry up... hurray.","Baba have come, Daddy have arrive, Papa tete oyoyo!" "They said President Muhammadu Buhari, Yusuf's father, Sara's father, Alimo's father, Aisha's husband, he has resumed work today.","Dem say President Muhammadu Buhari, Baba Yusuf, Baba Sara, Baba Alimo, Oko Aisha, e don enter work again today o." "That's why the Nigeria Labor Congress, another outspoken group... they have started setting targets for the President on what he's supposed to focus on.","Dat na why Nigeria Labour Congress, anoda group wey get mouth, de don con dey set a target for di Presido o on wetin e suppose focus upon." "They said (apart from the NLC [Nigeria Labor Congress], the organisations and people who are speaking on different interviews in the Punch, including the Northern Elders Council, the Pan Yoruba Sociopolitical Group, Afenifere and Doctor Junaidu Muhammed), they advised the President to focus on the economy.","Dem say apart from di NLC, organisations, and people wey be sey dem dey yarn for different interviews in di Punch including di Northern Elder Council, di Pan Yoruba Sociopolitical Group, Afenifere, and Doctor Junaidu Muhammed, dem dey advice di Presido o make e focus on top di economy." "So all the mishap befalling the people, all the poverty choking them up like a bow tie (which means they cannot travel abroad for medical treatment), they will be able to improve it.","So all di ozigi wey dey shele to di people, all di poverty wey dey kolobi dem like bow tie (wey be sey dem no fit travel abroad for medical treatment), dem go fit improve am." "The President arrived Nigeria on Friday after he spent forty nine days on a long, undisturbed medical vacation in Lagos... in London, sorry.","Di Presido land for Naija on Friday after forty nine days wey e take do medical vacation ologborangandan for Lagos, for London sorry." "They said while he was addressing members of the Federal Executive Council, following his arrival, Buhari was saying that he would rest throughout the week, and he would resume work today.","De say while e dey address members of di Federal Executive Council after e land, Buhari dey yarn o sey e go rest throughout di week, and e go resume work today." The NLC has called on Pa Buhari.,Di NLC don hala on top Baba Buhari o. "He should focus on the challenges which are facing the country, especially our economy which has turned upside down.","Make e focus on top di challenges wey dey face di country, especially our economy wey don turn edede." "The General Secretary of the NLC, Doctor Pisa Osoesan, was the one saying that the Government should tackle the problem of the economy so that they will be able to bring us out of this ridiculous situation which the whites call a recession.","Di General Secretary for di NLC, Doctor Pisa Osoesan, na im e dey yarn o sey di Government, mey dem tackle di problem of di economy so dem go fit comot us for inside dis yeye okwakwa wey Oyibo dey call recession." "He was saying that it is important for the government to implement politics which... a policy which will reduce our suffering, which means the suffering which is t-... which d-... which is suffocating Nigerians.","Im con dey yarn o sey e dey important for di Government make dem do politics wey, policy wey go reduce wetin we dey suffer wey be sey suffer head wey dey t-... wey d-... wey dey kolobi Naija people." "Osoesan was even telling them to quickly, quickly...","Osoesan con even dey call sey make dem sharperly, sharperly..." "They should go and arrange the Tripartite Committee, which is to say the ""Igbimo Elenumeta"" [Three Man Committee].","Mey dem go arrange di Tripartite Committee, dat is to say Igbimo Elenumeta." "Which means they will be the ones to sit down and rearrange the minimum wage, the fifty six thousand they said they wanted to be earning to...","Wey be sey na dem go sit down wey go rearrange di minimal wage, di fifty six thousand wey dem say dem wan dey collect sey to..." Will it ever happen?,Shey e go happen? Are you... are you God?,"Are you, are you God?" How do you know that the fifty six thousand won't be possible?,How you take know sey fifty six thousand no go possible? He was saying that they continued to delay the constitution of the Wage Committee.,Im dey yarn sey de continue delay for di constitution of di Wage Committee. He said they will not compromise again.,E say dem no go gree again o. "And the Labour Congress, what will they do?","Labour nko, dem go do wetin?" They will be angry.,Dem go vex. "And if they're angry, the Federal Government won't like it.","And when dem vex, Federal Government no go like am." "Well, all of us in Lagelu, and all of us in Nigeria, that's why we say, ""kaabo, se daadaa lo de, a ti reti re"". [welcome, did you arrive safely? We have been expecting you.]","Toh all of us for Lagelu, and all of us for Naija, na why we say kaabo, se daadaa lo de, a ti reti re." The President has arrived.,Presido don show o. Tell everybody to beware of how they behave from now on.,Tell everybody sey make dem sabi how dem go dey behave now. Simply because... you said what now?,Simply because sey wetin? "Baba, he has arrived, Daddy, he has come.","Baba, e don come, Daddy, e have come." "This is still Lagelu, ninety six point seven.",Na still Lagelu ninety six point seven na im be dis. Not ninety six point three any longer!,No be ninety six point three again o! "Don't have it be like it's a fake you're enjoying; go on our Facebook page, Lagelu FM, ninety six point seven, go and watch it.","Make e no con be like sey na fake una dey enjoy, make una go on top our Facebook page Lagelu FM ninety six point seven, make una go watch am." "It is live, and direct.","Live, and direct ni." Yes!,Yes o! We are streaming it live.,We dey stream am live. "You say you want to see my face, you want to see what I look like.","You say you wan see my face, you wan see wetin I be like?" Or is it that you don't know me?,Abi you never know me before? "Go on our Facebook page, Lagelu FM, ninety six point seven.","Make una go on top our Facebook page, Lagelu FM ninety six point seven." "Go and watch it live, and direct as I am speaking now, now, now, now, now, now, now, now.","Make una go watch am live, and direct as I dey talk now, now, now, now, now, now, now, now." They are showing me on Facebook.,Dem dey show me for Facebook. "Away from that, they said President Muhammadu Buhari... he has extended it again (the tenure of the Permanent Secretary for the Ministry of Education, Dr Jamaila Suara) for another year.","Away from dat, dem say President Muhammadu Buhari, e don extend am again o (di tenure of di Permanent Secretary for di Ministry of Education, Dr Jamaila Suara) for anoda one year." It's true.,Na so... "The Minister for Education, Mr Adamu Adamu, that was how he announced it.","Di Minister for Education, Mr Adamu Adamu na so e polongo." "This will be the second time that Suara's tenure will be extended, which means what?","Dis one, na im go be di second time o wey den go extend Suara who be sey wetin?" Her tenure was supposed to have expired in February twenty sixteen when Mama turned sixty years old.,Im tenure suppose don expire since February twenty sixteen when Mama turn sixty years old. They said she got a presidential extension.,De say she got a presidential extension o. Mama should not retire before when?,Sey mey Mama never retire up till wetin? February twenty seventeen.,February twenty seventeen. "As that one has ended, they said that even that one, it has caused what?","As dat one don con still finish, de say dat one sef, e don cause wetin?" It has created issues in the Federal Civil Service such that people have started asking themselves what kind of a thing this is.,E don cause howuhowu for inside di Federal Civil Service wey people don dey talk to demsef sey which kind tin be dis? Who is she?,Who kind be di tins? Won't she resign? Won't she go home so she can go and rest?,"She no go resign ni, she no go go house ni, make she go rest now." "They said Mama still got a second extension, according to the Minister.",Dem say mama don still get a second extension according to di minister. "I say, ""a'ah what is happening?""",I say a'ah wetin dey shele? """Aren't we abiding by the laws any longer in this country?""",No be law we dey follow again for dis country? "If you ask me, who will I ask?","If you ask me, na who I go ask?" Will you keep quiet?,Will you keep quiet? This one is still on the way.,"Dis one, na im dey come o." "While the House of Representatives Committee on Basic Education are questioning Suara on how the Mama managed to stay in service despite the fact that she is over sixty, and that was in twenty sixteen, the committee which is chaired by a member of the APC [All Progressives Congress], Mr Zakari Muhammed said that for two weeks, they have been looking for evidence, (eri maa je mi nso) [credible proof of evidence] that it was the President who gave the approval that Mama should remain in office despite the fact that she is above the age that should be in office.","While di House of Representative Committee ontop Basic Education dem dey torchlight Suara on how di Mama take dey for service despite di fact sey she don pass sixty, and dat one na twenty sixteen o, di committee wey dem sit down on top by a member of di APC, Mr Zakari Muhammed, dem say two weeks ago na im dem dey talk sey dem dey find evidence (eri maaje mi nso) sey, na Presido na im sama approval give am say, make Mama still dey for office despite di fact sey, she don over di age wey suppose take dey office." "But in fairness, the Permanent Secretary, they said she refused to meet the Committee.","But sha o, di Permanent Secretary, dem say she no gree go for di Committee." Laila ilahlah.,Sey laila ilahlah. "Now, what is this?",Now which kind tin be dis? Is this confidence?,Shey dis one na confidence? Or is this disrespect?,Abi dis one na disrespect? This is insurbordination.,Afojudi re e. "They say, ""aifinipeni, aifeeyanpeeyan, tii m'ara oko san Bante wo'lu."" [Yoruba proverb which depicts insurbordination or disrespect].",De say aifinipeni aifeeyanpeeyan tii mara oko san bante wolu. The disrespect which makes a bushman enter where?,"Disrespect wey dey make bushman, make e enter wetin?" Enter into town with ordinary boxers.,Make e enter town with ordinary boxers. "While the Committee was waiting for the evidence of the presidential approval, the Minister wrote to the Lawmakers.","While di committee dey wait for di evidence of di presidential approval, di minister write di law makers o." "Let them say that Buhar, he is the one who has given Mama another what?","Make e dey yarn sey Buhari, na im don sama Mama anoda wetin?" Another extension in one year.,Anoda second extension for one year. "The letter which The Punch collected from Abuja on Sunday, which was dated March seven... it has a reference number, which they mentioned.","Di letter wey di Punch collect for Abuja on Sunday wey dem date March seven, e get reference number wey dem write." "The Minister was saying that although they said the President has approved in principle, the formal letter of approval has not been given yet to Mama by the Head of Service of the Federation, Mrs Winifred Oyo Ita.","Di minister dey yarn o sey aldough dem say di Presido don approve in principle, but sha di formal letter of approval, dem never carry am go give di Mama o by di Head of Service of di Federation, Mrs Winifred Oyo Ita." "Ladies and gentlemen, what does that tell us?","Ladies, and gentlemen, wetin dat one dey tell us?" "They say all animals are equal, but some animals are more equal than the others.","Dem say all animals are equal, but sha o some animals are more equal dan oders." "It is true that some people of (something like) sixty, they will not even get close to sixty years old before they chase them away.",Shebi some people by (sometin wetin) sixty years old sef no go reach before dem pursue dem. "Mama has clocked sixty one, she is going to sixty two now.","Mama don go sixty one, e don dey go sixty two now o." They said they should leave her again.,Dem say make dem leave am again. "(This is happening) under this very government, Olorun ma wa saanu wa [God, come have mercy on us].",Under dis government naa ni olorun ma wa saanu wa. What's happening to us?,Na which one we dey? I don't understand.,I no understand o. "But anyway, well, Mama is enjoying it, saying, ""he who is not worthy of a favor calls it forbidden.""","But sha, Mama sha, dey enjoy dey say eni ifa o to si ni pee laraamu." "If you were Mama, or if Mama were your mother, would you complain?","If na you be Mama, abi di Mama na your mama, sey you go complain?" "It is serious, Nigeria!","Naija, nawa o!" Only God will save us.,Na God go save us. Go into town!,Enter town! "When you got there, you'll see a guy carrying a bucket of water.","When you reach, you go sight one guy wey carry bucket of water." Talk to him!,Follow am rub mind! Go into his house.,Una waka go im cabal. Tell him there are thirteen of us.,Tell am sey we be thirteen. "Then ask, ""what's a good place for us to stay?""",Come ask sey where go make sense wey we fit lodge? "He'll show you a room, it's upstairs, it's very neat.","E go show you one room, e dey upstairs, e neat no be small." Prepare it.,Make una arrange am. That's where we'll stay.,Na dere we go crash. God!,God! You are a very good God.,Na better God you be. You are the King of the world.,Na you be di king of di world. "You're the One who makes things happen, and You're the One who makes trees bear fruit.","Na you dey make tings happen, and na still you dey make tree bring fruit." Here is my body.,Na my body be dis. "Take it, divide it.","Take am, make una divide am." Do this in remembrance of me.,Make una dey do dis one take dey remember me. God!,God! You are a good God.,Na better God you be. I really appreciate You.,I tank you no be small. You are the King of the world.,Na you be di king of di world. You are the One who makes trees bear fruit.,Na you dey make tree bring fruit. "Take it, share it.","Take am, make una share am." This is my blood.,Na my blood be dis. I have been waiting for this day to eat this Passover before the Son of Man suffers.,I don dey wait for dis day to follow una chow dis Passover before man pikin suffer. "I tell you that I will not eat until you have known what this food means in the Kingdom of God, and until what God said has come to pass.","I tell una sey I no go chop until una don know wetin dis food mean for di kingdom of God, and until di ting wey God yarn don happen." Did you hear me?,Una hear me so? This is the covenant.,Dis one na di covenant. "It is my body, and my blood, that I pour for you.","Na my body, and my blood na im I pour for una so." "But I tell you, the person who will kill me, who will even betray me, is here with us as we eat on this table.","But I tell una di person wey go kill me, wey go even fall my hand sef dey here with us as we dey chow for dis table so." And God will deal with the person.,And na God go trap di person down. "The greatest among you must be as a small child, and the master must be as the servant.","A big person for una must do like small pikin, and di oga must do like boy, boy." Who is the greatest?,Na who big pass? The one who sits to eat or he who serves?,"Person wey sit down chop, or person wey serve?" "It's the one who sat down, right?",Na person wey sit down abi? "But I am among you as the one who is serving, you have been with me since this trouble started.",But I dey wit una like who dey serve una don dey wit me since dis trouble start. "And as my Father has given me the authority, even so, I will pass it to you.","And as my papa don give me di control, na so I go pass am give una." You will eat and drink at my table in the Kingdom.,"Una go chop, and drink for my table for di kingdom." "And you will also sit on thrones, judging the twelve tribes of Israel.",Still come sit down for di government control di twelve tribes dem wey dey Israel. I greet you.,I greet una. How are you?,How body? Why do doubts arise in your minds?,Why una come dey get double mind? "Take a look, see my hand, and my leg!","Look o, see my hand, and my leg!" "You should see that this is I, myself.",Make una see sey na me be dis. Not a spirit.,No be shere kambia. "Touch me, and you will know!","Touch me, and you go know!" "Spirits don't have flesh, or bones as I have.","Spirits no dey get flesh, or bone as I get so." This is what I was telling you when I was still with you.,Dis na di ting wey I dey tell una when I still dey wit una. "Everything Moses wrote, and the ones which the Prophets wrote both in Psalms, and in the other books, they have come to pass.","Everyting wey Moses write, plus di one wey dem prophet write both for Psalm, and for di oder books dem don dey happen." This is what was written.,Dis na wetin dem write. "The Saviour must, and then rise up from the grave after three days.","Di saviour must suffer, and den wake up from grave after three day." "In my name, tell the people that they should repent and say God has forgiven them, starting from Jerusalem.","Wit my name, tell di people make dem change and say God don forgive dem starting from Jerusalem." "You are witnesses of all these thigs and I bring you the promise of God, the Father.","Una take eye see all dis ting, and I bring di promise wey Baba God promise una!" You must wait in this town until power from above comes upon you.,Una must wait for dis town until power from above come enter una body. "May God bless and keep you, all the power in this world and... belongs to my Father, to enable you teach those who are in the world, and baptise them in the name of the Father, His Son, and the Holy Ghost.","Meh God bless, and keep una all di power wey dey for dis world, and my Papa get am to make una teach di people wey dey di world, and baptise dem wit di name of di Papa, im Pikin, and di Holy Ghost." "I am with you all, everytime, even until till the end of the world.",I dey wit una everytime even till when dis world go end. This one has...,Dis one get... "Okay, quick, you should remember that 'body matters' [Body Talks] is what we bring your way every Wednesday.","Okay quickly, make una still remember sey every Wednesday, body matter, na im we dey always carry troway give una." We've turned over to uh... 'body matters'.,We don comot for di ehn gist of ehn body matter. "Now, that's the topic we want to talk about.","Right now, na di topic we wan troway." "Then at twelve o clock, remember that, by the grace of God, Dr Sam, a gyneacologist, will join us in the studio.","Den once is twelve o'clock, remember by di grace of God, Dr Sam go join us inside studio a gyneacologist." "Also remember that at one pm, Isaac Onoja, a pharmacist, will also join us in the studio.","By one p.m., make una still remember Isaac Onoja, pharmacist Isaac Onoja too go join us inside studio." "Maybe we can talk about anger again, or maybe not.","Maybe we fit talk about anger again, or we fit not still talk about anger." "But we have a lot of things to talk about, concerning you and I.","But we get a lot of things to talk about as far as sey you, and me dey concern." "Because they say knowlegde is power, and it also delivers.","Because de say knowledge na power, and knowledge too na deliverance." It's really very important.,"E dey very, very important." I remember those of you out there who say diseases don’t kill black men.,"I remember sey you wey dey for dere, wey be sey dey talk say disease no dey kill black man." "Or maybe sometimes... (hold on... hold on...), you don't go in for check-ups, start going now.","Or may be sometimes (I dey come, I dey come), you never go check your body, begin dey check your body." Because a lot of our people are dying due to ignorance.,"Because out of ignorance, our people dey perish no be small." But we need to be doing the right thing.,But we need to dey do di right thing. "That's why you'll see people posting things about the body in the newspapers, magazines, televisions, radios, and even flyers on uh... uh... on social media, so that you can learn.","Dat is why both newspaper, magazine, television, radio, even some people wey dey ehn ehm post flyer, and for social media, you go see how everybody dey post body matter issue so dat you go learn." But one thing I myself will beg of you is that not every story on 'body matters' is something you should read.,"But one thing wey be sey me, I go beg una, no be every body matter story you go dey read." "Because nowadays, some people will be... have been claiming to be doctors.","Because right now, some people go come don dey claim doctor." "The certified doctor doesn't even talk about the thing, but he already has something like a write-up.","Di main doctor never even talk about di thing, but im don already do one kind writeup." "Something like, if you mix this and this, it will do your body good.","Ehn if you mix dis, and dis, e go good for your body." "If you take this or you have taken that, or you do this or that... please, please, please see the professionals so that they can tell you what's up.","If you take dis, or you don take dis, or you do like dis, or you do like dat, please, please, and please, meet di professionals so dat de go tell you wetin dey." Yes!,Yes. "Okay, quickly, you should remember that we have limited time on the topic we want to talk about.","Okay quickly, ehm make una still remember sey we still get limited time concerning di topic wey we carry come." We'll manage our time on the 'body matters' topic that is coming up.,"Now di body matter topic wey we carry come, we go just manage our time." "There are so many things that you... you have heard from your friends, or that you... you read... read on the social media.","E get so many things wey be sey you don hear from your friend, or you, you read am for social media." "They tell you that if you take this, it will do your body good.","De tell you sey if you take dis one, e dey good for your body." Tell me most of the things you have heard.,Tell me most of di thing wey you don hear. "At the end of the day, all these stories are fake, fake, fake.","At di end of di day, all dese thing na fake story, fake story, fake story." Now you can add this issue I just told you.,Now you fit add dis issue of di one wey be sey I tell una. One of our callers called us here.,E get one of our callers wey call us for here. These women... the woman picked up her child.,"Dis women, di woman carry im pikin." The two of them were in the hospital... in the ward.,"Two of dem dey hospital, as in inside hospital o." Their children were on admission.,De admit deir pikin. "Now, one of the women in that hospital told the other woman, ""ma'am, oh, it's a shame; what's wrong with your child?""","Now one of di woman wey dey inside dat hospital con tell im fellow woman sey madam, aha eya wetin do your pikin?" The woman tells her that the child was suffering from this and that.,"Dey tell am sey na dis one dey do am, na dis one dey do am." "Now, imagine the other woman telling her, ""ah, if my kid comes down with this, here's what I give him!""","Now imagine di oda woman come tell am sey ah if dis one dey do my pikin, see wetin I dey give am now!" "And then this woman in the hospital went out to buy that drug outside, and she gave it to her child who was already on admission.","Now dis woman wey dey inside hospital, con comot inside hospital, go buy dat medicine outside, come give am to im pikin wey de admit inside hospital." "Then before you know it, the child dies.","Den before you know wetin go happen, dat pikin con die." "When the doctors started probing into what actually happened, they found out what the mother gave her child.","When doctors dem come begin dey try dey find out wetin dey, wetin no dey, de come find out sey dis woman, see wetin e give im pikin." """Ma'am, what happened?""","Madam, wetin happen?" She said such and such woman told her about the drug.,"E say na so, so, so woman na im tell am." I think the woman was even there.,I think di woman even dey dere. She was the one who asked her to go and buy this thing.,Na im tell am sey make e go buy dis thing. Saying it would be good for her child.,Sey e go good for im pikin. Your child is in the hospital.,Your pikin dey inside hospital. On admission.,De admit am. Then you ran out.,Den you run comot. You were the one to go out and buy the child what will be good for them because you think you know everything.,Na you run comot go buy di one wey go good for am because you be gbogbo nise. "So many of you must have heard different stories like ""you take this; take that; it works"", but at the end of the day, your body system got messed up.","So many of una go don hear different type of stories about take dis, take dat, e dey work, but at di end of di day, di ting mess up your system." There are a lot of things I don’t like about a lot of people.,E get many tings wen I no dey like for many people body. But to tell you this kind of thing that...,But to tell you dis kind of tings sey... Except if I want to call the person by name.,Except I wan call di person name. But it's not good for someone to call a person by name.,But e no good make person dey call person name. So I will tell you a story.,So I go tell you one story. "This story, they told me when I was in primary school.","Dis story, de tell me when I dey primary school." And they told me the story in Pidgin.,And na Pidgin de take tell me di story. And I will try to remember everything that happened in the story as the guy said it.,And I go try remember everyting wey happen for di story as di guy take talk am. "But that guy, he knows how to tell stories really well.","But dat guy, e sabi talk story well, well." "That guy, I admired him when we were in primary school at that time.","Dat guy, I dey admire am when we dey primary school dat time." "He said he wanted to tell us a story, and all of us should listen.","Im say e wan tell us one story, make all of us listen." Then he started.,Naim e con start. "He said, ""story, story.""","E con say story, story." "Then we said, ""story.""",We con say story! """Story, story.""","Story, story!" """Story.""",Story. "He said that the name of the story that he wanted to tell was ""The story of Alaska Pepper.""","E say di title of di story wen e wan tell us, na di story of Alaska Pepper." "Aha, so who is this Alaska Pepper?",Aha who be dis Alaska Pepper? Why did he have a name like Alaska Pepper?,Why e get name like Alaska Pepper? """Pepper"" is even in the name.",Pepper even dey di name. "He told us to listen, keep quiet, and let him tell us this story.","E say make we listen, meh we keep quiet, make e tell us dis story." Alaska Pepper was a little boy.,Sey Alaska Pepper na one small boy. Nobody liked Alaska Pepper in the place where they were staying.,Nobody like Alaska Pepper for di area where de dey stay. "In that area, Alaska Pepper was always causing trouble.","For dat area, Alaska Pepper dey always dey cause trouble." "If anything went wrong, you would call Alaska Pepper's name.","Anyting wey de do bad, you go call Alaska Pepper name inside." "If you saw a pot on the ground, a pot that was dirty, a pot that was dented, you knew it was Alaska Pepper's fault.","If you see pot for ground, pot wey e moko, pot wey e don dent, you know sey na Alaska Pepper na im cause am." "If you saw a pot that was broken, you knew it was Alaska Pepper.","If you see pot wey e break, you go know sey na Alaska Pepper cause am." "Anywhere trouble was passing through, that's the kind of place Alaska Pepper was heading.","Anywhere trouble dey waka follow, na dat kind place na im Alaska Pepper dey go." So people did not like him.,So people no con like am. "So Alaska Pepper was always doing, doing things that people didn't like in the community.","So Alaska Pepper dey always do, do tings wey people no dey like for dat community." But Alaska Pepper was one kind of person that people didn't like.,"But Alaska Pepper, na one kind person wey e be sey people no like." But there were things that were... that were going on in Alap-... Alaska Pepper's mind.,"But e get some kind tings wey dey, wey e dey work for inside Alap-... Alaska Pepper mind." "So in that town where they were, there were days which were... they were calling their market days.","So for dat town where de dey, e get di days wey e dey, de dey call deir market days." "Women, everybody in different villages, would bring their different things.","Women, everybody for different, different village, de go carry deir different, different tings." "Cassava, pepper, garri, uh... different things, they would carry them on their heads.","Cassava, pepper, garri, ehn different tings, de go carry am put for head." They would go to this one market.,De go go one market. That market is Agbadu Market.,"Dat market, na Agbadu Market." "Before they would get there, some would cross Ikpoba, Ikpoba River... before they would reach it.","Before de go reach dere, some will cross Ikpoba, Ikpoba River before de go reach dere." Some people were coming from another place which they called Enyan.,Some people dey come from anoda place wey de dey call Enyan. "From different places, they would gather in that market.","For different, different place, go come gada for dat market." "So, there was a period when the market would start in the morning.",So e get one period wey di market go start in di morning. It's in the evening people would leave to go there.,Na evening na im people go take comot dere. Because people went there on foot in those days.,Because people dey use leg dose days dey travel go di place. "They would leave the house early in the morning, and once they reached the place, they would display all the things they had brought.","De go comot early morning for house, and once de don reach dere, den de go con shade all di tings wey de carry come." Then people would stay and start buying.,"Den people con stay, con start to dey buy." "So, it's in that kind of place, that's where Alaska Pepper, (that kind of a place where that market was, A... Agbadu) that's where Alaska Pepper grew up.","So na dat kind place na im Alaska Pepper (dat kind place where dat market dey, Agbadu), na im Alaska Pepper for grow." "Then, they knew that Alaska Pepper was not a good kid.",Na im de know sey Alaska Pepper no be better pikin. That it was bad things and bad people that Alaska Pepper was following.,"Sey na bad, bad tings, and bad, bad boys na im Alaska Pepper dey follow." So something happened then.,So e get one ting wey e con happen. Nobody knew how to... to call... to call the thing.,"Nobody know wetin call, to call, to call di ting." One kind of a monster was just coming out from the bush.,One kind ojuju just dey come out from inside bush. "Because at that time, it was like they wanted to do one big festival in Benin.","Because dat period, e be like sey de wan con do one big festival for Benin." So people were really coming to the market.,So people con dey really dey come market. Children were following their moms and dads to the market.,"Children dey follow deir papa, and deir mama dey come market." "So at that time, the monster would just come out from the bush.","So dis kind period, di ojuju go just come out from bush." "It would see a child, it would take it away.","E go see pikin, e go carry am." "Aha! People were wondering: three people went to the market, only two came back.","Aha people con dey wonder sey three people go market, only two go come back." Another uh... another four people...,"Anoda, ehn anoda, four people..." "Two women would go, maybe one person, no, only she would come back.","Two women go go, maybe one person, no, na im go come back." They took the story to the palace.,De con dey carry di story dey go palace. They took it everywhere.,De carry am go everywhere o. Come and see what's happening!,Con see wetin dey happen o! It's like something is happening to us whenever we go to the market.,E be like sey someting dey happen to us anytime wey we go market. "When we go to the market, someone will not come back.","When we go market, one person no go come back." "Then the, the king said he had heard about the matter, he would do something.","Naim di, di king con say im don hear di matter, im go do someting." So the king told everybody to come.,So di king con call everybody come. "All the elders, then he told them, you see what our people are complaining about. The market is a place where they can't go anymore.","All di elders, con tell dem sey una see wetin our people dey complain sey market no dey let de go again." "Because now it's like... because the thing is happening very often, they are not going to the market, they... like they used to.","Because e con be like sey because di ting con dey happen well, well, de no con dey go market X, like de dey go market before." So some people were staying at home.,So some people con dey go house. "When the market day came, they would look for something else to do with their goods.","When dat market day reach, de go find how de go do deir tings." "Some people, their goods started to rot in the field.","Some people, deir tings con dey rotten for farm." They were not taking them to the market.,De no con dey carry am go market. So the king said he knew what to do.,So naim di king con talk sey e know wetin e go do. "Then he said all his best uh... his best uh... soldiers, should go to the market.","E con say make all im best eh, im best eh soldiers, make de go di market." So soldiers should go to the market.,So soldiers go con go di market. They should be waiting for the animal to come out.,De go con dey wait make di animal come. "So when the animal comes out, when the animal sees that they are soldiers, it won't see all those people, at once, it will go away.","So as di animal go come, when di animal go see sey na soldier, e no see all dose people, e go first dey go." "So when the animal saw that it was all soldiers that were coming, it... the animal caught one.","When animal con see sey na soldier, soldier dey come, animal con, di animal con catch one." When they started shooting at the... ehen... the animal with their bows and arrows (the monster which had come out)...,"When de go shoot di, ehen di animal bow, and arrow, di ojuju wey dey come out..." I have started calling it an animal now.,A don dey call am animal now. I will tell you why I am calling it an animal.,I go tell you why I dey call am animal. Because nobody could describe it.,Because nobody fit describe am. "Because its head, it was like a cow's head; its leg, it had a tail like a monkey's; its hand, it was like that..., it was like that of a human being; its body, it was like... it was as if it was a pig's body.","Because im head, e be like cow head, im leg, e get tail like monkey, im hand, e be like sey na e be like human being hand, im body, e be like, be like sey na pig body." "So, the only way you could describe it is that the animal is a monster.",So di only way wey you fit take describe am na sey di animal na ojuju. "So, the monster was catching people at that time.",So di ojuju dey catch people dat time. "So, when the soldiers the king sent wanted to shoot (who sent him), sent... wanted to shoot the thing with their bows and arrows, they would not go in.","So when di soldiers wey di king send wan shoot, who send am, send wan shoot di ting bow, and arrow, di ting no go enter." They would fall away.,E go fall troway. So nobody could kill it.,So nobody fit kill am. "So once it had caught somebody, the thing would carry them into the bush.","So once e catch one, di ting go carry di person enter bush." So some people went to consult with native doctors.,So some people con go meet native doctor. They prepared a strong traditional medicine that we call jazz.,De con do strong medin wetin we dey call jazz. "So they prepared it, and then put it into their gun.","So de go con do am, con put am for deir gun." "They shot the thing, it would not go in; the bullet would fall to the ground.","De go shoot di ting, di ting no go enter, di bullet go fall for ground." "So, when that kind of thing started happening, people started to run, they started trying all kinds of different methods.","So when dat kind ting con dey happen, people go con dey run, de con dey try different, different method." Some people would use a cutlass.,Some people go use cutlass. "They would sharpen both sides of the cutlass, stab at the thing.","De go sharp di two side of di cutlass, chook di ting." "They would stab at it, the thing would not... it wouldn't go in.","De go chook am put, di ting no go, e no go enter." They said what kind of thing is this?,De say which kind ting be dis? "So then the king called everybody back, and said, ""see... that time, he had sent only his soldiers, but now, anybody... if you are a hunter, whatever you are, you should try.""","So naim di king con call everybody back, con say see o, dat time, im be send only im soldier, sey now, anybody, if you be hunter, anyting wey you be, meh you try!" If you can kill... if you can kill this... kill this animal... see the... see the big thing he will do for you.,"If you fit kill, if you fit kill dis, kill dis animal, sey see di, see di big ting wey e go do for you." "So he told them that a very big piece of land, plus one of his... his children, a... his daughter, that's what he would give them.","So e con tell de sey one kind big land, plus one of im, im pikin, im daughter, na im go carry give di person." "So then they said, ""okay.""",So naim de con say okay. "So then lots of different people, they formed different groups.","So naim different, different people, de con form different group." "Some were hunters, some soldiers, some uh... some, area boys.","Some hunter group, some soldier group, some, eh some area boys group." All of them got together.,All of dem con form. Even Alaska Pepper also had the ambition of killing this uh... monster which nobody could kill.,"Even Alaska Pepper too, con get ambition say im too go fit kill dis eh, dis ojuju wey nobody don fit kill." "So, since the thing was only coming out on market days, everybody was ready.","So because di ting dey only come out for market day, so everybody con ready." They went looking for this animal.,De con go look for dis animal. They were looking for it.,De con look for am. "Some went to the bush, some to the road, some to the back of the market.","Some con pass bush, some con pass road, some pass back of market." They were looking for the animal.,De con dey look for di animal. "When the time came for the animal to come out, it came out.","When time con reach when di animal dey come out, e con come out." "Everybody was trying different things, trying and trying different things.","Everybody con dey try different tings, try, try different tings." It didn't work.,E no work. The animal still took the one it wanted to carry into the bush.,Di animal con still carry di one wey e wan carry enter bush. "So every day, people were staying outside.",So everyday people con dey stay outside. "Different groups (soldiers, hunters), were everywhere, waiting for this animal, doing their best.","Different group (soldier, hunter dem), con dey everywhere dey wait for dis animal, dey try." "Ak-... as I said before, some prepared some traditional medicine.","Ak-... as I talk before, some do medin." "Some had tied a red cloth around their head, some had tied a red uh... this thing on their...","Some don tie red cloth for head, some don tie red eh dis ting for deir..." Some had dipped uh... this thing of theirs in poison.,Some don dip eh deir dis ting for poison. Some lit a big fire and put them in.,Some con make big fire come put. They said maybe the thing's skin is really dry.,"De say maybe di ting skin, e too dry." Then they made... they sharpened their arrows very well.,"De con make, con sharp deir arrow well, well." "They put them in the fire, and left them there so they would be hot, so that anytime the animal came out, they would use their red hot arrows to shoot it with.","De con dey put am for fire, de con leave am dere make e dey hot so dat anytime wey di animal come out, de go con use dat deir hot, hot arrow take shoot am." So they tried different methods.,So de try different method. "So early one morning, Alaska Pepper came to do something in the house.",So e get one early morning wey Alaska Pepper con do someting for house. They were... they were looking for him.,"De con, de con dey look for am." Then he ran away from the house.,Im con run comot for house. "So as he got going, he put some stones in his pocket, and the slingshot he had, he put it in his pocket.","So as im con dey go, im con carry some stone put for pocket, and di catapult wey e get, im con put am for pocket." So he was going.,So im con dey go. "As he got to this place, (which was... because anytime they were looking for him after he did something bad, he would run there and played near the river), so, it was... as he was running to that place to go and play, he ran into the animal on the road.","As im con reach one place (wey be sey because anytime wey de dey look for am when e don do someting bad, e go run go dere go dey play for near river), so na as im con dey run dey go dat place sey make im go play na im con jam di animal for road." "As he ran into it, he looked at it, the animal looked at him.","As e jam am, e con look am, di animal look am." He wanted to start running away.,Im want begin run. "He said, aha, if he ran back to that side, the trouble he had started, they would punish him for that.","E say aha if e run go dat side, di trouble wey e don cause, de go punish am put for dat one." "That was how he looked at this animal, then he remembered that some stones and a slingshot were in his pocket.","Naim con look dis animal, con remember sey stone, and catapult dey im pocket." "He took the first one, he shot it.","E con carry di first one, e con shoot am." "It hit his chin, it fell on the ground.","Di ting meet his chin, e fall for ground." So the thing came nearer.,So di ting con dress nearer. "Then he grabbed another stone, shot it, it hit the thing in the eye.","Im con pick anoda stone, con shoot di ting, di ting con meet di ting for eye." The thing shook.,Di ting con shake. Aha!,Aha! "So Alaska Pepper put his hand into his pocket, and pulled out the third stone.","So na Alaska Pepper con chook im hand for pocket, con bring di third stone." He shot it in the mouth.,E con shoot am for near mouth. It swallowed it.,Di ting swallow di ting. Alaska Pepper was happy.,Alaska Pepper con dey happy. "Then he put his hand into his pocket again, and pulled out another one.","E con chook hand for pocket again, e con bring anoda one." "He shot it, and then the animal started shaking.","E shoot di ting, di animal con dey shake." "He put his hand in his pocket again, pulled out a stone (the fifth one) and shot it.","E put hand for pocket again, bring stone (di number five one), shoot am." "The animal started walking, it walked like it was drunk, it was staggering.","Di animal con waka, waka like sey e don drink, con dey stagger." The animal even had a swagger.,Di animal con even get swagger. "While it was coming to get Alaska Pepper, Alaska Pepper pulled out stone number six.","So as e dey waka dey go catch Alaska Pepper, so na Alaska Pepper bring di stone number six." He shot at the animal.,Con shoot di animal. "Then the animal stood still, it looked at Alaska Pepper.","Di animal con stand for one place, e con look Alaska Pepper." "As it tried to catch him, Alaska Pepper just shot the last stone at it.","As e say make e catch am, na Alaska Pepper shoot am di last stone." The last stone.,Di last stone. Stone number seven.,Stone di number seven. "As he shot the last stone at the animal, the animal looked at Alaska Pepper, and it just fell.","As e shoot di animal di last stone, naim di animal look Alaska Pepper, just con fall." That was how the animal died.,Na so di animal con take die. "So Alaska Pepper said what is he going to do now, a... now that he'd killed this animal?","So Alaska Pepper, con say wetin e go do now, now wey e don kill dis animal?" He got scared.,Fear con dey catch am. Then he took out a small knife.,E con carry one small knife. "There was a small knife that we used to make back in those days, that kind of knife.","E get small, small knife wey we dey do dose days dat kind knife." "Before using uh... one kind of thing, we would sharpen it on the ground.","When we go use eh one kind ting, we go con sharp am for ground." "Uhuh, that kind of knife.",Ehen dat kind knife. He then managed... he used it to cut off the animal's tail.,"Con manage, con take cut di animal tail." He put it somewhere.,E con put am somewhere. Then he cut off the... one of the legs and took it.,"E con cut di, one of di leg, e con carry am." "He cut off one of its ears, and he took all of them.","Con cut one of im ear, e con carry all of dem." "He then carried it to that place where he used to play, and he left it there; he forgot about it.","E con go carry am go dat place where e dey play, con leave am for dere, con forget." "Then he played, played, played, played and played.","E con play, play, play, play, play." "When it was time, it was evening time when he realized that dinner would be ready at home, then he ran.","When time con reach, evening con reach wey e know sey food don ready for house, naim e con run." He ran to the house.,E con run go house. "So he was on the road when he heard mom's voice saying, ""where has this child gone to?""",So e dey road when e hear mama voice say where dis pikin go? So he ran.,So naim e con run. "By that time, they had...","By dat time, de don..." People had forgotten... had forgotten what was happening.,"People don forget, con forget wetin dey happen." "So that was how Alaska Pepper went, he had forgotten what he had done.","So na Alaska Pepper con go, e don forget wetin e do." He had gone to sleep.,Don go sleep. "The next day, as people were going to the river, they saw the animal on the ground.","Di next day, as people con dey go river, naim de con see dis animal for ground." Aha!,Aha! Then some people ran to tell the king.,Naim some people con run con go tell king. """Come and see!""",Sey con see o! "This animal that'd been haunting us for so long, this animal which was spoiling our market, which was stealing our people, the animal had died.","Dis animal wey don dey shake us since, dis animal wey dey scatter our market, wey dey tief our people, di animal don die." So they looked there... went to look at it.,"Naim de con look dere, con go look am." They saw that the animal truly had died.,"De con see am say true, true, di animal don die." "So they said, ""aha, who killed this animal?""",Naim de say aha who kill dis animal? "Then they looked at it, one leg was missing.","De con look am, one leg dey miss." "They looked at it, and they saw that one tail was missing.","Con look am, con see sey one tail dey miss." "They looked at it, and they saw that one ear was missing.","Con look am, con see sey one ear dey miss." Aha!,Aha! So they told the king.,Naim de con tell di king. "So the king said, ""who could do this kind of thing?""",Di king con say ehen which person fit do dis kind ting? "Then the king said, ""okay, the person who killed this animal should come and show himself.""","Naim di king con say okay sey make di person wey kill dis animal, make e come show imsef." """He should come and tell the king that he's the one who killed it.""",Meh e con tell di king sey na im kill am. """If you come, you should bring all those different parts of the animal which you... which you killed, which you cut off.""","Sey if you dey come, meh you bring all dose different, different parts of di animal wey you, wey you kill, wey you cut comot." """Those things are what'll show it’s you who killed it.""",Sey na dose tings na im go show sey na you kill am. So some people went to the market.,Naim some people con go market. Some bought a cow and cut off the leg.,"Some con buy cow, con cut di leg." Some bought a goat.,Some con buy goat. "They came, they brought it to where they put the animal in the palace.","De go come, de go come where de carry di animal put for palace." "They came, they measured it, they said, ""no, this isn't the one.""","De go come, de go con measure am, de go say no dis one no be am!" "They brought another one, they said, ""this isn't the one.""","De go carry dis one, de go say dis one no be am." That was how they did it.,Na so de con do am o. Everyone went there.,Everybody con go. They didn't find the person who killed the animal.,De no con see di person wey kill dat animal. "So when Alaska Pepper woke up, he went to play, and he saw people gathered in the palace, standing outside, they were doing something, he saw that some people were bringing cow legs.","So when Alaska Pepper con wake up, con dey play, con see people gader for palace, dey stay for outside, de dey do someting, e dey see sey some people carry cow leg." "So he asked another boy, ""what are they doing over there?""",So e con ask one oda boy sey wetin de dey do for dat place? "So the boy said, ""haven't you heard?""",Naim di boy say you never hear? """That monster that was taking our people away, they've killed it.""","Dat ojuju wey e dey carry our people, de don kill am." Some people were bringing different things.,Sey some people dey carry different tings. "Then they measured them, they still could not find the real person who had killed the animal.","De con measure am, de never still see di real person wey kill di animal." "That was when Alaska Pepper remembered that all those different things he had cut off from the animal, he had kept them in the bush.","Na dat time na im Alaska Pepper con remember sey all dose different tings wey e comot from di animal, im keep am inside bush." So he didn't say anything.,So e no con talk anyting. "Then he ran home, he went to take a bag, he ran to the place and he packed everything.","E con run go house, con go carry bag, con run go di place, con pack everyting." "So, when everybody left the palace, he was the only one left there.","So when everybody con comot for palace, only im con dey." "He didn't know a chief was there, guarding the place.",E no know sey one chief dey inside dat place dey guard di place. He was just in a corner.,E just dey one corner. "So, Alaska Pepper went there.",So Alaska Pepper con go dere. He brought the thing there.,E con carry di ting come out. "As he threw it to the ground, he put it there.","As e troway am for ground, e con dey put am." "He put down the ear, he put down the tail.","E con put di ear, e con put di tail." Then the man jumped out.,Naim di man just jump come outside. Ala-... Alaska Pepper was shocked.,Ala-... Alaska Pepper just shock. He wanted to run away.,E be wan run. "Then the man said come, come, come, come, come, come.","Naim di man say come, come, come, come, come, come." "He then took him to gi-... meet the king, and he said, ""look at him, look at the boy who killed the animal, look at the different parts he cut off the animal!""","E con carry am go gi-... meet di king, con say see am, see di boy wey kill di animal, see di different parts wey e cut from di animal!" Then he king said everybody should come.,Naim di king con say make everybody come o! "Look at the person who did this, this big thing for this village.","Sey see di person wey e do dis, dis big ting for dis village." "It was this sm-... this boy, who killed this animal.",Na dis sm-... dis boy na im kill dis animal. "Now everybody, all the young people who were in the community, a... who were in that village, all of them rushed out.","Na everybody, all di young people wey de dey di community, wey de dey dat village, all of dem con rush come out." "They carried Alaska Pepper up, they were hailing Alaska Pepper, they danced round the village.","De con carry Alaska Pepper up, de con dey hail Alaska Pepper, de con dey dance round di village." "That was how, that story of that boy became uh... a story they are still telling today in that vilage, of how Alaska Pepper saved them.","Na so dat story of dat boy con take become eh story wey de dey talk till today for dat village, how Alaska Pepper take save dem." This is the little story I said I should tell you.,Na dis small story na im I say make I tell you. "You should know that the kind of people you say are no good today, tomorrow, they could become the kind of person who, they would... who will be doing a lot of good things tomorrow.","Make you take know sey di kind people wey you talk sey mtschew dis person no good, today, tomorrow, e fit become di kind person wey e go, wey good, good ting go dey follow." So if you don’t mind uh... that's where I would take my story... that's where I would end my story.,"So if you no mind eh, na dere I go carry my story, na dere I go knock my story reach." "Alright, good afternoon!","Alright una, good afternoon!" "My name is Jemaimah Efangha of Wazobia Max TV, UHF fifty seven.","My name na Jemaimah Efangha inside Wazobia Max TV, UHF fifty seven." "Today is the wonderful day number seven in the month of June, twenty seventeen.",Today na im be di ogbonge day number seven inside di month of June twenty seventeen. It's time for our quick stories.,"Time na time for sharp, sharp tory." "Alright, the House of Representatives has publicly advised the Federal Government to try to conduct some investigations into the prices of cement in our country, as it is becoming too high.",Alright di House of Representative don come outside advise Federal Government say make dem try to chook dem eye inside dis kind price of cement inside we country as e don begin to dey get one kind croocroo leg like dat. This decision followed a motion put forward by the Honorable Abubakar Yunusa as he exclaimed that the rising price of different brands of cement in our country without considering the negative implications it will have on the building industry does not look good.,"Dis decision follow one motion wey de move by Honourable Abubakar Yunusa as e come outside shout sey dis rising price of different kinds of cement inside we country without considerate of di negative implicate inside di building industry, e get as e be o." "He came out to express concern, saying that there's nothing they are supposed to...",Im come outside dey express concern as e talk sey nothing wey dey suppose to... They should try to address the situation because of the common man who does not have much money.,Make dem try to address di situation because of di common man wey no get too much money. "As he came outside, he said that if they do not investigate this issue thoroughly, it will be very difficult for a common Nigerian to build his own house in the country.","As e come outside e say if dem no shook dem better eye inside dis case so, e go make am very, very difficult for even di small Nigerian man to take get im own house for di country." "So he came out to advise the Federal Ministry of Industry, Trade and Investment to join hands with the Cement Manufacturers Association of Nigeria and other similar organizations.",E con come outside advise Federal Ministry of Industry Trade and Investment make dem come outside connect wit di Cement Manufacturers Association of Nigeria and oder kain join body dem. They should all invesigate this matter thoroughly.,Make dem fit chook dem better eye inside dis matter. "Alright, troops from the joint task force known as Operation Delta Safe have killed at least two kidnappers in an exchange of fire, at the place where they kidnapped a victim in Rivers State.","Alright troops from inside di joint task force wey de say na Operation Delta save, dem don kill at least two kidnappers inside where dem take exchange guns (begin shoot me, I shoot you) inside where de bin kidnap one victim for Rivers State." "As they were telling people the story in O.D.S. headquaters today in Yenagua, Bayelsa State, the Commander of the group, Rear Admiral Sulaiman Apochi, said these soldiers would have killed the kidnappers during an operation in Omoku Forest.","As dem dey yarn give tory people today inside di O.D.S. headquarters for Yenagoa Bayelsa State, di commander of di group, Rear Admiral Sulaiman Apochi, na im talk sey dis soldiers bin kill di kidnappers during one operation for Omoku Forest." "Apochi publicly said the people they have already rescued have started receiving appropriate treatment in an undisclosed hospital in Port Harcourt, Rivers State.","Opochi come outside say dis people wey de don rescue so, de don dey receive one kain better treatment inside one hospital wey de no yarn di name of di hospital for Port-Harcourt Rivers State." "Meanwhile, three of the people who have come out... been exposed as having had a hand in the bomb attack on one of uh... the buildings belonging to the international oil community which is in Tedida Oginmbiri [Ogboinbiri-Tebidaba] Brass pipeline.","Meanwhile, three of di people wey de don come outside bring out sey dis one dem get connect inside di bombing of one eh house wey belong to di international oil community for inside di Tedida Oginmbiri Brass pipeline." "But meanwhile, these three people who were brought out have started confessing that they used dynamite to destroy the house of... a place outside the community in the Southern Ijaw Local Government Area of Bayelsa State.","But meanwhile, dis three people wey dem carry come outside so, dem bin yarn sey na dem use dynamite take destroy di house of one place wey dey for di outside community for Southern Ijaw Local Government Area inside Bayelsa State." "Alright, let's take you into the African stories.",Alright meh we carry you jump enter for inside African tory. "The Mozambique government has banned the importation of birds and anything related to birds (saying they've had enough... they've had enough) from the neighboring countries except the ones they said they did not know, but this has to do with Zimbabwe.","Di Mozambique government don stop di importation of fowl, anything wey concern fowl (now e say e don do, e say e don do) from all di neighbouring countries except di one wey dem talk sey e no sabi, but dis one e concern Zimbambwe." "According to the report in Maputo, this announcement follows an outbreak of Avian Flu as announed last week","According to di report inside Maputo, dis talk follow one outbreak of Avian Flu as dem bin announce am inside last week." "In a commercial poultry farm in Zimbabwe's Mashonaland East Area, it was reported that this led to the slaughter...",For one commercial poultry farm inside Zimbabwe Mashonaland East Area dem say dis one lead to di slaughter. So many birds were slaughtered.,"De take am kill many, many, many fowl." And the number of birds slaughtered in the area was seven hundred and fifteen.,And di number na seven hundred and fifteen of dis fowl naim de just kill inside dis area. "Meanwhile, so many different reports have been coming out about this Avian Flu and it was reported that... one of the reports said it was discovered in Mashonaland um... uh... East Area, where it has been said that the report has become the most devastating.","Meanwhile, different, different kain talk don begin to dey come out on top of dis avian flu as dem talk sey one of dem say de don discover am inside dis Mashonaland em eh East Area wey de don talk sey, di report so, na im don become di most baddest of di baddest inside dis one wey don happen." "Zimbabwe's neighbour, Botswana, has made an announcement concerning their own area.","Zimbabwe'S neighbour, di Botswana, de don come outside on top of dem own area." "The report concerns a similar thing, which happened to them just yesterday.","Di report sake of dis kain similar thing, we happen give dem just yesterday." "And in world affairs, very quickly, two attacks were reported in the Iranian Parliament.","And for inside world matter, very, very shaperly, dem talk sey two attack now for inside Iranian Parliament." "And even the Ayatollah... uh... X... eh... X said that concerning this one, it was inside the Capital Tehran that at least twelve people have been killed and many people were injured in that area.","And even di Ayatollah, ehn X, ehn X dem talk sey dis one, na for inside di Capital Teheran e don kill at least twelve people, and even injure many, many of dem for dat area." The ISIS attack reportedly happened in the parliament building.,"Di ISIS attack, dem talk sey na for inside parliament building o." "As it appears that over this one... when it happened... earlier reports of this type of hostage situation which happens in that area... (one suicide bomber, according to the report), was said to have died in this incident.","As e appear sey over dis one, as e happen finish, before, before, earlier report of di kind hostage situation wey dey happen for dat area (one suicide bomber according to di report), dem talk sey dis one die for dis one wey happen." "But meanwhile, Iranian officials said they have stopped the third possible attack that was supposed to take place.","But meanwhile, Iranian officers talk sey de bin don stop di possible third attack wey suppose happen." The Islamic State Group has claimed that they carried out the attack,Islamic State Group don come outside dey claim sey de don carry out di attack o. But they said this would be the first one in Iran.,"But dem talk sey dis one, na im go be di first one inside obodo Iran." "Alright, in entertainment news, country star, Senyatuwe, will play live in the UK.","Alright for inside entertainment gist, country star Senyatuwe, na im go play now live inside UK." "For the first time in thirteen years, on BBC Radio Two's Festival in a Day in the Hyde Park, the singer was saying that the songs he had sung included ""You are still the one"" and even ""That don't impress me much.""","For di first time inside thirteen years, on top of BBC Radio two festival in a day inside Hyde Park, di singer dey talk sey di song wey e don play, na im include you are still di one, and even don't impress me much." And he says he will become the special guest of honor in the event which will come up on the tenth day of September.,And dis one de say na im go become di special guest of honour inside event wey go sele on di day of number ten inside di month of September. "Alright, very quickly in the last story on sports matters, Bafana Bafana's Head Coach, S. Will Baxter, has come out to say that he will put in more effort.","Alright very quickly inside di last tory for sports matter, Bafana Bafana head coach, S. Will Baxter e don come outside dey turn up say e don begin to dey add now more petrol, and more firewood inside di fire o." "Of all the things which will come up ahead of their all international African Cup of Nations' qualifier's clash against our nation Nigeria, the former Kaiser Chiefs and Supersports United Coach, said South Africa's preparation can be likened to a puma getting ready to go deliver a baby in the delivery room.","Of all dis one wey wan happen ahead of deir all international African Cup of Nations qualifier clash against we Nigeria, di before, before Kaiser Chiefs, and SuperSport United coach, e yarn sey South Africa, de don dey ready now like puma wey wan just carry imself say e wan enter labour ward go born pikin." He said their trip to Nigeria is not goint to be a waste.,"Sey dis deir travel to Nigeria so, no be to just come to come make up numbers o." It's a lie... it's a lie!,"Na lie, na lie!" Why?,Because wetin? "Bafana Bafana is truly ready to play against the Super Eagles on Saturday, June tenth, in the Godswill Akpabio's International Stadium in Uyo.","Bafana Bafana, de are very, very set now to face di Super Eagles on top of Saturday June ten for di Godswill Akpabio International Stadium for Uyo." "Okay now, my name is Jemaimah Efangha.","Okay now, my name na Jemaimah Efangha." "For all of you watching us live in here, do have a beautiful day!","For all of una wey dey look una eyes dey see us for here, make una still get better, better day!" Good afternoon!,Una good afternoon! "You see, when I wanted to start this thing, well, a friend talked me into it.","You see by di time wey I wan start dis ting, toh na my friend talk to me o." He said I should buy this thing.,E say mey I buy dis ting. This thing is good.,Dis ting dey good. "Well, at the time he asked me to buy it, I didn't have any money.","Toh di time wey e con tell me sey mey I buy am, I no get money." Then he caught one and he said he should give it to me.,"E con catch one, e say mey e give me." I said... he said w-... I should go and put it in my house.,"I say, e say mey w-... mey I go put am for my house." I did what he said.,I go put am. God provided money and I bought a male.,"God don con give me money, I go buy man." Then I put it in.,I con put. They started giving me eggs.,Don con dey do egg for me. Like...,Like... "They gave me eggs, like eight eggs.",Dem do egg for me like eight egg. "They gave me more, like three.",Dem con do anoder one like three. It remains...,E remain... It laid ten eggs.,E do ten. "This one, that's the one.",Dis one be dat. "Again, I was... little by little.","Again, I dey small, small." I'm fine.,I dey o. "A dog that was in this house, it ate two of my turkeys.","One dog wey dey dis house, e con chop my two turkey." "I was sleeping, then I started hearing them fight violently.","I dey sleep, I con dey hear deir violence." I came outside.,I con come out. "I saw the dog, it ran that way.",I see di dog run go like dis. I went after it but I did not catch it.,"I follow am, I no catch am." "The one it actually came to eat, I bought them for four thousand each.","Di one wey kukuma e come chop, each one, I buy am four thousand." "The male... the male, I bought it for seven thousand.","Di man, di man I buy am seven thousand." "Well, it ate it.",Toh e con chop am. "The one that eventually died, she gave me four eggs.","Di one kuma wey she con die, she do four egg for me." Then I added the eggs to that one.,I con join di egg wit dat one. Well.,Toh. "If they want to hatch the eggs, they will sit on the eggs for around thirty five days.","If de wan born di egg, dem go do like thirty five days on top di egg." Well.,Toh. "Now, they are done brooding.",Now kukuma de don do. "This one here, she hatched her eggs.","Dis one ma, she born." She hatched ten of her eggs.,She born ten. "Well, I don't have money, so I s-... sold them for five hundred naira each.","Toh I no get money, I con s-... sell dem five, five hundred." I sold nine.,I sell nine. Well.,Toh. "Eventually now, yesterday, I came back in the night and I saw this one.","Now kuma yesterday, I come back in di night, I see dis one." They have moved... given me chicks.,"Dem con move, born for me." So I caged them up and I went out to buy them food.,Naim I pack dem go buy food for dem. Then I fed them.,Con put am. Uh... the food uh... this is the food.,"Ehn di food ehn, na di food be dis." The food.,Di abinci. "Food, right?",Food ba? Right!,Yauwa! That's the food.,Na di food be dat. "Now, by the time I got back, I had just two hundred [naira] with me.","Now kuma di time wey I come back, na two hundred dey my hand." I went for one hundred naira's worth.,I go buy hundred naira own. "I gave the, the big one, I served it to them.","I give di, di big one put am for dem." "And then, I went out to buy a Fitila lantern.","Now kuma, I go buy fitila, lantern." And I put it there.,Come put am for dere. " Shi, ke nan .",Shi ke nan. Eh.,Eh. "They eat rice, Indomie, like rice pudding, yams, bread.","Dem dey eat rice, indomie, like tuwo, yam, bread." "Now, if I get... if I buy two... three fifty naira's worth of loaves of bread, they'll eat it.","Now, if I get, if I buy bread two, three fifty ma, de go chop am." "Quickly, now, now, now.","Just now, now, now." That's if it's in the daytime.,If na day be dat. "Right now, I have bread, which I have come to give, give them.","Now ma, I get bread wey I con give, give dem." "Or should I take the bread, right.",Or mey I carry di bread ma. "Should I bring it, so you see it, well.","Mey I bring am, mey you see toh." "They are over there, living off me.",De dey dere dey chop money like. "If I have money, they will eat meals worth five hundred, courtesy of me.","If I get money, de go chop like five hundred for my hand." No problem.,No wahala. "If sometimes I don't have money, they will... they will be calm.","If kuma, if I no get money, dem ma, de go cool down." "Well, did you see?",Toh you see? Yes.,Yes. They're a kind of security.,Dem be security. "Now, if you come in... if you come in the house, it will be making sounds like kwulukwulukwuluu.","Now if you enter, if you enter di house, e go dey do kwulukwulukwuluu." Kwulukwulukwuluu.,Kwulukwulukwuluu. Kwulukwulukwuluu.,Kwulukwulukwuluu. Why won't I report it?,Kwulukwulu. "Well, did you see?",Toh you see? Now if I...,Now if I... "Even if I am not around, if you come in, it will be doing this.","Even dai if I no dey, if you enter, e go dey do dis." "Even the people outside, they will come in.","Even dai people dey outside, de go con enter." "Look, what is wrong with the, th-... this thing?","Look, wetin dey worry di d-... dis ting?" Correct!,Yauwa! Did you see?,You see? "If they see a snake, they will kill it.","If dem see snake, de go kill am." "If they see a snake, they will kill it.","If dem see snake, de will kill am." "Even though rats, they come out, they will go after it, and kill it.","Even dough rat, if e comot, de go follow am, kill am." "Now if they are sleeping, look at the place where they kill it, that veranda.","Now if dem dey sleep, see di place wey dem dey kill am dat baranda place." Correct!,Yauwa. Rain does not bother them at all.,Rain no dey do dem anyting. "As long as this thing on their heads has been finished, the rain doesn't disturb them in any way.","If de don finish dis ting wey dey deir head, rain no dey do dem anyting." "Now myself, I don't have a cage at the moment.","Now me, I no get cage now." It's outside they sleep.,Na for outside dem dey sleep. "Now this one, it's inside the room I will keep it.","Na dis one, na for inside room I go con keep am." Correct!,Yauwa! Ah gaskiya dai! ,Ah gaskiya dai! "Ah, the meat is delicious!",Ah di meat sweet o! "Honestly, the meat is delicious.",Gaskiya di meat sweet. "Now you see this one, if I want to sell it, I'll get around seven thousand, or eigth thousand.","Now you see dis one, if I want go sell am now, I go get like seven thousand, or eight thousand." "If it's during the Christmas season, well, I can get around ten thousand.","If na Christmas time, toh I go fit get like ten thousand." But uh... the female... it won't be more than four thousand... three thousand five hundred.,"But eh di woman, e no go pass four thousand, three five." "Well, but it's the male...",Toh but na di man... The male is very big.,Di man too big now. "Correct, they don't like the female.",Yauwa de no like di woman. They like the male very much.,Dem like di man well. "If they want to eat over there, the, the male has so much meat.","If de want chop over dere, di, di man get meat sosei." "This one, no meat.","Dis one, no meat." "Now, I have six.",Now na six I get. Six uh... with that one.,Six eh with dat one. The dog has eaten one.,Dog don chop one now. The dog has eaten one.,Dog don chop one. Why won't I report it?,Why I no go go tell? I won't tell them so they might pay me.,I no go tell dem mey dem pay me. I just forgot about it.,I just forget am. Life for me as a child was a bit hard.,Life for me as small pikin dey hard small o. "In fact, I really suffered.","In fact, I suffer no be small." And the reason is that my mother died early.,And di thing wey cause am be sey my mama quick die. I am the last child in my family.,Na me be di last born for my family. "So, I have three older siblings.",So I get three elder ones. "So, since my mother has died s-, died, all the things a mother... a mother provides for a child, my mother was not there to provide for me.","So as my mama don die s-... con die so, all di things wey mama, mama dey provide for pikin, my mama no dey to provide for me." "So, I was just managing to go to school.",So I just dey manage go school. "As hard as things were, I paid attention to my studies.","As I con manage go school reach, I put mind for book." Because I didn't want the suffering to last for long. So I was serious with my schooling.,Because I no wan make di suffer make e too long so I dey serious for my academics. "Anything we were taught, I would pay attention.","Anyting wey de teach us, I go put mind." "And another thing that helped me was the fact that all those things we were supposed to take to school, like books, textbooks, pens, pencils... me, I did not have much of all that stuff.","And anoder ting wey con still help me be sey di tings wey be sey we suppose carry go school like book, like textbook, biro, pencil, me, no too dey get all dose ones." "So the method I used was that my friends whose mothers were rich, whose parents were rich, do bring those things to school, so I would help them with their assignments.","So di sense wey I con dey use be sey my friends wey be sey deir mama dey rich, deir parents dey rich, de dey carry all those tings come school, me go con help dem do deir assignment." "I would explain the things they do not understand to them, so that they would give me one of those things for me to use.","Di ting wey dem no sabi, I go explain to dem so dat de go fit give me one of dose tings wey I go use." "I did not know that as I was doing these things, my teacher was paying attention.","I no know sey as I dey do all dis ones so, my teacher dey study me." He was looking at me.,E dey look me. "He then noticed that this person who... ah, ah!, as it so happens, she's the only one who doesn't have things, she, she, she... her uniform looks like rags, she doesn't have books, she doesn't bring food to school, and she still does better than the others.","E con see sey dis person wey be sey ah ah, as e be sey na only im no dey get, e, e, e uniform be like rag, books, e no dey gree get, food, e no dey bring come school, na im con still dey do better pass oda people." Ah!,Ah! "So, I was amazed to notice after a while that he would call me and give me food to eat.","So I con dey wonder sey small time now, e go con call me, give me food chop." He would give me some money.,E go give me small money. Ah!,Ah! I didn't know he was paying attention to me as I was helping those people.,I no know sey e dey study me as I dey take dey help dose people. "So, he developed a special kindness for me.",So e con get special likeness for me. "So much that, sometimes, even things I didn't understand... he would call me aside, and explain to me.","Sotay sometimes, even tings wey be sey me no understand, e go still call me for corner, e go explain to me." "So, all this made me get serious about my studies.",So all dis ones con make me dey serious with my book. I paid serious attention to it.,"I con dey put mind well, well." Then everyone noticed me in school.,Everybody con notice me for school. Then it started helping my performance.,E con dey help my performance. I'm the one who ended up being at the top of the class.,Na me con dey be di best person for class. "That's how it went on, from primary one until I got to primary four.",Na so I do o from primary one reach primary four. "As God would help me, I took the common entrance examination in primary four.","As God wan help me so, I do common entrance from primary four." "Then, I was given a scholarship.",De con give me scholarship. That was how I got into secondary school.,Na so I take enter secondary school. "As I was about to enter into secondary school, my mother's younger sister who stays in Lagos said she wanted to help my father.","As I wan enter secondary school so, my mama younger sister wey dey stay Lagos, e con come sey ah e wan help my papa." She said I should come with her to stay in Lagos.,Sey make I con follow am go dey stay Lagos. I was very excited.,My belle sweet me. "I thought, ""ah, at least I won't suffer anymore like I am now.""",I tink sey ah at least I no go suffer as I take dey suffer again. "So, I followed her to Lagos.",Naim I con follow am go Lagos. I didn't know the hardship would be twice as bad in Lagos.,I no know sey na double suffer I go go suffer for Lagos. "So, I... I got to Lagos.","So I can, I con reach Lagos." So all the work in the house would be done by me.,"So all di work wey dey house, na me go do am." I would be the one not to go to school as early as everyone else.,Na me no go go school early as my mate take dey go. I would be the one to wash the dishes.,Na me go wash plate. I would be the one who didn't get to go to bed early.,Na me no go quick sleep for house. "I would still be in the kitchen at ten o'clock, cooking.","Ten o'clock, I still dey kitchen dey cook." That's how it was.,Na so I take dey do. It was so painful to me.,Di ting go dey pain me. I would be crying.,I go dey cry. But I didn't know that I didn't have the choice.,But I no know sey I no get option. It was... let me just put s-... more effort into the work I was doing.,Na make I just put s-... more effort for di work wey I dey do. That was how I was just doing it.,Na so I just dey do am o. "At school, I started using the same methods I used in primary school.","For school, di sense wey I use for primary school, I con still dey use am." "There was someone I liked at my school, a teacher.","E con get one person wey I like for my school, one teacher." I liked the way the teacher used to dress.,I like as di teacher take dey dress. The teacher was staying around my house.,Di teacher con dey stay near my house. "So one day, the teacher and I boarded the same bus.","So e get one day wey me, wit dat teacher enter bus." "The teacher asked me, uh... if I was staying with my mother.","E con ask me sey ah ah, wheda na my mama I dey follow dey stay." She said she noticed that everybody comes to school early but I would be the one to come to school late.,"Sey e see sey when everybody come school early, na me go late come." And she used to see me fully dressed by six o'clock.,"And e be dey see me say by six o'clock, I don dress." I would have started walking on the streets.,I don dey waka for road. "I told my teacher, ""well, she's not my mom"".","I con tell am sey well, no be my ma-... mama o." I said she's my mom's younger sister.,Sey na my mama younger sister. "I said if I wake up early, she would ask me to go to the shop first, to go and carry things, arrange things, before I went to school.","Dat if I wake up early, she go tell me sey make I first go shop, go carry tings, arrange tings before I con come school." "So that's it, that one, that made me arrive late.","So na e, dat one dey make me come late." Then my teacher told me not to worry.,Naim e con talk to me sey make I no worry. She said that's how it was.,Sey na so e dey be. She said the only thing that will make all this suffer... suffering come to an end would be putting more efforts into my studies.,"Sey di only ting wey go make all dose suffer, suffering quick finish, na make I put more effort for my study." So I carried on.,Na so I con still dey do. What the woman told me was stuck in my mind.,Dat ting wey dat woman con tell me con enter my head. "It made me cry a bit, but she said I shouldn't worry.","Dough e be make me cry small o, e con say make I no cry." She consoled me.,E pet me. She said I shouldn't worry.,E con say make I no worry. She said I should just keep doing all these things... but I should be praying.,"Sey make I just dey do all di things o, but make I dey pray." And I should also pay attention to my studies.,And make I still face my studies. I did as she said.,Na so I con dey do o. I did...,I do. I took my exams; I finished secondary school; I took the WAEC exam.,"I write, I finish secondary school, I write WAEC." I didn't do very well on the WAEC.,I be no make my WAEC once o. I got four credits.,I get four credit. Ah! It was as if uh... I dunno.,Ah e con be like sey hm I no know. I lost hope a bit about my chances of taking the WAEC again.,I con lose hope small sey wheda I go fit write anoder WAEC. "During those holidays after sitting for the WAEC, I registered for some extra classes.","Dose holiday wey we dey after writing WAEC so, I con go enroll for one lesson." "Now these... some of the friends I made at the centre told me they had some se-... young people at home, would I mind teaching them?","Na dis, di friends wey I con make for dere, de con tell me sey de get some se-... younger, younger ones for house, wheda I go fit dey teach dem lesson." "Then, I said no problems.",Naim I con say no problem now! I said I could do it.,Sey I go fit do am. That's how I started teaching them at home and saving some money.,"Naim I begin dey do small, small lesson dey put money togeda." Then I sat for the JAMB.,I con write JAMB. I sat for the first JAMB.,I write di first JAMB. I didn't do very well.,I no still make am. It was Law I wanted to study but I didn't get in.,"Na law I be wan go study o, but I no get admission." I still didn't get discouraged.,I no still con get discouraged. "Then, I sat for the JAMB a second time.",Naim I con write JAMB di second time. "And by the luck of God, I passed.","As God wan do am so, I con pass." So I got into a higher institution.,Naim I con enter higher institution. "When I was in the higher institution, there were some people I liked and saw at my school.","When I dey higher institution, e get some people wey I be like, I be dey see for my school." "There was a woman uh... the woman, there was this way everybody respected her.","E get one woman eh, di woman, e get as everybody dey respect am." She spoke really good English.,"E get as e dey speak big, big English." "In fact, anywhere she went, people followed her.","In fact anywhere wey e go, na everybody go dey follow am." "They would be saying, ""yes ma... yes ma.""","De go dey tell am yes ma, yes ma." I was looking at her uh... why is everybody following this woman? Why is it this woman is standing up?,"I con dey look am say ah why e be sey na dis woman na im everybody dey follow, why e be sey dis woman stand up?" "Even if men stood up to greet her... everybody would be saying, ""yes ma, yes ma.""","Even men, if de go stand up greet am now, everybody go dey do yes ma, yes ma." Everybody would be rushing to carry her bag.,"Everybody go dey rush to, for carry her bag." Everybody would be opening the door for her.,Na so everybody go dey open door for her. I was suprised.,I con say ah! They said it's because she's educated.,Dey con say na because she go school. They said she had the highest qualifications.,Sey na she go school pass. "So I said, ""so, if I also become as educated as her, that's how they will respect me.""","I con say so if me sef go school like dis, na so de go dey respect me." Ah!,Ah! "Then I said, ""okay, if it was this woman's level of education that made everybody...""","I con say OK if na school dis woman go reach, (wey be sey) everybody..." "In fact, if you saw the car she was riding at the time... her car was the nicest in the school.","In fact if you see di car wey e dey ride, na only im get di best car for dat school." "Then I said, ""if it really was her level of education that took her this far, if I also get to this level, everyone will respect me too.""","I con say to say na school e go, so if me sef go school reach dis level, na so everybody go dey respect me." That made me study more.,Dat one con make me still read more. "Since no one respected me, everyone would abuse me, I was the one doing... I was the one working last in the house, I was the one doing the worst chores, I was the one going to bed last, so I said, ""okay, if I put more efforts into my studies, everyone... the impression they have about me will change.""","As e be sey de no get respect for me, sey everybody dey abuse me, na me dey do di, na me de dey see finish for house o, na me dey do di worst work, na me dey sleep late, I con say okay so if I put more efforts for my academics, everybody, di impression wey de get about me, sey de go still change am." That's why I put in more effort.,Na im con make me put more effort. I became very serious with my studies.,I con dey serious wit my studies. "Then I said, ""okay, if... after this first degree... if this woman has a PhD, I will also get a PhD.""","Naim I con say OK if, after dis first degree, if na PhD dis woman get, me sef go get PhD." "If she has more than a PhD, I will get more than a PhD.","If e get more than PhD, I go get more than PhD." Then I became serious.,Naim I con take serious. I did more.,I con do. I continued to do more.,Naim I con do o. I did more and more and more.,"I do, I do, I do." I passed my exams.,"I pass, I pass." I got good grades.,I con still make good grade. I went for Youth Service.,I go service. "At some points during the Service Corps, you know, I...","When I go service reach so, you know sey I..." "As it is with women, no matter what your level of education is, you must get married.","As woman be, no how, no how wey you go go school reach, you must to marry." "If you don't get married, it becomes a problem.","If you no marry, na anoda wahala." "So, I got married.",Naim I con marry o. "It wasn't easy to continue, but God...",E be no dey easy to continue o but God... "By God's grace, my husband is like if God put his love for me into his mind.","As God wan take do am so, my husband con be like person wey be sey God put my love for im mind." "So I told him, ""uh... my husband, there is something I want to do, please.""","Naim I con tell am sey ah husband, a beg o, e get wetin I wan do." """My dream is to be well educated.""","Sey my dream, na to go school well, well o." """And I haven't reached the level I planned to get to.""",Sey I never even reach where I wan reach for life. "Then he said, ""no problem.""",E con say no problem! He said whatever makes me happy will make him happy.,"Sey anything wey go make me happy, na im go make am happy." "So, if it's to... if I want to go to school, that won't be a problem.","So if to, na, na school I wan go, no wahala." "So, he supported me.",Naim e con support me. Then I came in for a Masters program.,Naim I con come for masters. "As soon as I came in for the Masters program, I realized...","As I con come for masters, sey I con see sey..." "Me who thought I would be the oldest person, then I realised there were people even older than me, old women who were around my mother's age, they were co-... they were... we were in the same class.","Me wey I bin tink sey I be di oldest person, naim I con see sey ah people wey even old pass me, old mama wey be sey dem be my mama age mate, de con co-... de dey, we dey di same class." "People who were almost my dad's age, they were in the same class.","People wey be sey de don nearly reach my papa age, de dey di same class." "And as we were there, that's how (as I was reading), they were... some of them were even doing better than me.","And as we dey do so, na so (a-... as me dey read) de dey, some of dem, de even dey read pass me." "One day as we were talking, uh... I heard them say uh... after the Masters program, they will go on and get a PhD.","E con get one day wey we con dey talk, ah I con still hear dem say ah after dis masters, de go still get PhD." "I said uh... if as old as you all are, you still want to get a PhD, and I am still a child compared to you all, I should also get a PhD.","I con say ah if as una old reach, una still wan get PhD, me wey I con be small pikin for una side, me sef must get dis PhD." "And all the people that were our lecturers were very young, that is they were my age.","And all di people wey be sey con be our lecturer, na small, small pikin wey be sey we be age mate." Ah!,Ah! "One person, one wo-...","One person, one wo-..." "There was a woman, who came to class, they said she was a professor.","E get one woman, she go come class, de say she be professor." I said Professor!,I say professor! When did this woman start school?,Which time dis woman take start school? "They said ""it's the same...""",De say na di same... "I said, ""oh, if this woman is a professor, I will also be a profe-... will be a professor.""","I say oh if dis woman be professor sef, me sef be profe-... will be professor." "So, I finished the Masters program.",Naim I con still do masters finish. I c-...,A-... c-... "As I finished the Masters program, God helped me.","As I do masters finish, God wan do am." I got a PhD grade.,I make PhD grade. "Then I said, ""okay Boss, I have finished this program but we won't stop here. I still want to keep going.""","I con say OK oga, I don do dis one finish o, but we no go stop for here o, I still wan continue." "He said, ""no problem now.""",E say no wahala now! "If that's what I want, that's what he wants.","Sey if na so I wan, e sef wan am." "Whatever I want in life, he will support me.","Sey anywhere where I wan reach for life, e go support me." That was how I came to collect the form and started this PhD we're running now.,"Naim I con still take come, collect form, start dis PhD wey we dey so." "So, I pray that when we finish this program, God will provide a job.","So now my prayer be sey when we do finish, meh God provide job o." May God make us happy.,Meh God make us happy. "For my kind of mechanic, for instance, when you call me to say your car broke down on the road, first I'll come with my plier and screwdriver.","For my mechanic, when you call me sey your motor don stop for road like example, I go first carry my plier, and screwdriver go dere." "When I get there, first of all, I'll check ""do you have fuel in the car?""","When I reach dere, first of all, I go check do you have fuel?" "If there's fuel in your car, I'll ask, ""before the car broke down, the mo-... will, will... did the car show any signs?""","If your motor have fuel, I go ask you before di motor stop, di mo-... will, will, di motor gave you sign?" """Yes or no?""",Yes or no? "If you give me an answer, I'll know what to do based on your response.","If you gave me answer, from dere, I will know what to do." "If, if the car gave you some signs... maybe you can tell me that the car was jerking.","If, if di motor give you sign, maybe you fit tell me sey di motor dey jerk tiatia." I will just say it's the fuel pump.,"Now, I will just say is di fuel pump." Mstchew!,Mtschew! "From there, I'll look inside your car, open the seats at the back, loosen the... where the pump is and bring it out and fix it.","From dere, I will open your car, open di seats for back, loose di, where di pump dey, and bring it out, fix it." "In some cars, becoming...","Some car, becoming." The fuel pump is underneath.,Di fuel pump dey under. "Until I remove the tank, bring it out, loosen it and wash the... this, this thing, then I will come and tell you that you should give me some money since... so that I can go to the... buy some at the fuel pump.","Till I comot di tank, comot am out, loose am, and wash di, dis ting, I go come meet you say get me money as, so dat I will now go di, buy di fuel pump." "When you call to tell me that your car is jerking... the car is jerking, jerking, jerking, first I'll come and loosen your car's plug.","When you call me sey your car is jerking, di car dey jerk, dey jerk, dey jerk, I will first come loose your plug." The plug is in the middle of the engine.,Di plug dey di middle of di engine. It's inside the top cylinder.,Dey inside di top cylinder. I'll loosen it.,I will loose. Some of the plugs use sixteen while some use twenty one.,"Some of di plug use sixteen, some use twenty one." "I'll loosen it, and the, the plug ignites the car's engine.","I will loose am, and di, di plug is di one dat gave di motor fire." It powers up the car when the fuel circulates under the top cylinder.,E use to give motor fire when di fuel circulate under di top cylinder. The piston starts taking the fuel up while the plug powers it up.,Di piston beginning to taking di fuel up while di plug gave fire. "At the same time, there's a certain fire in the middle of the engine which we call the breaking fire.","At dat period, e get one certain fire wey we dey call breaking fire for di middle of di engine." Now the engine is getting hot.,Di engine now be hotting. "If you put your hand under the car, you can feel that the engine is hot.","When you put your hand under, you will see di engine hot." "And when you call to tell me that you... your feels like it's full when you are driving, I know that can only be the shaft, or the tie rod.","And when you call me sey your, your leg full when you are driving, I only know dat is shaft, or di tie rod." "I pick up my tools, go there and take off the shaft, fix it, buy grease and some, some parts for the materials.","Carry my tools, go dere, comot di shaft, fix it, buy grease, buy some, some parts for di materials." "I will come and fix it, buy hosing, and the rest.","I go come, and fix it, buy hose, and di rest." "And when you call me to say your car... you know what's wrong with your car, you hear something... a sound when you're moving, I will come to you.","And when you call me sey your car, you just know what is worrying your car, you dey hear someting sound when you are moving, I will come." "You bring your car here, I'll take the jack, raise up the side where the noise is coming from.","You bring your motor, I will just carry jack, raise di leg wey you say e dey make noise." "If you raise up the side, then I will check, check, check, check.","If you raise di leg, I will now check, check, check, check." "Maybe there's a plate, or something wrong has broken, or something that, that has gone wrong.","Maybe dere is one plate, or dere is someting wrong wey break, or someting wey, wey is wrong there." "So from there, I'll tell you what is wrong with your car.","So from dere, I will now tell you what is worrying your car." "And then, you will give me money to go and buy the parts I will need.","And den, you go give me money go and buy di part wey I will use." "And when you call to tell me your car just... you kicked the car but it refused to start, there are two things.","And when you call me sey your car just, you kick di car no gree start, dere is two tings." "Either the battery, or the key starter.","Eider battery, or di key starter." "Either the key starter, or the battery.","Or di key starter, or di battery." When you call me...,When you call me... Or fuel.,Or fuel. "Sorry, three things.",Sorry three tings. Or fuel.,Or fuel. "From there, we will figure out how to handle the issue.","From dere, we go know how to treat di problem." "When you call me to say your car is overheating when you're moving, you noticed that your car got hot, I only know that maybe your fan is not working, maybe the gasket of your car's top cylinder's has burnt, maybe the temperature switch is not set.","When you call me sey your car is overheating when you are moving, you see your car temperature rise, I only know dat maybe your fan is not working, maybe your top cylinder gasket don burn, maybe di temperature switch not set." Something like that.,Someting like dat. "Or when you call me to say your car is acting up, it doesn't idle smoothly... if it uses a carburetor, I'll say I'll loosen the carburetor and service it.","Or when you call me sey your motor misbehaving, e no hold slow, if it is di one dat use carburetor, I will say, I will loose di carburetor and service." "Or if it is an injector, I will loosen the injector, buy.","Or if it is injector, I will loose di injector, buy." There's something we call carburetor cleaner.,E get one ting wey we dey call carburetor cleaner. "I will buy it, and come and...","I will bought it, and come and..." "That stuff, it cleans out the dirt which is in the dust inside.","Dat one, e use to clean di dirty wey dey inside, di dust wey is inside." "It cleans it, and all that.","Use to clean it, and di rest." And when you say you just came...,And when you say you just come... "Imagine you just came here and said, ""hey, here's my car!""",Imagine you just come say eh see my motor o! It's just acting up.,E just misbehaving. I was... I was driving and it's just acting up.,"Am, am going, e just misbehaving." You don't know what's wrong.,You don't know what is wrong. "Just heard the sound puh, puh, puh, puh, puh, puh, puh, puh.","Just hear puh, puh, puh, puh, puh, puh, puh, puh." "If I go there, if you load your gear, maybe, it's that the engine seat (mount) is worn out, or the engine is not... is not set right, or the idling, or something like that.","If I go dere, if you load your gear, maybe, is di engine seat don cut, or di engine no, no dey set, or dey slow, or someting like dat." There are a lot of things about the mechanics' job that if you come and tell me that your car has a problem...,"Dere is many tings about mechanics wey, if you come and ask me say your car get problem." Who's there?,Who dey dere? It is God.,Na God. What!,Ehen! This is how my life is now.,Na so my life be now. I do appreciate God.,I dey appreciate God. God is doing wondrous things in my life.,God dey do better ting for my life. That's it.,Na so o. I've been here since two thousand and thirteen.,Na since two thousand and thirteen wey I dey here. I don't have any problems.,I no get any problem. "I don't have any problem with the workers, the manager and the... those women here.","I no get any problem for di workers, for di manager, for di, dose women wey dey here." "It's that place, it's for women.","Na dat place, na women." "It's... they call it ""on child dialysis"", CWO.",Na de call am (on child dialysis) CWO. That place is for high dialysis.,High dialysis get dat place. "That place isn't a hotel, it's a guesthouse.","Dat place no be hotel, na guesthouse." You don't call it a hotel.,You no dey call am hotel. It's a guesthouse lodging.,"Na guesthouse, lodging accommodation." Yes.,Hmhm. "If you come in here, it's for lodging or accommodation.","If you come here, na lodging of accommodation." "If it's something else that you are looking for, go look for a hotel in the GRA.","If na dat place wey you go see, go see hotel now for GRA!" "When you get there, people play music, smoke marijuana, womanize and roam about.","If you reach dat place, people dey play music, dey smoke igbo, dey carry woman, dey waka up, and down." "Sometimes, you will see two guys fighting, breaking bottles everywhere.","Sometime, you go see dat two boy, dem quarrel, de dey use bottle dey break everywhere." "But if you stay in that place, it's a serene environment.","But if you come dat place con lodge, dat place go dey cool." "If he sleeps, he'll sleep well.","If e sleep, sleep well." No one will come to knock on your door at night to steal your valuable possessions like your money or your phone.,"Person no go come for dis night knock for your door say make e comot, give me your money, give me your phone!" You will not experience anything like that in that place.,You no go see am for dat place. "Even myself, I sleep outside.","Even me sef, I dey sleep outside." I don't sleep in my room because I feel hot sensations in my body.,"Because I get hot blood, I no dey fit sleep for my room." "If I sle-... le-..., if NEPA shuts the lights off, I'll come out here, instantly.","If I sle-... le-... let, NEPA take light, I go run come outside." "And then my children say ""mummy, what have you gone to do outside?""","Na so my children mummy, wetin you go do for di outside?" "I say, ""ah, mstchew, let me have a nice sleep outside.""",I say ah mtschew let me sleep well for outside. I don't sleep in the room.,I no dey sleep for room. That compound is nice.,Dat compound dey very good. Anyone who complains about that place is lying.,"Any person wey come here say e no like dat place, na lie." That's a problem for some people.,Na di problem some dey get now. You will not be laughed at if you come in here with a woman.,"If you carry woman come here, no go laugh you." Wanting her to stay with...,Sey make e stay wit... They are friendly.,De are friendly. Is it not true?,No be true? "If a couple comes in here, you will show them your wedding ring, show them something which will...","Husbandi and wife, if una come, una go show dem di ring, go show dem someting wey go..." "The person here... you will know that this, this man, with this woman, are husband and wife, not just friends.","Di person here, you go know sey na dis, na dis man, wit dis woman, na husbandi, and wife, no be friend." That is the problem.,Dat be di problem. "If you don't give them, he will go away.","If you no give dem, e go comot." "One day, I was at work when a girl came with a boy, and said, ""auntie, look!""","One day, I dey work, one girl wit one boy come, and say auntie, see!" I greeted them.,I greet dem. "Mstchew, I greeted them.",Mtschew I greet dem. He said he wanted to stay here.,Sey e wan lodge. He asked about the rooms and the prices.,Sey how much room I get? I told him I have one for five thousand.,Sey I get five thousand. "Ah the uh... the dormitory is for one, one thousand.","Ah di ehn dormitory, one, one thousand." Some dormitories go for one five.,"Some dormitory, one five." Dormitory... some go for one eight.,"Dormitory, some, one eight." "The women's side, five.","Woman own, five." Upstairs... or it's eight.,For up abi na eight. The girl said okay.,Di girl say okay. She said I should go and show them the five thousand naira room.,Sey make I go show dem di room wey be five thousand. I went to get the key.,I go collect key. Saying something to that boy in English.,Dey talk someting for dat boy for English. She didn’t know that I heard what they said.,E no know sey I dey hear dis one wey de talk. "I didn’t talk, I was looking at them.","I no talk, I dey look dem." She said it again.,E talk am again. "She didn't speak up well enough for me to hear but since she was talking quietly, I already heard the two questions she was asking that boy.","For e no talk am make e come out let me hear, but e dey talk am small, small, my ear don hear di two question wey e dey ask dat boy." "And I told her... asked her ""ah, what is she telling this boy X...?""","And I don tell her, ask am (di girl) sey ah wetin e dey tell dis boy X?" "She said, hurry up and take the... I picked up the key to the four thousand naira room.","Sey oya carry, I carry di room wey de give four thousand." I picked up the key to another one which goes for five thousand.,Carry anoder one five thousand. "Just as I was about to go out, taking the key with me, the girl said ""uh... auntie, come, come back!""","Just make I comot for di outside carry di key dey go, di girl say ehn auntie, come, come back!" """Look!""",See am! """We...""",We... """It's this boy's fault.""",Sey na dis boy o. """Yeah, he's her husband.""",Yeah na im husband. """Ah, it's a lie!""",Sey ah na lie! """And if this boy is mad-... is married to her, or you are getting ready to get married, you will show me the, the evidence.""","Sey and if na dis boy be mad-... don marry her, abi una dey prepare marry, you go show me di, di evidence." """Or tell me why I will...""",Or sey why I go... "Okay, I was the first to ask them ""ah, are you siblings with that girl?""","Okay na me first ask dem sey ah na you dat girl na di same fader, di same moder?" "The girl demanded ""why again, why am I asking? Why will I...?""","Di girl dey sharp say why again, why I dey ask, why I go?.." I said I'm supposed to ask.,I say I suppose ask. It's be-... it's... it's my job.,"Na be-... na, na my work." "I said, ""why wouldn't I ask you?""",Sey how I no go ask you? """Who is she?""",Who e be? "I said I asked because since she came here, I noticed that... I was looking at them closely, from uh... the leg... from the head...","I say why I dey ask na since when e come here, I see dat, I dey look dem from ehn leg, from head." They saw me.,De see me. "She said, ""ah, yes, it's your character.""",Im say ah yes na your character. "That boy said, ""auntie, don't say too much!""","Dat boy say auntie, no talk too much!" "They said, ""ah, he's a man!""",E say ah na man! """With... well you... well... well you... you and that girl will not sleep in the same room.""","Wit, na dis, na, na you, wit dat girl, you no go sleep for one room." The boy asked why,Di boy say why? "The girl was like ""okay, he won't sleep?""",Di girl bah say okay e no go sleep? """Uh... he's her husband!""",Ehn na husband! """Won't you let them sleep here?""",No go allow dem make e sleep here? """Isn't this place a hotel?""","Na dat place, no be hotel?" Her husband would like her to sleep in a hotel.,Na di hotel e husband go like sey make e sleep. He is the husband.,Im na di husband. "If he tells her now, she will not believe it.","If e tell am now, e no go believe." She doesn't... she doesn't like Catholic kids.,"E no dey, e no like Catholic kids." "Uh... she mstchew, talks about it.","Ehn she, mtschew dey talk am." I don’t know what she said that day but they said he is the husband.,"So I no know wetin e talk dat day, but de say na e husband." He won't like sleeping alone.,E no go like make e sleep by imsef. Hasn't he noticed the important men who stay here?,"Still, e no see big, big man wen dey come sleep here?" He hasn't said what exactly is on his mind.,"E never talk, talk someting wey e carry for mind come out." I don’t know what's on his mind.,"Anyting wey e carry for mind, I no know." Is this boy your boyfriend?,"Dis boy, na your friend boy." I will not give you a room to sleep in.,I no go give you una own make una sleep. Go and stay in another place.,Make una go for anoder place go sleep. "In as much time as I have spent speaking with you, that boy was talking to someone on a big phone, in Igbo.","Dat time wen I dey talk una, dat boy carry big phone dey call one boy for Igbo." "Asking them, ""where are you?""",Si ya eh kee ebe ino? """X, I am looking for an hotel where I will lodge in Igbo.""","X, I dey look for hotel where I go sleep for Igbo." """I've seen it, but I'm in that place they call Bethany.""","I see am, but I dey dat place wey de call Bethany." I don’t know what that woman was saying in Igbo.,I no know wetin dat woman dey talk for Igbo. "She said that uh... the boy that uh... I am... uh... ah, ah, ah... Upper Weeka.",Sey ehn di boy say ah I dey ehn ah ah ah Upper Weeka. So um... I don’t know the particular park he called it.,So ahn I no know di particular park di boy call am. "Because, see... ah, he should go and look for a hotel in GRA.",For see ah make e go look for hotel for GRA. Uh... he mentioned the two hotels but I don’t know the particular place.,"Ehm e call two name for hotel, but I no know di particular place." Hmhm.,Hmhm. "Yes, good afternoon!",Ehn good afternoon! My name is Oke Lucent Akporube.,My name na Oke Lucent Akporube. "I'm a musician; I'm a drummer, I play drums and I'm very good on drums.","I be musician, I be drummer, I dey play drum, and I dey very good for di drum wey I dey play." And the way I... how I started... how I got to the level I am now... I had a passion for music when I was a kid.,"And how I take, how I take start, how I take reach di level wen I dey now, I bin get dis passion for music when I small." "As a kid, you really don’t have a reason to go to church.","As children now, when you go church, you go just go church." You'll go there to learn what's of interest to yo... what you like... what you have your eyes on.,"Di one wey dey hungry you, wey you like, wey your eyes dey, na im you go go to learn." "Then, when we were younger, my father was attending Assembly... Assemblies of God.","Den, wey we small, my father dey go Assembly, Assemblies of God." "So when we were in the church, the drummers... the instrumentalists made an announcement that if you want to learn how to play instruments... musical instruments, you should come learn it in the church!","So when we go church di drummers, di instrumentalists dere, dem make announcement for church sey if you wan learn instrument, musical instrument, come church con learn!" So we... we went to learn.,"So we now, we go to learn." "So, you know this politics in churches... all these uh... guys were choosing... they were looking forward to teaching the ones whose parents were rich.","So you know dis politics for church, all dese ehn guys, dem dey choose, dem dey look di people deir parents get money to teach di children." So they picked all the children they wanted to teach.,So de don select all di children finish. "But me, determined at the age of four, I said I needed to play this thing by all means.","But me, with determination, I say any how e be, dis thing, I must play am at di age of four." "I'll go to church, I'll go to play.","I go go church, I go go to play." "They took the drumsticks from my hands, saying, ""get out of here!""","Dem go collect drum stick for my hand, say get out from here!" """You, did your father pay?""","You, your father pay money?" "All those ones... I said, ""okay, no problem!""","All dose ones, I say okay no wahala!" "Crying... I would go home crying, come back again and they would still chase me away.","Wit cry, I go cry go house, come back again, dem go still pursue me." It's either they take the pedal away or they take the drumstick.,"Either de comot di pedal, or de collect di drumstick." "So afterwards, when I'm ready to go play, I take the pedal I made myself and the drumsticks in my pocket.","So now, if I dey go, I go carry pedal wey I do with my hand, and carry stick for my pocket." "When I get to the church and they take their stick and their... the pedal, I'll take my own pedal, take my sticks and play gradually.","When I reach church, de collect deir stick, and deir, di pedal, I go put my own pedal, carry my stick, dey play small, small, small, small, small, small." "They would come around, listen to what I was playing and then chase me away.","De go come, de go hear am again, de go pursue me again." I would leave the place.,I go comot for dere. So I had to go home.,So I get to go house. "The seat... my... the chairs in my house had wooden handrests, all those old school chairs, and foam you can rest your back on.","Di seat, my, di chair for my house, dem get wooden hand all dose old school chairs, and foam wen dey rest your back." "So and my floor, if you bang it, it sounds like a bass drum.","So and my floor, if you match am, e dey sound like bass drum." "So that was where I was learning to play, with toothbrushes.",So na dere I come dey learn with toothbrush. "I practice, I practice, I practice, everyday.","Everyday, I dey practise, I dey practise, I dey practise." "So one day, the drummer did not come to church.","So e get one day, di drummer no con come church." So they were looking for someone to play the drums.,De come dey find who go play drum. "As small as I was (at the age of... then, I had started playing, I was already six years old) so I sat on the drums and I played them that day.","As I small (na at di age of, den, I don dey play, I don reach six years), na I sit down for drum, I come play dat day." "So they were asking, ""haha, whose child is that?""",De come dey ask sey haha na which person pikin be dat one? "My father came out proudly saying, ""he's my son!""","My father, with pride, e con come outside say na my son o!" "This person came out and said, ""ah, your son did well!""","Dis, de come say ah your son dey try o!" "So with that, I was just learning gradually, I was learning until I started going to play in different churches.","So with dat level, I just dey learn small, small, dey learn till I con dey go different churches, go dey play." "So by the time I was eight, I had started playing in the church.","So when I reach eight years, I don begin dey play for church." I had started making money gradually.,"I don dey make small, small money." So I don’t have the time to go telling my father that I wanted to buy this and that.,"So I no get time to go dey tell my father sey I wan buy dis, I wan buy dis." So I was assisting him.,So I just dey assist am. "Though, my family... then I understood the way things were, but at a stage, when I started... (in fact, what year was it? In nineteen ninety five), when I got into secondary school, I met a guy.","Though, my family, den I understand di way things dey, but at a stage, when I con (at which year sef, nineteen ninety five), when I enter secondary school, I con meet one guy." "The guy plays drums, he plays bass, he plays everything.","Di guy dey play drum, dey play bass, dey play everything." I became his friend.,I come just make am friend. We were just playing.,We just dey play. Every time we went to his house.,Everytime we go im house. "Even the bass guitar, I play bass guitar.","Even bass guitar sef, I dey play bass guitar." I was... I'm really good at bass guitar too.,"I be, I dey very good with bass guitar too." "But when my brother started learning to play bass guitar, I had to stay off it so that he could focus on that.","But as my brother come dey learn bass guitar, I get to comot hand for dere so dat make e use dat one take dey do im own." "Then, myself, I just focused on the drums.","Den, me, I just focus on di drum." So I was playing drums.,So I con dey play. But there was a boy on my street I used to play with from time to time.,"But e get one boy wey dey my street, everytime, we dey play." "When I'm playing drums... whenever I see a place where they're playing drums, all the kids do a service.","When I dey play drum, when I see where de dey play drum all di children, de go do church." "You know that children know how to organize church services; they will just gather together and be singing, people will be playing.","You know sey children sabi do church now, dem go just gather dey sing, people go dey play." "So myself, I'll just go, go and be playing as if uh... I'm the best.","So me I go just go, go dey play as if ah na me sabi play pass." "But this boy, we were all...","But dis boy, all of us dey dey..." You'll never see this boy coming out to show off his skills.,You no go ever see dis boy come outside say e dey play anything. I know that this boy is a wizard on the drums.,I know sey dis boy na wizard for drum. He has practiced really well.,"E don rehearse, e don tight well, well." "One day, my church... (I was with Redeemed Christian Church then), so they said they needed a drummer in the headquarters.","One day, my church (I dey Redeem den), de con say de look for drummer for headquarter." "Before I knew it, I saw this boy playing drums.","Before I know, I see dis boy dey play drum." "When I heard the boy playing drums, I got scared.","When I hear di boy dey play drum, I begin fear." "The boy played so well, he played better than anyone in the church.","Di boy so play pass, e play pass everybody for di church." "I said uhuh, so this guy... (his name is Kevwe), I said, ""so you play drums and you've been hiding your skills, no worries!""","I say ehen so dis guy (e name na Kevwe)... I say so you dey play drum, you dey hide am since, so no wahala!" "Because of that boy, I decided to rehearse all night for two years... every night till I...","Because of dat boy, I decide to do all night rehearsal for two years every night till I o..." I was going to church every Monday.,I dey go church every Monday. I'll go by ten o clock in the night.,I go go by ten o'clock in di night. I will rehearse till four o clock in the morning.,I go rehearse till four o'clock in di morning. Then I will come back.,Den I come back. "As soon as I get to the house, I will just do one or two things, take care of myself.","As I reach house, I just do one, or two things, just arrange myself." I will go to school.,I go go school. "When I come back from school, I will wait a little, then I will sleep.","As I come back from school, stay small, sleep." "Then at night,I will go out for evening service.","Den, for night, I go go evening service." "As soon as the service is over, I will go home, and then go back to church.","As soon as service close, I come house, go back to church again." "Every Monday to Friday, every week (apart from Saturday and Sunday), for almost one year, that's the time I set as my target.","Every Mondays to Fridays, every week (apart from Saturdays and Sundays), for dat kind one year, na im give myself." "The next time the guy and I met... the next year, the boy realized that it was a power struggle.","Di next time wey me, and di guy meet, di next year, di boy see am say power don jam power." He had to step down for me.,Im get to relax for me. So he said they took him away from the headquarter church.,So im say de con remove am from di headquarter church. And I was made the drummer.,De con make me di drummer. I said no.,I con tell dem sey no. "It's not my style to get involved in those things, but I've been playing in the church all my life.","No be my lifestyle to dey do all dose things, but, all my life, na church I don dey play." "When I mistakenly said okay, I had a misunderstanding in my church.","Di time wey I just mistakenly say okay, I come get one misunderstanding for my church." "I said okay, let me just get... let me go and try this secular music... let me have a taste of secular music.","I say okay, make I just get, meh I go try dis secular music, dis secular, meh I see as e be." "So I said, okay, let me try this club.",I con say okay meh I try dis club. "When I tried the clubs, I played in the club for three months, at least.","As I try club, I play for club for at least three months." "In those three months, I know what I saw, where someone will smoke and blow it out on your face.","Dat three months so, na me know wetin I see, where di person go smoke pour cigar for your f-... face." "All those... and myself, I don’t like all those things.","All dose, and me, I no like all dose things." But God Himself warned me not to go play in the club again.,"But, God himsef come warn me seriously sey meh I no try am again go play for club." How did you do it?,How you take do am? It's... it just happened that I got sick.,"Be sey e come be, I come fall sick." I couldn't do anything for almost two months.,"For dat kain two months, I no fit do anything." "So when I go to church... I went back to my church and I met with my pastor, asking him not to be offended about what happened.","So when I go church, come go back to my church, come go meet my pastor say make e no vex for wetin happen." So I have come back.,So I don come back. "That same day, I had a dream.","Immediately dat day, I get one dream." "So in the dream, I saw someone... a woman gave me tri-...","So for di dream, I see somebody, one woman give me tri-..." She gave me some...,E give me some... I had seen the woman in a dream.,I don dream see di woman. The woman gave me something and I took it.,"Di woman give me something, I collect am." "As I was going, I didn’t know that I got sick on account of that dream.","As I dey go so, I no know sey dat dream, na im make me dey sick." "So as the pastor was preaching, I got... but you can recall your dream and make sure you return anything you collected from anybody; I said, ""now, I know!""","So as di pastor preach I receive, but you can recall your dream, and return anything you collect from anybody, I say ehen!" So I recalled the dream and I waited.,"So I con recall di dream, I wait." "A a child, I then prayed.","As small pikin, naim I come pray." "That night, I had the dream","Dat night, I see di dream." Then I saw the woman.,I con see di woman. The woman had given me meat and she was already leaving.,"Di woman don give me meat, di woman don dey go." So I called her back.,Naim I call am back. "I said, ""ma'am, come back for your thing, use it!""","I say madam, come take your thing now, use am!" I threw it to the woman and she caught it.,"Throw am give di woman, di woman catch it." "The next... as I woke up, I started sweating.","Di next, as I wake up, I begin sweat." "Afterwards, I was fine.","After dat day, I get mysef." "So since then, till I came down to Portharcourt to start playing for the church I attend now, till now, I didn't go to play in any other church.","So since den, till I con come Port-Harcourt con begin dey play for my church wey I dey now, till date, I never go any church go play." "So if it's commitment, right, if God is... if God blesses someone for what they do, ah... well, I don’t know because I am not God.","So if na commitment, ehn if God dey, if God dey bless person because of wetin e dey do, ah I no know sha because I no be God." "Because I receive God's blessings everyday, but I will... I will...","Cause I dey see God blessing everyday, but I go, I go..." "What I am trying to say is that music, if you don’t like music... (because personally, music is my life), if you take music away from me, then I'm finished.","Ting I dey try to talk be sey music, if you no like music (because personally, music is my life), if you comot music for my life now, I don finish." "So my life is all about music, and God.","So my life is all about music, and God." So that is what I have... see... and that's the only thing I want to tell you.,"So dat is what I have, see and na only wetin I wan tell you." My advice to anyone who is into music is that they should do what they know will make God bless them and the people who listen to them.,"My advice to anybody wey dey do music, make e do di right thing wey know sey e go make God bless am, and bless people wey dey listen to am." Thank you!,Thank you! "Ah, myself, I have been at home.","Ah me, I bin dey my house." Just there.,Just dey. "Uh... one of my guys, a male friend, those days, he called me.","Ehn one of my guy, guy friend, dose day, im call me." He told me there was a new job that had just come up.,Tell me sey e get one work wey come out. I asked him what kind of job it was.,I tell am sey which kind work be dat o? He told me that uh... he has people who would work... who would do the work.,"Im tell me sey ehn im get people wey go work, wey go do di work." "But, he wants me, who is here, to be the one to do it because he doesn't trust the other... the other people.","But im wan meh im be me wey dey here because im no too trust di oder, di oder people." "So I asked him, ""what will the work be like?""",So I tell am sey how di work go be? He told me that it’s uh... work in a bush bar.,Im tell me sey na bush bar ehn work. "I told him that since I am, I, I am training for a job.","I tell am sey as I dey, me, I, I dey learn work." That I'm... I'm almo... I'm... I'm... I'm... I'm... I am... I'm getting through in uh... in my work.,"Sey I'm almo-... I'm, I'm, I'm, I'm, I dey, I'm getting trough in, ehn in my work." "So he told me I should come and give it a try, so it won't be as if I'm always just staying at home.","So im tell me sey mah I con try, meh e no be sey I just dey dey house everytime." "I told him no problem, no problem!","Tell am sey no wahala, no wahala!" He told me I should go.,Im tell me sey mah I go. He will call me.,Sey im go call me. He will call me when they... when their... when their manager comes back.,"Im go hala me when de, when deir, when manager comes back." "So, I was waiting, waiting, waiting.","So I con dey wait, dey wait, dey wait." I didn’t get a call from him.,I no con see im call. I called him.,I call am. "I said ""how far now?""",I tell am sey how far now? He told me I should just relax.,E tell me sey mah I just relax. That the work... the work would soon be ready.,"Sey di work, di work go soon prepare imsef." "Mstchew, I told him that nna omo me no problem.","Mtschew I tell am sey nna omo me, I too dey here." "As I was at home, there was no work at the place I was doing my training.","As I dey house, work no dey dey for di place wey I dey learn work." We generally don’t have any work to do.,We no dey too get work. "Mstchew, so I told him, ""no problem now, I'll keep waiting for you now.""","Mtschew so I tell am sey no wahala now, mah I dey look you now." Then it took like (let's just say) a month.,Im con take like (mah I just say) for a month. "Let's just say a month, or three weeks.","Let me just say a month, or three weeks." Hah!,Hah! Then he called me again.,Im con call me again o. "He told me ""uh, my friend, another job has come up, and it's me who would be in the VIP... VIP bar.""","Tell me sey eh omo anoder one don come out o, sey na me I go dey for VIP, VIP bar." Not in the normal bar on that side.,No be for normal bar dat side. "I told him ""Hah! Wow! That one makes sense.""",Tell am sey ha chey dat one make sense o. "It is as if I... I... I, I was in a hurry, hurry, hurry to come and do this one because he told me that I would just go and relax under the AC, I would relax and work.","E be like sey me I, me I fit hurry, hurry, hurry go, come do dis one o cos im tell me sey I go just go relax for AC, relax dey work." Do you understand?,You understand? "So, mstchew, that's how I asked him, ""when... when should I come?""","So mtschew naim I tell am sey when, when I go come?" He told... he told me that I should...,"Im tell, im tell me sey mah I..." That he would call me when the manager comes.,Sey im go call me when manager come. "So as the manager came, he called me, told me that I should come around, around twelve.","So as manager come, im call me, tell me sey mah I come around, around twelve." "So I tell him ""Hah, no problem!""",So I tell am sey hah no wahala sha! "So my sister (my sister and I were in the house) told me ""Hah!""",So my sister (me and my sister bin dey house) tell me sey hah! "My brother uh, my...",Nna ehn my... Hah why did I...,Hah why I do... Why would I do that work?,Why I go do dat work? "Because I, I don’t... mtschew.","Because me, I no mtschew." "It's not like I really like it because the money did not, mtschew the money didn't make sense.","No be sey I like am like dat because di money no, mtschew di money no too make sense." "I told him ""no problem.""",Tell am sey no wahala. """Let me go, I'll go do it now.""","Mah I go, mah I go do am now." "So, then I went.",So now I come. The guy told me...,Di guy tell me sey... "Okay, he told me that I should come here.",Okay im tell me sey mah I come here. "That the guy who was here, he would uh... teach me some... certain things.","Sey di guy wey bin dey here, e go ehn teach me some certain tings." You understand?,You understand? "So, I told him, ""no problem.""",So I tell am sey no wahala. "So the guy was telling me, he was teaching me, teaching me.","So di guy con dey yarn me, con dey teach me, teach me." The guy is real... is about to go.,"Di guy is real, is about to go." The guy got...,Di guy get... "Uh, it's as if he has his uh, national... NYSC.",Ehn e be like sey e get im ehn national NYSC. He wanted to go and do his NYSC.,Im wan go service. "So, mstchew, so, that’s how, me, I'm here.",So mtschew so na so me I bin dey here o. So I was here.,So me I bin dey here. The guy is about to go.,Di guy is about to go. Maybe it's today the guy will be leaving.,Maybe na today di guy go comot. "Me, I will, I will take over.","Me, I go, I go take up." "So mstchew, that’s how, that’s how it is.","So mtschew na so, na so e be o." "That’s how it is, hehe.",Na so e be hehe. It's serious.,Na wa o. "Osas, your wedding you're preparing for, I... I'm looking forward to it.","Osas, dis your wedding wey you dey prepare, me I dey look forward to di ting o." "Uh... auntie, it's not easy.","Ehn auntie, di ting no easy o." This is seriously keeping me up at night.,Di ting dey give me serious sleepless night. "Me, I'm not worried because I'm just looking forward to that day so I can dance.","Me, I no worry o because my own be sey I just dey look forward to dat day so I go dance." I can't even sleep.,I no dey fit sleep. "And as it is, me, I like my bride, the girl's so fine.","And as e be sey me I like my bride, the girl fine like anyting." Hm.,Hm. "Her character, she and I just connected the first day I saw her.","Her character, me, and her just blend di first day wey I see her." That's how you just forgot your boy.,Na so you just forget your boy be dat. "Ah, I forgot my boy.","Ah, I forget my boy o." You've gotten a new daughter.,You don get new daughter. You don't see?,You no see? Uhuh!,Ehen! "You didn't see the attraction is that since I've gotten my daughter now, it's the daughter that fills... rules the house.","You no see di attraction be sey as I don get my daughter now, na di daughter dey fill, rule house o." There is no problem.,No wahala now. Toh!,Toh! "Because all of you, by the time you get married, you'll forget everything, but if I have a daughter I get along with, I can come to her house anytime.","Because all of una now, by di time you marry, you forget everyting, but if I get daughter wey me, and her dey tilt, I come to her house anytime." "Auntie, I don't believe we'll forget home.","Auntie, I no believe dat ting sey we go forget house o." Don't disturb me.,No dey worry me. Ah!,Ah! That's how men behave.,Na so men dey do o. "When you've concentrated your wife... on your wife, you'll have forgotten everything.","When you don concentrate your wife, for your wife now, you don forget everyting." How?,For where? "No, no, no, no.","No, no, no, no." I've had brothers that haven't forgotten our home.,I don get broders wey never forget house now. "They're still there, they're still in the house.","Dem still dey, dem still dey di house." "Uhuh, but the truth is that when you look at what they're doing and what their wives do, their wives, they are stronger.","Ehen now, but di true be sey when you look wetin de dey do, wit wetin deir wives dey do, deir wives de dey stonger." "Then, that's right.","Den, dat one dey sha." "And you agree that the house, it's the woman that takes care of it, right?","And you gree sey house, na women dey take of am ba?" "Haha, that's it.",Haha dat one dey. Yeah!,Yeah! It's the woman that takes care of it.,Na woman dey take care of am. You know... you'll just be there saying that it's you that's the head.,"Una know, una go just dey chill dere dey say na una be di head." That's right.,Dat one dey. "But auntie, that's not the issue.","But auntie, no be dat, na im be di ting." The major issue is the wedding preparation.,Di major ting na di wedding preparation. Ah!,Ah! What preparation?,Wetin preparation? It's you... is it not you who wants to bring a wife to the house?,"Na you, no be you wan bring wife come house?" "Uh... sure I want to bring a wife to the house but, auntie, the thing uh... is feeding off my money.","Ehn I wan to carry wife come house now, but kai mehn auntie, dat ting ehn, dey sap my money." "Ehe, so, it's you that will...",Ehe so na you go... It's good.,E good now. "Because when you know that something is precious, no matter the amount, it will not disturb you.","Because when you know sey someting dey precious, no matter di amount, e no go worry you." "As it is now, with the reccession, we don't even have the money, that's the problem.","As e be now sef, recession, we no even get di money, na im be di ting." "Aha, you don't have to use a lot of money.",A'Ah you don't need to use plenty money now. Aha!,Aha! "Auntie, how can you tell me that I don't need to?","Auntie, how you go tell me sey I no need to?" You wanna come and eat?,You want come chop? I'll come and eat.,I go come chop now. "Even if I don't eat, there is no problem.","Even I no chop, no problem." People want to come and eat.,People want come chop. Uhuh!,Ehen! What will you do?,Wetin you go do? Won't I provide food for them?,I no go provide food for dem? What's there?,Wetin dey? Corn isn't easy.,Maize no dey easy. Hm.,Hm. Just cook tuwo.,Just cook tuwo. "Haha, tuwo will be plenty.",Haha tuwo go plenty pass. "Auntie, you go to market.","Auntie, you dey enter market." You know how much corn is in the market now.,You know how much be maize now for market. I know!,I know now. Uhuh!,Ehen! "And the thing is that, wu-... No matter how much you spend on the wedding, the truth is that people will still insist that they didn't get food to eat.","And di ting be sey wu-... no matter how you spend for wedding, di truth be sey people go still insist sey de no get food chop." Uh... but there are major things that I need to do.,Ehn but e get major tings wey I need to do. Then that's to say you're supposed to plan ahead.,Naim be sey you suppose plan ahead. "Auntie, even buying her wedding gown is money, getting my own suit is money.","Auntie, to even get her wedding gown sef, na money, to get my own suit, na money." "It's true, it's true.","Na true now, na true now." There's food.,Food dey. But you have an old suit?,But you get old suit now? You can take it to the dry cleaner.,You fit carry am go dry cleaner. Uhuh!,Ehn! You know as women... you know how you are.,"You know as women, you know as una dey be now." "If it's not your color, you won't agree.","If no be una colour, una no go gree." I have black.,I get black. "Let me use black, she didn't agree.","Make I use black, she no gree." "Uhuh, it's her day.","Ehen now, na her day." It has to.,It has to. "Alright, it's her day.",Toh na her day. That's where the money issue will be involved.,Dat na where di money issue go enter now. "But you know that... but you know that the truth is that, if you look at our own culture closely, those things are not necessary.","But you know sey, but you know sey di truth be sey ba if you look for our own culture well, well, all dose tings no dey necessary." I have to get the color.,I gats go get di colour. As we have borrowed the white man's culture...,As we don borrow Oyibo culture... But the women will not agree.,But di women no go gree. Women will not agree.,Women no go gree. You know what?,You know wetin? "If you change your mind now and say I don't have this and I'm not getting married, she will come back.","If you change your mind now sey I no get dis, I no dey do, she go come back." Uh... you think so auntie?,Eh you tink so auntie? "Haha, yes now haha.",Haha yes now haha. Haha.,Haha. I don't think... I don't think so.,"I no tink, I no tink so o." Lit-...,Lit-... Aha!,Aha! "If she really likes you, she will come.","If she really like you, she go come." "I don't think so, I don't think so.","I no tink so, I no tink so." She will come because...,She go come because... "Oh, women always check that okay it's their day, they need to be happy that day.","Oh women dey always check am say okay na deir day, de need to dey happy dat day." Because...,Because... Uhuh!,Ehen! "So, just do what they want.","So, just do wetin de want." Uhuh!,Ehen! But what color did she choose?,But which colour she choose? "She chose uh... royal blue, lilac and...","She choose ehm royal blue, lilac and..." I like that color.,I like dat colour. No wonder she and I connected very well because royal blue is one of my favorite colors.,"No wonder me, and her blend well, well because royal blue na one of my favourite colours." Royal blue is my color too.,Royal blue na my colour too. "It's Chelsea, but I don't have a royal, royal blue suit.","Na Chelsea so, but I no get royal, royal blue suit." I have to wear... I have to go and find it in the market.,"I gats wear, I gats go find for market." Hm.,Hm. You can buy and sew it.,You fit carry sew now. You don't have to buy an ori-... a ready-made.,You no need to buy ori-... ready made. "Ah, sewing will be more expensive auntie.",Ah sewing go dey more expensive auntie. "Alright, ready made will be okay.",Toh dat ready made go dey okay now. Even getting the material...,To even get di material... That's not a problem.,Dat one no be problem. "I know when you talked about food, in this part of our culture, it's not just you that'll bring food that day.","And you know when you talk about food, for dis our own part of di culture, no be only you go bring food dat day." "People will contribute, people will donate.","People go contribute, people go donate." "The only thing is that you'll plan based on your own budget so that if they add to it, it's an addition.",Di only ting be sey you go plan base on your own budget so dat if dey add na jara. "Alright, auntie, so far as it is, nobody is bringing anything.","Toh auntie, so far as e be, nobody dey bring." They will.,De go bring. "When the time is close, you will see.","When di time near, you go see." When?,When? You'll see.,You go see. "This, we are talking um... about a month's time.","Dis now, we dey talk ehm a month time." "Me, I'm telling you that my wedding uh... my family just left me to do whatever I wanted.","Me, I dey tell you sey my own wedding ehn, my family just allow me dey do anyting wey I want." "Two weeks before the wedding, that was when they made up their mind.","Two weeks to di wedding, na im de make up deir mind." "Because there was a time that I said please no, I don't want visitors; no, I don't want cards; no, it's only three people; it's only ten people.","Because e get one time wey I, wey I talk sey please no, I no wan visitors, no, I no wan cards, no, na only three people, na only ten people." They didn't say a thing to me.,De no answer me o. "It was two weeks before the wedding that my sister said look, this wedding is not your own, it's the whole family's.","Na two weeks to di wedding na im my sister talk sey look, dis wedding no be your own, na di whole family." "Because, in our own culture, a wedding is not just for you, it's for the family.","Because for our own culture now, wedding no be only you, na di family." "Because people that don't know you will come because they know your mother, they know your sister, they know your brother, they know your uncle.","Because people wey no know you go come because de know your mama, because de know your sister, de know your broder, de know your uncle." All these people will come for that wedding.,All dose ones go come for dat wedding. "Her own family too, it's the same thing.","Her own family too, na di same ting." "So, they will say, ""this wedding is not just for you.""",So de go say dis wedding no be only you o. They'll just let you do what you want to do.,De go just allow you do wetin you wan do. "When you get to that stage, when you stop, they will add.","Meh you reach dat stage, when you stop, de go add." Ah!,Ah! "And the truth about a wedding is what you don't have, don't go and borrow.","And di truth about wedding be sey wetin you no get, no go borrow." "Auntie, I don't want to depend on that.","Auntie, I no wan depend on dat one." I know that people will...,I know sey people go... "No, I didn't say you will depend on that.",No I no say you go depend on dat one. Plan according to your budget.,Plan according to your budget. What they will bring is an addition.,"Di one wey de bring, na jara." "That's right, that's right.","And dat one dey sha, dat one dey." I know that it's difficult.,I know sey e dey hard o. X.,X. It's not easy.,E no dey easy. "I'll tell you that man, this thing is keeping me up at night.",I tell you sey mehn di ting no dey make me sleep. By the time X.,By di time X. X.,X. "Don't worry, haha.",Don't worry haha. "Two AM, that's when I'll just wake up and be thinking, thinking what... what I have not set on the ground and what I have not set on...","Two a.m., na so I go just wake up dey tink, dey scan wetin, wetin I never set on ground, wetin I never set on..." "As in, the thing is making me feel like I haven't even done anything.",As in di ting dey make me feel like sey I never even do anyting. About everything that I've done.,Upon everyting wey I don do. I have advised you to make a checklist.,I don advise you say make you get checklist. I will still...,I go still... "I have, auntie.",I get auntie. Hm.,Hm. I have the checkli-... uh... check uh... this thing... list.,"I get di checkli-... eh check, eh dis ting, list." "If I'm sleeping, I'll just wake up and be feeling like okay, there is something I didn't write on this list.","If I dey sleep, I go just wake up dey feel sey okay e get someting wey be sey I no write for dis list." It's the joy.,Na di joy now. "So that they... after the wedding, you'll just say, ""is that it?""","So dat de, after di wedding, you go just say is dat all?" Hm.,Hm. "Auntie, I like to sleep.","Auntie, I like sleep." Haha,Haha. "Anything that will disturb my sleep, I don't like it.","Anyting wey go disturb my sleep, I no dey like am." "If you remember, there has been an issue on the ground which has been talked about.","E get dis matter wey bin don dey ground, wey bin don dey talk about, if you remember." Yeah.,Yeah. "Last week, we heard some news that I don't really understand.","Inside of di week wey waka pass, we bin hear some talk wey no too understand." It seems like they are considering hiking the fuel price by five naira.,Like sey de dey reason sey de wan put five naira on top of fuel money. "Well, it's not just fuel.",Ehn no be only fuel. Fuel and diesel.,"Fuel, and diesel." "The people have started complaining about the scarcity of food, yet you want to raise prices!","Ehn people con begin dey para sey food no dey ground, una wan add money again!" It's... I said you should take it easy!,Na I say take am easy! I know that was uh... in the past week that I started saying that people should take it easy...,I know sey dat's eh inside of last week wen I bin dey talk sey make people take am easy. "That one... that one, it happened on Friday.","Dat one, dat one, na on Friday na im e happen." I know you don't really trust me.,I know sey una no too trust me. "Beause you've started thinking, ""what are you saying, Titi? They want to increase the price by five naira and you are telling us to take it easy"".","Because una con dey reason sey aha Titi, de wan put five naira, and you dey tell us make we take am easy." "Now, I'll tell you why I've been asking you to take things easy since last Friday.","Now, I go tell you why I bin tell us moh we take am easy last week Friday." The reason is that I trust the government of the state I live in.,Di reason na because I trust di government of di state wey I dey inside. That is the first reason.,Dat one na one. I trust the government of the people I voted for to represent me.,"I trust di government of di people wey me, I vote mey de representate me." That is the second reason.,Dat one na two. What about the Federal Government?,And di overall government nko? I trust them too.,I trust dem join. That is at the Federal level.,Dat one na federal level. "Now you understand that from Federal to State, to Local Government, Ward level and the like, I trust them.","You get so from federal, to state, to local government, to ward, and all di rest like, I trust dem." You know I know they can't go beyond what they've been mandated to do.,You get I know sey de no fit do pass wetin we send dem. "You have an idea of the level, based on who you are.",You know di level now base on who you be. "Someone said, ""shut up Titi, you are a smooth talker!""","Somebody say shut up Titi, you get mouth!" "Seriously, I trust them.","But seriously, I trust dem." "I trust that no matter how bad it is, they will consider us in whatever decision they want to make.","I trust sey bad as e bad reach, any decision wey de go make, de go think about us before dey make am." You understand?,You understand? "Yes, because we are all in this together... we are in this together.","Ehn because all of us, we dey inside dis waka together o, we dey inside together." "You understand, the difference between me and the guy who is in charge on the other side, is that myself, I buy one mudu [measure] of Garri while he buys one bag.","You get di difference between me, and bros wey owes side now, na sey me, I dey buy one mudu of garri, e dey buy one bag." There is no difference in price at the market.,Di price for market no dey different. The same price is applicable to both the poor and the rich.,Na di price wey de sell give poor man na im de dey sell give rich man. "The difference is that I buy in a smaller quantity and the rich guys... they buy in bags, trailers, loads and the like.","Di difference, na im be sey me dey buy small, small, and di big bros, dem dey buy bag, trailer, load, and all di rest." You get it?,You get? "But, that doesn't mean that a bag of rice for the poor is different from a bag of rice for the rich man.","But, dat one no mean sey bag of rice for poor man, e dey difference for bag of rice for rich man." No!,No! The price is the same.,De dey di same price. So they will consider us in anything they want to do.,"So anything wey de wan do, de go think about us." "So that's why I was telling you on Friday that you should trust them to think about the matter, and they will not just make any decision.","So dat one na why I bin tell you on Friday sey make you trust sey de go reason about di matter, and de no go just make any decision." And I was happy this morning when I woke up and realized they didn't make a rash decision.,And I happy dis morning when I wake up wey I see sey de no just make just anyhow decision. I told you!,I bin tell you now! "Believe whatever I tell you, even if I say the rain will fall in the dry season!",Dey believe me if I tell you sey rain go fall for dry season! Believe it!,Believe it! Do you know what I saw?,You know wetin I see? Why will I believe the unbelievable?,Why I go dey believe some kind things? "But, but you know... let's be serious here... let's be serious here.","But, but you know serious, serious!" Jokes aside!,Comot joke for di matter! "So based on that information which filtered out on Friday, I'll tell you the story as it's supposed to be.","So on top dat informate wey bin comot on Friday, now, I go tell you di tori as e suppose be." "You understand, because the news didn’t get to us the way it's supposed to.",You get because no be as e suppose be na im e later reach we side. "By the time the story got to us, it was distorted.","By di time wey di tori reach we side, some people don comot small, don add small." "They put salt on it, they put pepper, they added so many things!","De don put salt, de don put pepper, don put so many things." This is a ploy to make the story sell.,You get to just make di story make e sell small. But here's the deal.,But see di deal here. "According to the Chairman of the Senate Committee on Works, Kabir Gaya, representing the APC [All Progressives Congress] in Kano, the way he spoke about the matter, it's obvious that you shouldn't act on a one-sided story.","According by di way wey Senate Commitee on Top of Works, dem chamo, Kabir Gaya wey dey representate APC Kano, di way wey e take yarn di matter, de no dey hear one side of tori judge o." "If you pass judgement based on what you heard from one side of the story, then you are not a good judge.","If you hear one side of yarn judge, you no be correct judge now." You need to listen to all sides of the story before you make up your mind.,"You go hear here, hear dere, hear every, den you go come yarn di colour of your belle." "But right now, the story... it differs.","But right now, di tori, e different." "Because according to Mr Kabiru Gaya, he says that, that it's true they had a talk on some bills under consideration, concerning, concerning the roads.","Because from wetin dey comot from di mouth of Oga Kabiru Gaya, im dey yarn sey, sey na true sey de sidon talk base on some kind bill wey de bin don dey judge, judge on top, on top of road matter." But that they did not say that the five... you and I will part with five naira.,"Sey but dem no yarn sey di five, five naira go comot for di hand of me, and you." So the next time you drive your car to the filling station for fuel... it's not like the five naira will come from you directly.,"So di next time wey you drive your motor to go sha mai for gidan mai, no be sey di five naira go comot directly from you." "The five naira tax is an arrangement that has been on ground, long before now.","Di five naira, na arrangy wey don dey ground e don tay." You and I were not aware of it.,"Me, and you just no know about am." You understand?,You understand? "So according to what should be, based on the arrangement of road fund bills which is being proposed, which the Committee has said, ""okay, you should th-... think about this issue, look into it, you understand, it's different from what the people heard.""","So according by di way wey di matter e suppose be, base on di arrangy of road fund bill wey de bin propose, wey di Commitee bin say okay make una re-... reason dis matter, mey una shook eye on top, you get e dey different from di tori wey reach country people side." You understand the main... the main thing is that people like us bring in the oil.,"You understand di main, main thing, na im be sey na di people wey dey carry di oil enter." "You know that we take it raw... crude, just as it comes from the ground.","You know sey we dey carry am raw, fresh as e comot for ground." "We do remove it, right?",We dey carry am comot abi? "Then they dust the body, clean it up, and bring it back following what me and you can buy.","Den we go come go dust all di body, clean am up ehn, con carry am come back base on wetin me, and you fit buy." You understand?,You understand? "Yes, it's not the crude that's being sold to us.",Ehen no be di crude na im de dey sell give us. The crude is exported and refined until it's ready for use.,"Meh carry di crude comot, polish am, dust am, cook am, dry am, do everything doable." "And yes, it has been brought back and it's being sold as petrol, they spe-... sell kerosine, diesel, gas and other products.","Ehen den con carry am come back, den con dey sell petrol, dey spe-... sell kerosine, dey sell diesel, gas, and all di rest like dat." "So what the Committee on Works proposed was that when the refined product is brought in, those who bring it in, those who sell it... so if the pump price in the filling station is one hundred and forty five naira... they're not trying to say that the pump price will move up from one forty five naira to one fifty naira.","So wetin di Commitee on Top of Works bin dey judge on top, na unto sey as de dey carry am enter, di people wey dey carry am enter, di people wey dey sell am, so if pump price for filling station na one fourty five naira, dem no dey try talk sey di pump price go move from one forty five naira, to one fifty naira." No!,No! "They're saying that from that one forty five naira, they will get the five naira they need for the proposed road fund.","De dey talk sey from dat one forty five naira, de go get di five naira wey de need for di arrangy of road fund." "Yes, you got it!",Ehen you too okay! "Now, the picture is clearer, right?",Now di picture don dey resemble each other abi? "Now to the point where the story went amiss, where things got confused.","Now make I tell you di point where di tori e miss, where everything turn di way wey e turn." You know that you know us by now.,You know sey you know us now. "It didn't start today, it's been on for a long time.",No be today e don tay. We're waiting for the one who will make the announcement so that we will take out our anger on them.,We dey wait for who go talk so dat we go para on top of im head. Do you understand?,You understand? "When the Senate Committee on Works was deliberating on the matter, an association heard about it and got upset.","When Senate Commitee on Top of Works bin dey judge on top of di matter, e come get gombody wey hear about di matter, wey come provoke for di level." "The name of the association is Conference of Nigerian Political Parties, also known as CNPP.","Di name of di gombody na Conference of Nigerian Political Parties, alias CNPP." "Then they said uh... they're here again, they've started again, let's make our voice heard!","Na dem come talk sey uhm de are here again, they have started again, let us shook mouth!" So they... zuga zugi zugi.,Naim de con zuga zugi zugi. Ka zuga for Africa!,Ka zuga for Africa! So they joined hands with the organized uh... labor congress.,Naim de con zuga gombodi of organised ehn labour people. They urged the people to join them in protest!,"Naim de come ginger dem say make una come, make una come!" "We've heard some fresh news, you know.",We don hear fresh one hm. That they want to raise the pump price by five naira.,"De say de wan add pump price money, de wan put five naira on top." So they also got upset.,Naim dose one too para. "Before we knew it, the Association of Students also joined in the protest saying please, please, please, the Labour Congress members are angry already.","Before we know wetin dey happen, gombodi of student too don dey para sey abeg, abeg, abeg labour people don dey vex." The students also expressed their anger.,Student too don dey para. "That was how the story got to us, kata giti kata.",Na so di story reach we side kata giti kata. "And so I also said, ""uh... they want to increase the pump price of fuel.""","Naim me too, I say eh de wan to add money to fuel price." "Alright now, let's get these things straight.","Alright now, make we get dese things straight." "Now, the association of the CNPP [Conference of Nigerian Political Parties] accused the Speaker of the National Assembly saying that the Senators don’t consider us before they take decisions.","Now, di gombodi of CNPP de dey drop accusate on top of di Head of National Assemble sey di people wey dey dere, de no dey reason us before de make any decide." "That they do nothing but play with their electronic gadgets like computers, phones and the like while making decisions.","Sey de go just dey where de dey, just press deir, all di pressable, di computer, di phones, di everything, and dey just decide." "That they don't really think about the masses, you know, and their welfare.","Sey de no dey really think about di common man, and you know wetin dey okay for us, and all di rest." "But from all these things I've told you, in order to clear the air concerning the news we heard on Friday... the initial story we heard on Friday is that uh... the Senate wants to raise the pump price... they want to raise it by five naira.","But from all dese gist wey I don give you, wey I don follow clear di tory wey we bin hear on Friday, di original tori wey we hear on Friday na sey ah Senate wan add to pump price, de wan add five naira." "But right now, this same Senate, through the repre-... their representative who is the Chairman of the Senate Committee for Works has spoken.","But right now, dese same Senate dey comot now through di repre-... dem representate wey be chamo on top of Senate Committee for Works." "Yes, Mr Gaya, he's saying no, it's not so!","Yes Oga Gaya, im dey yarn sey no, no be so!" "This bill, this arrangement, this road fund bill, and the like, had been on the ground.","Dis bill, dis arrangy, dis road fund, apala pala thing, e don dey ground." It's been a long time.,E don tay. But all the associations that ought to pay the said amount had not been paying.,"But di gombodies dem wey suppose dey pay am, de no dey pay." Do you now understand where the misunderstanding came from?,You understand where di misunderstanding come follow show now? "Uhuh, because since the refined products are being brought into the country, they're supposed uh... as they sell to us, we, the country people who buy kerosine, fuel, diesel, and the like... gas for cooking, and the like, those who drive cars, use generators... as they sell to us, they ought to pay the five naira from their proceeds.","Ehen because as de dey carry di oil come back inside country, de suppose eh as de dey sell give us, we, country people wey dey buy kerosine, fuel, diesel, and all di rest, gas, dey cook, and all di rest, dey drive motor, dey use generator, as de dey sell to us, from di money wey we dey pay dem, de suppose dey remit five, five naira." So the five naira on each litre has not been paid for a very long time.,"So dat five, five naira, e don dey hang since ninety epurutepu." Whose pockets does it go into?,Which person pocket now e dey enter? That's the next question I want to ask.,Na di next question wey me I wan even ask. "Please, if they know, let them tell us.","Abeg, if de know, meh de tell us." "So if that five naira per litre is not being paid, then, what happened to it?","So if dat five, five naira no dey show, wetin happen to our five, five naira?" Because the five naira is very important.,Because five naira is very important. "Last week, uh... on Saturday, I found a hundred naira note in my pocket while checking.","Last week ehn, okay on Saturday, I bin check my pocket, I see hundred naira." That hundred naira changed my life.,That hundred naira change my life. My life improved because of the hundred naira.,My life no remain di same after I see dat hundred naira. And how many five naira will you get from a hundred naira?,And how many five naira dey inside hundred naira? Just twenty.,Just twenty. "So, do you know how, how many five naira notes have been unaccounted for?","So you know how, how many five, five naira ehen na im don dey dey since one no know where e enter?" "That is for the EFCC [Economic and Financial Crimes Commission], and other agencies and the SS [State Security] officers.","Ehn dat one na for EFCC, and di, all di rest, and di SS people dere." You know we really love them.,"You know we love dem well, well." "Alright, back to the matter.",Alright back to di matter. "Based on the calculation on the ground, they said it would be as much as one hundred and sixty seven billion naira.","Now, base on di calculate wey don dey ground, de dey follow yarn sey akpalapala don reach like one hundred, and sixty seven billion naira." "Do you know how rich we would have been, if we had been doing a thrift contribution of five, five naira?","Dat five five naira o, dat five, five naira da muna adashi, had it been we dey do contribution (local contribution), do you know how rich we be now?" "Yes, for... yes!","Yes, for, yes!" Maybe my father would have started the contribution before I was born.,Maybe my pale go start di contribution before de born me. You understand?,You understand? Do you how much we would have gathered by now?,You know how much wey we go don get now? "So based on the above, I leave the matter for your consideration.","So base on dat level, now I don come drop di matter for your front." What do you think?,Wetin you feel? "The clever girl, who was smarter than the king.",Clever girl wey get sense pass di king. "There was this, uh...",Dere was dis eh... "The, this girl was in this village.","Di, dis girl dey dis village." "The father was proud of her for being clever, she is well read, she is clever.","Papa dey proud of her sey im pikin, e dey clever, im pikin know book, im dey clever." The father was proud of her.,Papa dey proud of her. "So, the king told him...",So di king con tell am... "Uh, so the king heard about it.",Eh king con dey hear am. "So he was, so he was hearing that the man...","Con dey, con dey hear di man sey..." "The man was was saying that the child was proud, the child was very wise.","Di man dey talk sey im pikin dey proud, pikin get sense well, well." The child was clever.,Sey pikin clever. So the king asked the man to come one day.,King con call di man come one day. "He told him, ""I hear you're saying that your child is clever. Ge-, get, she's got more sense than than anyone.""","Con tell am sey I dey hear you dey talk sey your pikin dey clever, ge-... get, e get sense pass everybody." "The man said, ""yes.""",Di man con talk say yes. He said she is very clever.,"Sey e clever well, well." "So the King said, ""okay, since you said your daughter is clever, take these eggs.""","Naim di king con talk sey okay since you say your daughter clever, carry dis egg." """The eggs, if no one breaks them with their hands, will they hatch by themselves?""","Shey egg, mey dem no use hand break, e go fit hatch by itself?" """Will a chicken hatch?""",Chicken go come outside? "They said, ""yes.""",De say yes. "Then he said, ""now, take them home to your child.""",Con talk sey oya carry am go give your pikin for house. """Tell your child that she should hatch these eggs. Let the chicks come out.""","Tell your pikin sey make e hatch dis egg, make di chicks come outside." "He said that if she cannot do it, if the child cannot do it, then, they will kill, they will beat the man to death.","E say if e no fit do am, if di pikin no fit do am, den, de go kill, de go beat di man till death." "So the man said, ""uhuh!""",Di man con talk sey ehen. So the man left.,Di man con go. "As he got home, he told the child, ""listen to what the King said.""","As e reach house, con tell pikin sey see wetin di king talk o." "He said, ""if you can't do it, they will beat me to death.""","E say if you no fit do am, sey de go beat me till death." "Then the girl told him, ""papa, don't worry. Go into the house. Go to sleep.""","Naim di girl con tell am sey papa, no worry, go inside house, go sleep." As...,As... """Go into the house. Go to sleep.""","Go inside house, go sleep." """Don't worry.""",No worry. """Tomorrow, you... I will give you the answer.""","Tomorrow, you, I go tell you your answer." "Papa then said, ""uhuh!""",Papa con talk sey ehen. So the father went to sleep.,Papa con go sleep. "Mor-... the next day, the girl told her father that he should carry this bag of beans, boiled beans, that they'd cooked.","Mor-... di next day, di girl con tell papa sey meh e carry dis bag of beans, boiled beans, di one wey de don cook." He should take it and hide it at someone's place.,Meh e carry am go hide for someone place. Let him shout.,Meh e dey shout. Let me dig this br-... let me... let me plant these beans.,"Meh I dig dis br-... make I, make I plant dis beans." Let them produce more.,Make e grow anoder one o. "These boiled beans, let me plant them.","Dis boiled beans, make I plant am." Let them produce more.,Meh e grow anoder one o. Then the King went to see him.,"Den di king go, go con see am." "The girl said ""okay.""",Di girl con talk sey okay. "So, as the man carried the beans out, he then went to meet-..., as he got to where the King goes to rest, when he saw the king coming, he said ""If I plant these boiled beans, they'll produce even more.""","So as di man con carry di beans comot con go meet, con go di place where di king for dey rest, as e just see di king just dey come, e con talk sey if I plant dis boiled beans, make e give me anoder one o." """If I plant these boiled beans, they'll give me even more.""","If I plant dis boiled beans, make e give me anoder one o." So the king saw him.,Naim di king con see am. "So he said to him, ""how do you...?""",Con talk sey how you?.. """Are you out of your mind?""",You get sense? """How can you say let... how can you think that these cooked beans will produce some more?""",How you take say ma-... how you take tink sey make dis beans wey de don cook take grow anoder one wey e never cook? "He said... so he said, ""since the eggs which have already been boiled will hatch chicks, the beans that have already been cooked will be able to, uh... will be able to produce more.""","E say, e con talk sey since di egg wey de don ready boil go fit hatch chick come outside, e go fit hatch chick come outside, den beans wey de don cook go fit, ah e go fit grow anoder one come outside." Then the King looked at the man's face closely.,"Naim di king con look di man face well, well." "Then he said, ""this is the man who was given that egg.""",Con talk say dis man sey na im give dat egg. "So he said ""indeed, the child is clever.""","Con talk sey indeed, di pikin dey clever." "Then he said ""okay.""",Con talk sey okay o. Then he took the...,Con carry di... Then he said...,E con say... Okay. Then he took the man to the pala-... uh... palace.,Okay con carry di man go pala-... eh palace. "The man, he then told the man that he should take uh... this thing... pots, a lot of pots.","Di man, e con tell di man sey meh di man carry ehm dis ting, pot, many pot." He said he should take them to his house.,Sey meh he carry am go house. He said not to have her fetch water with them.,"Sey meh pikin no go river o, meh pikin no go fetch water, sey meh e no fetch water put." But have f-... the man fetch water with the pots and bring it to him.,But meh f-... di man fetch water put for inside di pot come. But the girl should not go to the river and carry them.,"But meh de no, make di girl no go river carry am." "He said if he cannot do it, they will beat him.","E say if e no fit do am, sey de go beat di man." He will die.,Di man go die. The man got home.,Di man con reach house. "So he told the child ""this what the King said.""",Di man con tell pikin sey see wetin di king talk eh! "So the child told him, ""go inside. Go to sleep. Get some rest.""","Pikin con tell am sey go inside house, go sleep, meh you rest!" """Don't worry.""",No worry! """Tomorrow, I will give you the answer.""","Tomorrow, I will give you answer." "He then said ""okay.""",Con talk sey okay. "The next day, as the gm-, the man wanted to go to the palace, the child told him, ""this pot that the king gave you, tell him it's leaking.""","Di next day, as di gm-... di man wan go palace, di pikin con tell am sey dis pot wey di king give you so, tell am sey e dey leak." """The pot has a hole in the bottom.""",Di pot get hole for under. """Tell him that it's leaking.""",Tell am sey e dey leak. """Take it and bring it back to the...""",Take carry am go back to di... """Go and tell the King.""",Meh you go tell di king like dat. So he went to tell the King.,E con go tell di king. "So the King said, ""ah! This daughter of yours is very wise.""","Di king con talk sey ah dis your pikin wise well, well o." "Then he said, ""your daughter's the one I'll marry.""",Con talk sey na your pikin I go marry. "He then said ""is that so?""",Con talk sey ehen. "Then he said, okay, let him go to the house to tell the child what the King said.","Con say okay meh e go house, go tell pikin wetin di king talk." "As he got home, he went and told the child, ""listen to what the King said. ""","As e reach house, con go tell pikin sey see wetin di king talk o." "He said, ""it's you he's going to marry.""",E say na you e go marry. The girl didn't want to be... marry him.,"Di girl no wan be, marry am." "She then said, ""ah! Let me marry him."" Then she'll be the queen of the land.","Con talk sey ah make I marry am, den e go be di queen of di land." "Then he said, ""okay.""",Con talk sey okay. "As the girl got to the palace, she told the king that if she, maybe if she does something the king does not like in the palace, if the king sends her away, she will take what is special to her in the palace.","As di girl reach palace, con tell di king sey if e maybe, if e do wetin di king no like for di palace, if di king con pursue am, e go carry wetin dey special to am for di palace." "The king then said okay, he understood.",Di king con talk sey okay sey e hear. So then he married the girl.,So e con marry di girl. Then they got married.,De con do marriage. Then he married the girl.,E con marry di girl. "So the king started buying her all these fine clothes, jewelry.","So di king con dey buy her all dis fine, fine clothes, jewelries." The girl started wearing them.,Di girl con dey wear am. "Every day, she would take almost an hour to put on her makeup and get dressed.","Everyday, e go dey use almost an hour take dey make up, take dey wear clothes." So the King got angry.,So di king con vex. "One day, when they wanted to travel, the girl started putting on her clothes and makeup.","When de wan travel one day, di girl con dey make up, con dey wear cloth." So the King got angry.,Di king con vex. "Then he told her, ""you don't even have time for your husband.""",Con tell am sey you no even get time for your husband. """All you really have time for is jewelry and all the things I'm buying you.""","Na so, so eh jewelries, and everyting I dey buy for you na im dey get time for." So the girl told him he shouldn't be angry.,Di girl con tell am sey make e no vex. "Then he said he would stay married to the girl, and she should pack her things.","E con talk sey e no go marry di girl again, sey meh di girl pack im tings." The girl should go now.,"Meh di girl dey go now, now, now." She said she's not going anywhere.,Sey im no dey go any place again. He said she should go to her father's house.,Sey meh di girl dey go im papa house. Then the girl said okay.,Naim di girl con talk sey okay o. "That... she told the man that anything that she is... that is close to her... anything that is precious to her, is... I will take with me.","Sey e tell di man sey anyting mey dey, mey dey close to her, anyting mey dey precious to her, na I go carry comot o." "The man said, 'uhuh! Let her take it. Let her get going.""","Di man say ehn meh e carry am, meh e dey go." "The girl then said okay, please let her spend just this one night in his house. She said the next day, she will go.","Di girl con talk sey okay sey abeg make e just spend only dis one night for im house, sey di next day, e go go." The King then said okay.,Di king con talk sey okay. "So the next day, in the night, the girl put some sleeping pills in the King's drink.","So di next day when in di night of it, di girl con put sleeping medicine for di king drink." The King drank it.,Di king con drink am. Then he went to sleep.,E con sleep. "While he was sleeping, she told his body guards that they should carry him to her father's house. She said he should carry him to her father's house.","As e sleep, e con tell im bodyguard sey make di bodyguards carry am go im papa house, sey make e carry am go im papa house." So the body guards carried him to her father's house.,Di bodyguards con carry am go im papa house. Then the girl went to meet him.,Di girl con go meet am. "The next morning, as the man woke up, he found himself somewhere else.","Di next morning, as di man wake up, con see himsef for anoder place." "Then he asked, ""ah! Where are my... where is my palace? Where are my guards? Everybody?""","Con ask sey ah where are my, where is my palace, where are my guards, everybody?" "Then the girl said, ""didn't you say I should go to my hub-... my husband, my father's house?""","Naim di girl con tell am sey shey you say make I go my hub-... my husband, my papa house?" """So I went to my father's house.""",So I go my papa house. """I told you that anything that is precious to me, I will take with me.""","I dey tell you sey anyting wey dey precious to me, na im I go carry." "So, then she said, ""so it's you who is precious to me. You're the one who made me bring you here.""","So e con talk sey so na you dey precious to me, so you make me carry you come here." "So the king said, ""wow!""",Di king con talk sey wow. "He said, ""you indeed, you are a very... a cl-... you are cle-... you are a clever girl.""","See you indeed, you are a very, a c-... you are cle-... you are a clever girl." "He then said, ""thank you.""",Con talk sey tank you. Thank God for today!,We tank God for today o. My name is Titi Ade.,My name na Titi Ade. I uh... I married...,I ehn I marry... "Some years ago, I married a soldier.","Some years ago, I marry to soldier man." I live in the barracks.,I'm living in di barracks. We lived in the northern part of Nigeria before.,We don live for northern part of Nigeria before. "We lived in Jos, we lived in Bauchi.","We live for Jos, we live for Bauchi." "From Bauchi to Jos, from Jos to Lagos.","From Bauchi to Jos, from Jos to Lagos." "As we left Lagos, we came to Ibadan.","As we leave dem Lagos, we come Ibadan." I am...,I dey... "My church which I'm going to is Mountain of Fire and Miracle Ministry, South West Two, Ojoo.","My church wey I dey go na Mountain of Fire and Miracle Ministry, South West two, Ojo." "Everything happening in Nigeria, everything is in God's hands.","Everyting wey dey happen for Nigeria, everyting dey God hand o." Let's just leave everything to God.,Make we just leave everyting for God. "Because like our soldiers, they have killed a lot of them.","Because like our soldiers, de don kill many of dem." "Many of the women... many women in the barracks now, they are widows.","Many of di women, many women in di barracks now, de are widows." They don’t have of... husbands.,"De don't have of, husbands." "Some of them, they are very young, some with one child, some with two children, and so on like that.","Some of dem, de are very young, some wit one child, some with two children, and so on like dat." And we are still praying.,And we still dey for prayer. "May God just help us with the problem of Boko Haram which is killing our soldiers, and some innocent uh... people.","Make God just help us for di problem of di Boko Haram wey dey kill our soldiers, and some innocent eh people." We are still praying.,Na di prayer we still dey o. May God just help us.,Meh God just help us. The Boko Haram problem is here.,Di Boko Haram problem dey dere. We are... we...,We dey we... Before that... uh... before the food shortages came again; children... there's no money to go to school.,"Before dat, ehn before di scarcity of food con join again, children, no money to go school." "No school fees, no food.","No school fees, no food." We're just managing things.,We just dey manage life. "The things we bought last week, if you want to buy them today, you will buy it...","Di ting wey we buy last week, if you wan buy am today, you go buy am..." "We, we, we...","We, we, we..." "If you bought it last week for two hundred naira, like today, if you want to buy it, they will say it is five hundred.","If you buy am last week two hundred naira, like today, if you wan buy, dem go say na five hundred." What are we in for?,Which one we dey inside? "So it's only God, he's the one who will help us.",So na only God na im go just help us. "Let's keep praying, and let's pray for our president.","Make we continue to dey pray, and make we pray for our president." May he... may he be well.,"Make e, make im dey well." May he remain in good health.,Make im bodi well. Because they said he is... he is sick now.,"Because de say e dey, e dey sick now." We don’t know his condition.,We no know di condition. May God let him get well again so that everything will go well for Nigeria.,Make God let am come back well so dat everyting go go on well for Nigeria. So we thank God for everything.,So we tank God for everyting sha. We thank God.,We tank God. "Because this nation we're in, if someone rules it today, we'll say he is the best.","Because dis nation wey we dey inside, if some go rule am today, we go say na dat one better." "If another one comes in and we're happy he's come to power, we will be complaining.","If anoder one enter wey we dey happy sey dat one don enter, we go dey complain." "You will not bring up another sy-... uh... another... his own system which will make Nigeria... which, which will make everything harder for the people of Nigeria.","You no go carry anoder sy-... ehn anoder, im own system come wey go make Nigeria, wey, wey make everyting go hard for people for Nigeria." So may God just help us.,So make God just help us. Because everything... we don’t know where we are going in Nigeria.,"Because everyting, we no know where we dey go for Nigeria." We just don’t know.,We no just know. Look at the children now.,See di children now. "They go to school, we borrow money from cooperatives!","Dem go school, we go collect money, cooperative o." "We struggle, send the children mo-... uh... to school, they come back from... they graduate from university, but no employment.","We go struggle, send children mo-... ehn school, dem go come back from, dem go pass out for university, no work." "Nothing, nothing.","Noting, noting." What are we in for?,Which one we dey? "What do we, as Nigerians, want to do now?",Which one we wan do for Nigeria now? No good jobs.,No better work. Uh... no drugs in our hospitals.,"Eh our hospitals, no drug." "If you go to the hospitals now, when you are sick, you go to the hospital, the most effective drug on the list, is the one that will be... is the one that will be the most expensive.","If you go hospital now, wey you sick, you go hospital, di better medicine dere, na im go, na im go cost pass." "They will say, you should o-... no... go and buy it.","Dem go say make you o, no go buy am." "Tomorrow, they'll say they're on strike.","Tomorrow, dem fit say dem dey strike." "Uh... doctors, they're not working.","Eh doctors, de no work." Sick people are in beds.,Sick people dey bed. "No drugs, no treatment.","No medicine, no treatment." Another death will happen again.,Anoder death go join again. So may God just help us.,So make only God just help us. Everything is fucked.,Everyting don dabaru. Nigeria is fucked.,E don dabaru for Nigeria. It's fucked.,E don dabaru. I just pity the new born children that we're giving birth to now.,"I just dey pity for di new, new born children now wey we dey born." Because we don’t understand their future.,"Because deir tomorrow, we never understand." "It's only God, he's the one who'll help us.",Na only God na im go just help us. "This dish, the dish I want to teach you all how to cook, is egusi.","Dis soup, di soup wey I wan teach una how to cook, na egusi soup." "The way to cook egusi is to take out your egusi seeds, and grind them.","How dey take dey cook egusi soup be sey you go bring out your egusi, you go grind am." Mstchew.,Mtschew! "If you finish grinding, you can use...","If you grind am finish, you fit use..." "Some use a grinding stone to grind it, some use me- uh... a grinding machine to grind it, some use a blender to grind it.","Some dey use grinding stone grind am, some dey use me-... eh grinding machine grind am, some dey use blender dey grind am." "However you do it, the esugi is smooth.","Anyone wey you provided, di egusi smooth." "When it is smooth... it has turned to powder, you put it into a bowl, you put it into a plastic bowl.","If e don smooth, don turn powder, you turn am put inside bowl, you put am inside rubber." You put it into a plastic bowl.,You turn am put inside rubber. "Once you've put it in the plastic bowl, you add a little water, you stir it.","When you don put am inside di rubber, you add small water, you turn am." You can add chilli peppers.,You fit put pepper inside. "Once you've added your peppers, slice your onions and put them inside.","You put pepper inside, slice your onions put inside." Some like to fry it while others don't.,Some of dem dey like to fry am while some people no dey like. "Some like to fry it, others don't.","Some dey like to fry, some no dey like to fry am." But I want to tell you the one that th-... you...,"But I wan tell you di one wey de, you..." Uh... it is the fried one I want to tell you about now.,Ehn na di frying aspect own na im I wan tell you so. "For the fried version, as you put it into the bowl, you turn it and that's it.","Di frying aspect be sey as you put am inside bowl, you turn am finish." You put the uh... onions inside the ma-... uh... inside the egusi.,You put di eh onions inside di ma-... eh inside di egusi. "You turn, eh you..., you put the..., uh... sliced onions into it.","You turn, eh you, you put di, eh slice onions put." You stir it well.,You stir am finish. "Once you have finished stirring it, you put it into the hot oil.","After you don stir am finish, you turn am put inside di hot oil." But you don't wait for the oil to bleach before you put everything inside.,But you no go wait meh di oil bleach before you turn everything put. "When you have finished putting it inside, inside the ho-, uh... hot oil, you then keep stirring it so that it will not burn.","When you don turn am inside, put inside di ho-... eh hot oil, you con still dey turn am so that e no go burn." You keep stirring it until uh... the egusi has changed colour.,"You go still dey turn am, dey turn until eh egusi don change colour." "Once it has changed colour inside that pot, it has changed colour a little, you see the cu-... the co-... uh... difference in colour, then, you add water.","Once e don change colour inside dat pot, e don change colour small, you don see di cu-... di co-... eh difference in colour finish, den, you go con add water." "If it's meat stock, if it's meat stock, you add... you pour it inside.","If na meat water, if na meat water, you add, you pour am inside." "Once you've poured the meat stock inside the, the... inside the dish, you stir it a little.","Once you don pour di meat water inside di, di, inside di soup, you go con turn am small." Leave it to boil.,Leave am make e boil. "But before it boils, you have put all your maggi, your salt, your crayfish.","But before e go boil, you go don put all your maggi, your salt, your crayfish." "If it's locust bean cake you have, you stir it into the dish.","If na dawadawa you get, you turn am put." "Once you have finished putting it in, and it has finished boiling, then you add your meat.","Once you don put am finish, e don boil finish, den you put your meat." "If the meat is not soft yet, you add it when you put all your ingredients so that everything boils together.","If di meat never soft, you put am dat period wey be sey you dey put all your ingredients so dat everyting go boil together." "Once everything has boiled together, everything has finished boiling, then you add...","Once everything don boil together, everything don boil finish, before you go con add." "If it's bitter leaf that you have, that you want to put inside, you add it; if it's pumpkin leaf that you want to put inside, add it.","If na bitter leaf you get o, you wan put inside, you put, if na pumpkin leaf you wan put inside, you put inside." "Then, add salt.","Den, you put salt." Then leave it to boil.,Den you leave am make e boil. "If it has boiled very well, it has boiled very very well, as you see that it has boiled very very well, taste it.","If e don boil well, e don boil well, well, as you see am say e dey boil well, well, you taste am." "If the taste st-... if the taste ni-... it doesn't taste how you want, add more again.","If di taste st-... if di taste ni, e no meet up to di taste wey you want, you still add." "If it's the salt that is not sufficient yet, add a little more salt.","If na salt never dey am, you add small salt join am." "Then when it has finished boiling, bring it down.","Den when e don boil finish, you bring am down." "If it's garri you wanna have with it, uh... that you want to eat it with, use garri.","If na garri you wan use eat, eh you wan use take am, use garri." "If uh... It's eba, use eba.","If eh dat's eba, you use eba." "If it's mashed yam that you want to use, use mashed yam.","If na pounded yam you wan use, you use pounded yam." "If it's semo, use semo, or amala.","If na semo, you use semo, or amala." "Any one, any food you want to eat it with, it's... you can use it to eat it.","Anyone, any food wey you wan use eat am, na you fit use am eat." "The dish that I like to cook, is, it's banga.","Di soup wey I like to cook, na im be banga soup." Because banga is natural oil.,Because banga na natural oil. That's what banga is.,Na im dey banga. "To cook a dish of banga, you need to extract the oil and keep it.","To cook banga soup, you go fit remove oil keep for inside." "If you want to use the oil, you can use it.","If you wan use di oil, go let you use!" And banga is a dish that's good for the body.,And banga na soup wey be sey e good for body. "Even our doctors nowadays, they are encouraging us to cook it.","Even our doctors nowadays, dem dey encourage us make we dey cook am." "So, I will teach you how to cook banga.",So I go teach una di method to take cook di banga. "One you have b-, bought your banga at the market, make sure that you wash it very well.","Once you don b-... buy your banga for market, make sure sey you wash am very well." Or maybe it's from your backyard you pick it.,Or maybe na your backyard you for cut am. Make sure that you wash it very well.,Make sure sey you wash am very well. Put it into a pot.,You put am for pot. It's done...,E done. "If the banga is done, you will smell the aroma that tells you it's done.","If di banga don done, you self go dey hear di aroma sey di thing don done." "Once it is done, after twenty or twenty five minutes, you remove it.","Once e don done, for twenty, or twenty five minutes, you go remove am." You pound it in a mortar.,You go pound am for mortar. "When you pound it in a mortar, make sure that all the husk, the edges, eh the back shell which you have pounded, is all smooth.","When you pound am for mortar, you go make sure sey all di kanda, di edge, eh di back shell wey you pound, all smooth." "Because if it's not smooth, the oil doesn't come out very well.","Because if e no smooth, di oil no go come out very well." "Once it's done, after twenty or twenty five minutes, you remove it.","But if e smooth, you go fit get your oil, and di flavour wey you dey find for inside." "So once you've pounded it very well in a mortar, then you filter it with hot water.","So once you don pound am very well for mortar, den you go filter am with hot water." "Some, they say they don’t want it to be too watery.","Some, de go say de no want make di thing too dey watery." "But by the time you have used enough water to filter it well, that is when the thing comes out well.","But by di time wey you go use enough water take filter am well, na im di thing go come out well." Ehen!,Ehen! But banga really takes uh... time to cook!,Dough banga soup dey take eh time o. "Now if you're using firewood, you see that yes, it is quick.","If na fire wood now, you go know sey yes e go quick." The dish gets thick fast.,Di soup go quick thick. "But if it's a gas cooker, if it's a stove, be ready to use enough gas, and enough kerosene.","But if na gas, if na stove, go ready to use enough gas, and enough kerosine." But that doesn’t mean anything.,But dat one no mean. "To get the typical result, it... that's what matters.","For us to arrive at our normal result, na, na im make am." "Because if you don’t use hot water to rinse it well, the banga will still stick to the kernel, and that is, is a waste.","Because if you no use hot water take rinse am well, di banga go still follow di kernel comot, and dat one na, na waste." So you need to use hot water to wash it well.,So you need to use hot water take wash am well. You should take your time.,You go take your time. "So if it's meat you want to cook it with, if it's fresh fish, if it's... if it's ponmo, it is good because even before the ponmo is cooked the preparation will have thickened.","So if na meat you wan use take cook am, if na fresh fish, if na, if na ponmo, e go even good because before ponmo go even done for fire, di soup go don thick." "But if it's meat, it's still good.","But if na meat, e still good." "If it's fresh fish, make sure that the ban-... the soup has thickened up a little before you add your fresh fish.","If na fresh fish, you go know sey di ban-... di soup go don thick small before you put your fresh fish." We know that our fresh fish is... it's not tough.,"Shey we know sey our fresh fish na, e no get power." "In less than five or ten minutes, it is done.","Under five, or ten minutes, e don done." "So any of those uh... uh... meats we want to use, we use them.","So anyone wey we wan use inside all dis eh eh meat, we go use am." Use them to... use them to cook the dish so it's thick.,"Take do, eh take cook di soup so dat di thing go dey thick." "Then if it's starch you want to eat it with, if it's semo... but banga, starch is what goes well with it, so it tastes good.","Den if na starch you wan take eat am o if na semo o but according to banga soup sha, na starch na im go wit am so dat e go dey well." Some say they don’t like starch.,Some go say de no like starch. The way they stir it like it's... it's liquid.,"Di way dem dey turn am wey be sey e dey, e dey draw." "But me, I want to tell you that if you stir that starch, if you add salt, if you put it on the plate, it will be very very easy to serve.","But me, I wan tell una sey if una dey turn dat starch, if una put salt, if you dey cut am for plate, e go dey very, very easy to cut." "Now those who say they don't eat salt, (it doesn’t mean that you don’t eat salt, but at least, if it's only a pinch of salt, you put some inside) turn the starch with it so that you can eat.","Now those wey be sey dem go say dem no dey eat salt (e no mean sey you no dey eat salt, but at least, if na pinch of salt, you go put am inside) take turn di starch so dat e go let you eat." "There was this woman, she had three boys.","E get dis woman, e get three boys." "So, she cooked porridge.",So e con cook porridge. Then she asked them if they'd eat it.,She con ask whether dem go eat. They said no.,De say no. Then she left and went to the market.,"Con comot, con go market." "As she came back, the last born had already gone and eaten everything.","As e come back, di last born don already go dere, don go eat everyting." Then he put plenty of sand and water.,"Con put sandsand, con put water." "The woman came back and asked them, ""who ate the food?""","Di woman con come back, con ask dem who eat di food?" "Then they said it wasn't them, it wasn't them.","Dem con say no be dem, no be dem." "Then he told her that it was the last born, he was the one who went to the kitchen and he forgot his cap.",E con tell am sey but na di last born na im come kitchen say e forget e cap. "Then she said, ""let's go swim in the river.""","Con den say am meh de go river, go swim." "When they got there, the first one sang, ""if I'm the one who ate this food, if I'm the one who ate this food, Kpangolo must swallow me, the fish must swallow me.""","When de con reach there, di first one con sing if na me eat dis food, if na me eat dis food, Kpangolo must to swallow me, fish must to swallow me." Ehen.,Ehen. "Then he crossed, nothing swallowed him.","Naim con cross, noting swallow." The second one.,Di second one. """If I'm the one who ate this food, if I'm the one who ate this food, Kpangolo must swallow me, the fish must swallow me.""","If na me eat dis food, if na me eat dis food, Kpangolo must to swallow me, fish must to swallow me." "Ehn, nothing.",Ehn nothing. Then it was the last one's turn.,E con reach di last one. "He sang, ""if I'm the one, who ate this...""",E con sing if na me eat dis... """Speak up!""",Talk loud! """If I'm the one who ate this food, if I'm...""","If na me eat dis food, if na..." """Speak up, let them hear you!""","Talk loud, make de hear you!" """If I'm the one who ate this soup, Kpangolo must swallow me, the fish...""","If na me eat dis soup, Kpangolo must to swallow me, fish..." He didn’t even finish singing.,E never even sing am finish. A fish just swallowed him like that.,Na so fish just swallow am. "This woman, she had three children.","Dis woman, e get three children." "So, she cooked porridge.",So e con cook porridge. Then she asked them if they'd eat it.,E con ask dem sey eida dem go eat. They said no.,De say no sey dem no eat. "So she said ""I want to go to the market"" and then she went to the market.","So as she con talk sey I wan go market, she con go market." "Before she came back, the last born had already gone into the kitchen and eaten the food.","Before e come back, di last born don already enter kitchen, don go eat di food." "So the mother asked, ""who ate this food?""",So Mama con ask who eat dis food? "Then they said it wasn't them, it wasn't them.","De say no be dem, no be dem." "Then, their mother said, ""let's go swim in the river.""","Deir mama con talk sey oya moh we go river, go swim." "Then they went to the river, and they swam.","Con go river, de con swim." "Then the first child sang ""if I'm the one who ate this food, if I'm the one who ate this food, Kpangolo must swallow me, the fish must swallow me.""","Di first born con sing if na me eat dis food, if na me eat dis food, Kpangolo must to swallow me, fish must to swallow me." Ehen!,Ehen! "Ehen, he crossed the river.",Ehen e con cross di river. Nothing swallowed him.,Noting swallow am. The second child.,Second born. """If I'm the one who ate this food, if I'm the one who ate this food, Kpangolo must swallow me, the fish must swallow me.""","If na me eat dis food, if na me eat dis food, Kpangolo must to swallow me, fish must to swallow me." He crossed like that.,Naim e con cross. Nothing.,Noting. "Then, it was the last one's turn.",E con reach di last born. """If I'm the one who ate this food, if I'm the one who ate this food, Kpangolo...""","If na me eat dis food, if na me eat dis food, Kpangolo..." """Speak up, we can't hear you.""","Talk loud, we no dey hear you." """If I'm the one who ate this food, if...""","If na me eat dis food, if..." """Speak up!""",Talk loud! """If I'm the one who ate this food, if I'm the one who ate this food, Kpangolo must swallow me, the fish must swallow me.""","If na me eat dis food, if na me eat dis food, Kpangolo must to swallow me, fish must to swallow me." He didn't even finish singing.,E never even sing am finish. A fish just came out like that and swallowed him.,"Na so fish just come outside, fish con swallow." "Babe, how are you?","Babe, how far?" I'm fine.,I dey o. How are you?,How far? I'm not great.,I no dey o. I won't lie to you.,Mah I no lie you. What happened to you?,Wetin do you now? "It's, it's about that thing I've been telling you since first year.",Na un-... na unto dat tin wey I don dey follow you talk since hundred level. "First year has passed, second year has passed and third year has passed.","Hundred level don pass, two hundred pass, three hundred pass." "So, you can't pity someone?",Shey you no fit pity person? That...,Wey... I have told you.,I don tell you now. "You, you don't listen.","You dis guy, you no dey hear word." I've told you that I am not interested in all those problems that you are talking about.,I don tell you sey I no dey interested in all dose wahala wey you dey talk. I didn't talk... I didn't talk about problems.,"I no talk, I no talk about wahala now." It's a problem for me.,Na wahala for me now. I'm not interested at all.,I no dey interested at all. It's a big problem for me.,Na big palaver for me. "No, no.","No, no." It's love I am talking about.,Na love I dey talk. It's love.,Na love. Something very interesting.,Very interesting something. "Uhuh, is it very interesting?",Ehen e dey very interesting? You understand? You understand?,"Shey you understand, shey you understand?" "In first year, you've read books, read books in second year and in third year, you read.","For hundred level, person don jack for book, jack for book for two hundred, three hundred level, jack." "In fourth year, it's not books I want to take home to meet my mom.","For four hundred, no be book I wan carry go house go meet my mama now." "Uhuh, Shully!",Ehn Shully! "You, I have known you in this campus for a long time.","You, I know you for dis campus tay, tay." I see different girls in your room.,I dey see different girls for your room. Say what?,Say wetin? "So don't just come and tell me that you are interested in me because I know that you want to play, play around.","So no come just tell me sey you dey interested in me because me, I know sey na play you wan play." Ah!,Aha! Babe!,Babe! Mtchew!,Mtschew! You're not ready to settle down.,You no ready to settle down. Tah!,Tah! "For me, I'm not ready to play games.","To me ma, I no ready to do falla follow." No.,No! Oh yeah?,Shebi? "So, leave me on my own.",So make you just leave me for my own. Babe!,Babe! "Babe, forget it!","Babe, forget!" No problem at all.,"No shinkpin, shinkpin." "What I'm talking to you about is that those people you are seeing in my room, they came for tutoring.","Wetin I dey follow you yarn, dose people wey you dey see for my room, na tutorial de come do." Tutoring?,Tutorial? "It's tutoring, it's tutoring.","Na tutorial now, na tutorial." "Ah, you know the kind of person that is in the department.",Ah you sabi di kind person wey person be for department now. "It's almighty, you know!",Na almighty you know. Playful person.,"Play, play person." "So, people feel they're approchable.",So people dey feel sey person dey approachable. "So, they have to meet someone and go, okay guy, come and explain something.","So de gats you know just meet person say oya guy, come explain something now." "So, all those girls you have been seeing, came for tutoring.","So all those girls wey you dey see, na tutorial." "Eh, just forget it.",Eh just forget am! It's tutoring.,Na tutorial. "Okay, I've heard you but I know one girl that's in our department that I know you and her are are very close and not just close as friends.","Okay I hear you, but I know one girl wey dey for our department, wey be sey I know sey you, and her, una dey very close, and no be sey, just close as friends." The two of you are dating.,Two of una dey date. You're in a very serious relationship.,Una dey into very serious relationship. "I, I don't want someone to beat me up.","Me, I no wan make person come beat me o." "Please, I cannot fight.","Abeg, I no fit fight o." Let me... let me...,"Mah, mah..." "Please, I don't want trouble.",So abeg I no wan wahala. Let me clarify that.,Mah I tell you dat one. "That's a lie, that's a lie.","Dat one sef, na lie, dat one, na lie." "It's people who don't want me, me to have you, they're the ones spreading that kind of rumor.","Na people wey be sey de no wan mah, mah I catch you na dem dey go spread dat kind rumour." Forget it!,Forget. "That girl uh... it was when she got into the school that her dad brought her to me in my house and said that, okay, this child, ehe, you have to help me take care of her and that the girl does not know anything.","Dat girl ehn, na since she gain admission im papa con carry am meet me for house say okay o dis pikin o, ehen you gats help me take care of am o, sey di girl no too sabi anyting." "So, I should be teaching her, teaching her, teaching her, teaching her.","So mah I dey teach am, teach am, teach am, teach am." That's why you've been always seeing us together.,Na why you dey see us together always now. "So, then people started seeing us together and started thinking that uhuh, uhuh... they're dating and they're up to something.","So people con dey see us together, con dey think sey ehn ehn dem dey date, de dey do something o." It's a lie!,Na lie! It's a serious lie.,Na lie seriously. I've said it.,I don tell. "Even my mom was asking me once, ""Adams, uhuh... where is your girlfriend?""","Even my male dey ask me one time sey oya o Adams, ehen where your babe o." "I'm telling her, ah this babe has not accepted me.",I dey tell am sey ah dis babe never gree for me o. "Mom, it seems like I'll have to take you to school to help me woo her.","Male, e be like sey I go carry you go school go help me beg am o." Serious!,Serious now! I've told her your name.,I don tell am your name now. "Uh... I've heard you but another problem is that you, you're a Muslim and me, I'm a Christian.","Ehn I hear you, but another wahala be sey you now, you be Muslim now, me, I be Christian." Uhuh!,Ehn. "So, I cannot befriend someone who is a Muslim.",So I no fit date someone wey be Muslim. "U, if you say...",Ehn if you talk... "So, that's another problem too.",So dat one na another wahala again. "So, what are you gonna do?",So wetin you wan come do? If you say that ah...,If you talk sey ah... "Aha, that's a serious issue, but no problem because I love you.","Ah dat one, na serious gbege o, but no p unto sey I love you ehn." I love you.,I love you now. What can't be solved?,Wetin person no go fit do? Uhuh?,Ehn? "Look, our children, we will divide them.","See our pikin, we go divide dem." "Some will go to mosque, some will go to church.","Some go dey go mosque, some go dey go church." "That one, it's, it's, it's a peaceful thing.","Dat one, na, na, na peace someting be dat." "That's not a problem, that's not a problem.","Dat one no be case, dat one no be case." That's how we will settle it.,Na so we go settle am. "But, you're a big man now.",But you be alfa now. "Isn't it true that if I marry you now, you will put me in a hijab?","No be sey I go come marry you now, you go come turn me to eleha?" No!,No! Aha!,Aha! "No, no, no.","No, no, no." "Aha, no, no.","Aha no, no." "I won't do that, ah...",I no go do ah. You know I love you.,You know sey I love you now. "Let's forget about... let's forget about that... uhuh, let's forget about that.","Let us forget about, moh forget dat one, ehn moh forget about dat one." "Uh... the thing is that I love you, and whatever you want, that's what I'll do.","Ehn di tin be sey I love you, and anytin wey you want, na im I go do." "Alright, I hear you, but my mom and dad, they won't agree.","Toh I hear you, but my papa, and mama, de no go gree." "They'd kill me if they heard that's, that's the kind of person I'm dating.","De go kill me if dem hear sey na, na dis kind person I dey date." Uhuh!,Ehn! Mstchew.,Mstchew. Mstchew.,Mtschew. "Look, what you'll do is lie to them and say I'm a Christian.",See wetin you go do be sey you go lie give dem mtchew sey I be christian. You'll lie?,You go lie? Yes now.,Ehen now. They won't know.,De no go know now. I'll hide this from my family.,I go cut dis one reach house. "When we've gotten married, they can't take you away.","If we marry finish, dem no go fit carry you commot." It's a serious thing.,Na serious tin now. You want me to lie to my mom and dad?,"Ah you wan make I lie for my papa, and mama?" "Not that it's a lie like that, you know.",No be sey lie like dat you know. There are some kinds of things that you will do for... to please your heart.,"E get some kind tins wey be sey you go do for, to please your heart." Okay.,Okay. You understand?,Shey you understand? Ehe!,Ehen! "Okay, you say that but another problem is that I have a boyfriend.","Okay you see dat one talk, but anoda wahala be sey I get boyfriend." Gaaya!,Gaaaya! Uhuh!,Ehen! I have a boyfriend.,I get boyfriend. You even said that it's been since first year that you've been wooing me.,You ma talk sey na since hundred level you don dey pursue me. "And me, I wasn't interested, I didnt know you were serious like this.","And me, I no dey interested, I no know sey you serious like dis." Why now?,Why now? I have someone that I'm dating.,"Me ma get someone wey I dey, I dey follow." Why now?,Why now? Is the guy as handsome as me?,Di guy fine reach me? "Aha, the guy is as handsome as you, much more even.",Aha di guy fine reach you die. Does he have money?,E get money? Ah.,Ah. Of course.,Of course now. The guy has... he has plenty of money.,"Di guy get, e get money plenty." But the guy...,But di guy... Let me tell you a fact.,Mah I tell you fact. "I went to see a pastor because as I'm here, I don't... I don't discriminate.","I go see one pastor because as I dey so, I no dey, I no dey discriminate." Forget it!,Forgeti. I'm someone who's open-minded.,I be person wey be sey I get free mind. "If I see a Christain, if I see a Babalawo, I will talk to him.","If I see christian, if I see babalawo, I go follow am word." We will talk normally.,"We go relate like normal, normal." "Then the pastor told me that ah, there's a girl in my department, that heaven brought us together and that ah, they're husband and...","Pastor con tell me sey ah ehn e get one babe for my department o, sey na from heaven de don tie us together, sey ah dem be husband and..." Then I said hey...,I con talk sey hey... "Ah pastor, what kind of girl are you telling me about?","Ah pastor, which kind babe you come dey follow me talk like dis?" "He then said, ""uh... the girl's name starts with uh... S.""",E con talk sey ehn di babe name start with ehn S. Then I started uh...,I con dey ah... Which S do I like in the department?,Which S I con like for department o? Ha!,Ha! Then he told me that uh... H comes after S.,E con tell me sey ehn ehn H come follow S. "Ah, so Sh, there's only one.","Ah dat one na Sh now, na only she." There's only one Sh we have in the department.,One Sh wey get for department o. "Uh... that one... that one is, is Shulamite.","Ehn and dat, dat one na, na Shulamite." Then I said I'd talk about it with you.,I con talk sey I go follow you word am. "Seriously, the guy, let me tell you.","Seriously, dat guy, mah I tell you." The guy doesn't love you.,Di guy no love you. Forget it!,Forget. The guy doesn't love you.,Di guy no love you. I'm the person God has tied you to.,Na me ehn be person wey be sey God don tie you with. You understand?,Shey you understand? "But the thing is that me, I myself have... God has shown me that it's that person I will marry.","But di tin be sey I, me ma, I don, God don show me sey na dat person I go marry." Forget it!,Forget! "I slept, I dreamt, I saw the guy in my dream.","I sleep, I dream, I see di guy live for inside my dream like dis." See!,See! Both of us had our wedding.,"Di two of us, we do wedding." See!,See! "So, for that, there's no argument at all.","So dat one, no argument at all." He's the one I'll marry.,Na im I go marry. "In Yoruba... in Yoruba... in Yoruba, we say something like ala go, that dream, dream is really stupid.","For Yoruba, for Yoruba, for Yoruba we talk something sey ala go, sey dream, dream stupid gan o." "So, your case, I don't understand then.","So your own ehn, I no con understand o." "That dream you had is just an ordinary dream, it's an ordinary dream.","Dat wan wey you dey dream, na dream, na ordinary dream." The one that I... that I saw is truly an inspiration.,"One wey me, wey me see eh, na inspiration gbam." "God just gave it to that pastor, like go and tell Adams.","God just carry am give dat pastor gben sey oya, go tell Adams o." "The pastor went and just rushed to my house like, man, this is what God told me.","Di pastor go just rush reach my house say oya, guy o, na wetin so, so, so God tell me be dis o." That's it.,Na im. "So, what you had is a dream.","So dat your own, na dream." Forget it!,Forgeti! Let's for-...,Meh we for-... Eh?,Eh? Don't follow dreams.,No follow dream o. "Dreams, ah!","Dream, ah!" Ah!,Ah! Aha!,Aha! Okay.,Okay. Dreams can deceive you.,Dream fit koba person. "Okay, I've, I've heard you.","Okay I don, I don hear you." You understand?,Shey you understand? I'll think about it.,I go tink about am sha. Uh... no.,Ehen no! "But the thing is that me, I don't like dating two people at once but since you said that a pastor has told you, no problem!","But di tin be sey me, I no dey like to dey double date, but since you talk sey pastor don tell you, no wahala!" But do you know tomorrow is Valentine's Day?,But you know sey tomorrow na Val sha. "Uh... tomorrow is Valentine's Day, but...",Ehn tomorrow na Val but... What happened then is that my uncle called me yesterday and said it seems like there is something that I want... we want to help him do in Lagos.,"Wetin come go happen be sey my uncle call me yesterday sey e be like sey, e get someting wey I wan, we wan follow am do for Lagos." Ah!,Ah! Ah!,Ah! It's like I will...,E be like sey I go... Wait!,Wait! Eh?,Eh? "We will celebrate Valentine's Day but it seems like I will not be around, but if I come back uh... we will celebrate Valentine's Day.","We go do Val, but e con be like sey I no go dey around, but if I come back, ehn we go do Val." Okay!,Okay! We'll celebrate it.,We go do am. It's no... it's no small thing.,"No be, no be small." "No, that won't be okay.",No dat one no go make sense now. "Ah, it's tomorrow, that will be okay.",Aha na tomorrow go make sense pass. "Babe, babe, love is something that you always show to people you love every day.","Babe, babe, love na something wey be sey person dey show love one for everyday." "Okay, I hear you.",Okay I hear you. Anyways.,Anyway sha. "You, when are you coming back?","You, na when you go come back?" On Saturday.,By Saturday. Eh.,Ehn. Okay.,Okay. "When you come back, the thing is that if you want me to accept you, there is this phone, a new phone, like that...","If you come back, di tin be sey if you wan make I gree for you, e get dis phone, one latest phone like dat..." I will buy it.,I go get am. Don't mention the name.,No mention di name. "Okay, you will buy it, right?",Okay you go get am abi? I'll buy it.,I go get am. "Then, the thing is that I haven't paid tuition.","Den, di tin be sey I never pay school fees o." There's the hostel fee too.,Hostel dey dere. I don't have money now.,I no get money now. "Babe, what now?","Babe, wetin now?" Is it conditional love you want to give?,Na conditional love you wan give me? No!,No now. "Aha, that's what my boyfriend does and since you said that you want... you want me to be with you...","Ah na wetin my boyfriend dey do be dat now, and since you say you wan, you wan make I follow you..." Aha!,Ah! "Man, that guy is a thief, that, that guy is a thief.","Guy, dat one na thief o, da-... dat guy na thief o." Where does he get the money?,Where im dey see di money? He's not a thief.,No be thief now. Aha!,Ah! No.,No o. "I, I don't know.","Me, I no know." "It seems like... it seems like this love... this love, I'll take it seriously.","E be like sey, e be like sey dis love, dis love, I go hang am o." But you give it to me.,So but you dey give me sha. "And you see that my hair, I need another style.","And you see sey my hair, I need to make another one." We'll go on.,We go resume. Forget it.,Forgeti. I do two hundred naira hair too.,Na two hundred naira hair me sef dey barb ah. Ah!,Ah! Mine is more than two hundred naira.,My hair pass two hundred naira o. "Babe, you, you are getting too expensive for me, please.","Babe you, you don dey too expensive for me jare ah." "Tuition, I haven't gotten to pay tuition either.","School fees, me sef never see money pay school fees." "But babe, you know that I love you, yeah.","But babe, you know sey I love you ehn." Do you love me too?,Shey you self love me? "Let's forget about material things, yeah.",Moh forget about material tins ehn. "Pure love, let's show pure love first.","Pure love, moh follow pure love first eh." Other things will follow.,Oda tins go follow. Okay.,Okay. Trust me!,Trust me. "This hair that you want to plait, plait it.","Dis hair wey you wan make, make am." Just write it down.,Just write am somewhere. "This tuition that you want to pay, pay it.","Dis school fees wey you wan pay, pay am." I'll give it to you later.,I go give you later. You'll give it to me later?,You go give me later? "Anything you want to buy, buy it.","Anyting wey you wan buy, buy am." "I'll give you, I'll settle it for you now.","I go give you, I go settle you now." "Okay, anyways, I'm hungry now.","Okay anyway sha, but I dey hungry now o." "Aha, you're hungry?",Ah you dey hungry? I'm hungry too.,"Me sef, dey hungry o." Let's go buy food.,Moh we go buy food. It seems like... it seems like...,"E be like sey, e be like sey..." "Tedder hasn't opened, Tedder hasn't opened.","Tedder never come, Tedder never come." "Me, I don't eat at Tedder.","Me, I no dey chop for Tedder o." "Ah, no.",Ah no. Ah!,Ah! Where do you eat then?,"Where you con dey, dey chop?" "First time coming to school, I, I'll go to eat at Tedder then?","First time wey I go enter school, me, I go con go chop for Tedder?" No.,No! You want me to cook?,You wan mah I go cook? "Alright, let's go cook at my house.",Oya moh we go cook for my house. "Let's go to Shoprite, let's go buy something.","Moh we go Shoprite, moh we go buy someting." "Shoprite, it seems like they said their manager is dead.","Shoprite, e be like sey dem talk sey deir manager die." They then closed the Shoprite today.,De con close di Shoprite today. "I dont know, I dont know why, ah.","I no sabi, I no know why aha." "Let's... let's go to the cafeteria, let's go to the cafeteria.","Moh, moh we go mamaput, moh we go mamaput." "I don't eat there, I, I'm not eating.","I no dey chop for dere o, me, I no dey chop." It's the only place that's available.,Na only place wey dey be dat now! Uh... let's go to Tantis.,Ehn moh we go Tantis now. "Tantis, mtchew, they always add too many Maggi cubes to their food.","Tantis mtschew, deir maggi too dey plenty inside food jare ah." I'll eat it like that.,I go chop am like dat. Isn't it... isn't it me who wants to eat it?,"No be, na me wan chop am now." "No, babe.",No babe! It's not you.,No be you. "Babe, you know I love you.","Babe, you know sey I love you." "I love you, aha.",I love you now aha. How could I let you eat something so bad?,Why I go let meh you dey chop someting wey bad like dat? "No, no, no, no.","No, no, no, no." That kind of thing is not good for your body.,Dat kind tin no good for your body. "A pretty girl like you, look at how black you are like a charcoal, ah.","Kind pretty girl like you, see as you black like charcoal ah." "Look at your teeth, look at your eyes, aha, look at that kind of hair, aha.","See your teeth, see your eyes ah, see di kind hair now aha." Look at those sexy eyes.,See di sexy eyes mstchew. What are you saying?,Wetin you dey talk? Let's not eat crappy food.,Moh we no chop bad tin jor. Okay.,Okay. "So, the cafeteria?",So na Mamaput? Do you understand?,Shey you understand? Let's go to the cafeteria.,Moh we go mamaput. "Mstchew, I don't like the cafeteria.",Mstchew I no dey like mamaput. Uh... even the cafeteria...,Ehn even dat mamaput sef... Ehm!,Ehm! "Don't worry, don't worry.","But no worry, no worry." Let me go and then come back.,Mah I go come back. I'll carry you.,I go carry you. Tantis?,Shey na Tantis? "Uhuh, there is this place at Trans.",Ehen e get dis place for Trans. "I heard that the, the guy, he does delicious... as in his sharwarma and pizza are really good.","I hear sey di, di guy, e dey do sweet, as in im shawarma, im pizza make sense." Let's go there.,Moh we go dere now. "Sharwarma, the guy, mstchew...","Shawarma, di guy, mstchew..." Burger uh...,Burger eh... "Let's just get ice cream, get sharwarma...","Moh we just take ice cream, take shawarma." The guy's shawarma is always too salty.,Salt too dey plenty for di guy shawarma. Why do you always complain like this guy?,Na why you too dey complain like dis guy? What?,Wetin sef? Uhuh!,Ehn! "Tell me that you don't have money, aha.",Tell me sey you no get money aha. "No, no.","No, no!" "Uh... ah, no, no.","Ehn ah no, no." "You too, you know.",You sef sabi now. Alright!,Oya! "If you have money, get out your wallet.","If you get money now, bring out your wallet." Show me fifty thousand naira.,Show me fifty K. "I'll know that yes, you really have money.",I go know sey yes you get money. "Look, let me tell you something,","See, mah I tell you someting." Eh!,Ehen. I am a Lagosian.,"Na Lagosian me, I be." You don't carry money?,You no dey carry money waka? And you have...,And you don... Cashless policy!,Cashless policy! It is...,E dey... It's good for our economy.,Dat one good for our economy. Show me your bank account.,Show me your bank account. Bank account?,Bank account? The balance on your phone.,Your balance for your phone. My balance?,My balance? Eh!,Ehn. "As soon as I receive it, I delete it.",Na as I dey receive I dey delete am. Haha.,Haha. That's the situation.,Na im con be di tin. You are strange.,Na wa for you o. "Babe, I have money.","Babe, I get money." "Okay, I have a payment system in my bag.",Okay I get POS for my bag. Ah!,Ah! "Babe, I didn't come with my ATM card.","Babe, I no carry my ATM now." "Aha, I would have shown you, seriously.",Aha I for show you serious. "Look at how I am, I know how to take care of a lady.","See as I dey so ehn, I sabi take care lady." Let me tell you that.,Mah I tell you dat one. "I know how to take care, ah!",I sabi take care ah! People have even started saying that uh... I'm too... I'm too caring.,"Even people don dey talk sey ah I too, I too dey caring." You should just give me a try.,You just try me. You understand?,Shey you understand? "Okay, I'll try you out but one thing is that in our house, any man we get married to, he's the one who washes the clothes, he's the one who fetches water.","Okay I go try you, but one tin be sey for our house o, any man wey we marry, na im de wash clothes, na im dey fetch water." "The wife, it's... her job is just to cook.","Di wife, na, her work na just to cook." "In the morning, you go and fetch water.","But in di morning, you go go fetch water." "You'll wash the dishes, you'll do everything and you'll sweep the floor.","You go wash plates, you go do everytin, you go sweep floor." See!,See! I'll buy a washing machine.,I go buy washing machine. I'll drill a borehole in the house.,I go do borehole for house. "In fact, it'll run through our bed.",In fact e go run trough our bed. Let me tell you that.,Mah I tell you dat one. Your job is just the kitchen and that other room.,"Your work, na just kitchen, and dat oda room." Which other room?,Which oda room? "Aha, why marry you and say you'll just be in the kitchen.",Aha why I go con marry you say na only kitchen you go con dey? Are you going to sleep in the kitchen?,Na kitchen you go dey sleep? I won't be sleeping in the kitchen.,I no go dey sleep kitchen now. "Uhuh, we'll be sleeping in the other room.",Ehen we go dey sleep for oda room now. I'll have a separate room.,I go get separate room now. "No, babe.",No o babe! That's how we do it at ours.,Na so we dey do for our side. "Uhuh, no problem, no problem.","Ehen no p now, no p now." "Because I love you, anything, I'll do it for you.","Unto sey I love you, anyting, I go do for you." Okay.,Okay o. "Okay, me, I've accepted you.","Me ma, I don gree for you." "Uhuh, let's go to my house so I can cook for you.",Ehn moh we go my house mah I go cook for you now. "Alright, no problem.",Oya no wahala. Let's go.,Moh we go. "Uhuh, alright babe.",Ehen oya babe. "Okay, if you want to make gote, uh... after you buy ingredients from your market, as you come back, and get home, uh... the first thing I do, I put the leaves in water, then add salt.","Okay if you wan make di gote, ehn after buying dose ingredient for your market, as you come back, come reach your home, ehn di first ting wey I go do, na di leaves wey I go put for water, den put salt." Why should I put salt?,Why should I put salt? "I add salt to kill the germs that have infested the leaves because, on the fire, I won't leave it for long.","I dey put salt make e kill di germs wey don catch dis leaves because, on fire, I no go leave am tay o." It's just... about five minutes.,Na just about five minute. "So as I put it in the water with some salt (because vinegar, I won't be able to get that all the time), then, I will take my bones (marrow bones, that's what we normally use because they will make it tasty), put them on the fire, add onions and then tomatos.","So as I put am for water wit some salt (because vinegar, I no go fit get everytime), den, I go carry my bones, biscuit bone (dat is di one dat we normally use because e go make am sweet) put am for fire, put onions, and den tomatoes." "If I want, sometimes, I make it without tomatos.","If I want, sometime, I dey make am witout tomatoes." "While it's boiling there, I will come and sit down, cut my garden eggs (yalo), tiny ones, to give it that bitter taste.","As e dey boil dere, I go come sit down cut my garden eggs, yalo, tiny ones to give it dat bitter taste." "As I... as I cut them, I will come and add them on top of the bones, as it is boiling on the fire.","As I, as I cut am, I go con add am on top of di bones as im dey boil for fire." "Then, I will cut my leaves.","Den, I go come now cut my leaves." "As I am cutting them (you know some of them have to stay a bit longer on the fire while some are for five minutes), I will bring it down.","As I dey cut am (you know some of dem have to stay a bit longer for di fire while some, na five minutes), I don bring am down." "Now uh... the yakuwa [red sorrel], I will put it on for... let's say ten minutes.","Now eh di yakuwa, I go put am for say ten minutes." "So as the fi-... fi-... bones are boiling, I will come and add the yakuwa [sorrel].","So as di fi-... fi, bone don dey do, I go con add di yakuwa." "That means I have added my garden egg, right?",I don add my garden egg be dat bah? "Then, it is boiling, boiling.","Den, e dey boil, boil." "I don’t like the one with uh... groundnut... adding groundnuts, but some people do add it, or beans.","I don't like dat of ehn groundnut, adding groundnuts, but some people dey add am, or beans." "But mine, it's plain, I take it without groundnut.","But my own, na so plain I dey take without groundnut." "Then, I will cut the leaves, everything, keep it on the side, carry my acha.","Den, I go con cut di leaves, everyting, keep for side, carry my acha." "The acha [hungry rice], I will use a little.","Di acha, na small I go fetch." Not a lot.,No be plenty. Just like uh... a tin... uhuh... for four people.,Just like ehn tin ehen for four people. "Just this small tin, I will get some.","Just dis small tin, I go fetch am." "Because it has stones, I have to wash it well, using a calabash.","Because e get stones, I have to wash it well using calabash." We use a calabash.,Na calabash we dey use. "Add water, two, shaking it till it's clean, pour it until when... twice or three times, like this.","Put water two of dem, be shaking it clean, pour until wai twice, or three times like dis." "You will see the stones, they will go down.","You go see di stones o, de go con go down." "It's only the acha, that will go to the other uh... dish.",Na only di acha go go di oder ehn dish. "Then you will pour it, do it again for about two or three times.","Den you pour it, do it again about two three time." You should make sure that all the sand has come off.,Make you make sure sey all di sand don comot. "Finish that, then you will pour it.","Finish dat one, den you pour it." Then you'll stir it.,Den you go dey stir. You haven't added the leaves yet.,You never add leaves o. You will be stirring it.,You go dey stir. "When it gets thick, then, you will take the spinach, and the other leaves which you have cut and kept aside, and add them.","When it becomes thicken, den, you now carry di spinach, and di oder leaves wey you don cut before keep for side add." "And then, you will stir it, cover it and leave it for... let's say five minutes, like this.","And den, you stir, cover, leave it for say five minute like dis." It will be ready.,E go don do. "Don't keep it on the fire for too long because if it stays for too long, even the leaves, they will change color, uhuh... and maybe the nutritional value will get destroyed.","Make e no overtay because if e tay too much, even di leaves, e go change colour ehen, and maybe di nutritional value go destroy." "So, you have to leave it like that.",So you have to leave it like dat. Bring it down.,Bring it down. It is now ready.,It is now ready. You can eat it.,You fit eat am. "And this gote, we like it so much because it is very nutritional.","And dis gote o, we like it very much because it is very nutritional." "All these things... ingredients you are adding, they have vitamins, minerals, and other things.","All di tings, ingredient wey you dey add, vitamins, minerals, oder tings dey." "So, that is what we make.",So na im we dey make. "Once... for lunch, we do have it.","Once of our lunch, we dey take am." "Bones, the meat, it's proteineous.","Bones, di meat is proteinaceous." "The acha's got protein too, right?",Di acha too get protein abi? "Uh... in the leaves, there's minerals, vitamins and other things.","Eh in di leaves, minerals, vitamins, oder tings dey." "So, I don’t... we don’t... I do not add oil.","So I don't, we no, I no dey add oil o." No oil.,No oil. It's plain.,Is plain. Don’t add oil.,No add oil. Most people don’t like it with oil.,Most people don't like it wit oil. That is how we eat it.,Dat is how we take it. "Uh... so, that is how we cook it.",Ehn so na so we dey cook am. "Then, you will eat it.",Den you take it. "When you finish eating it, if you want to drink something, you can take kunu or gruel, the local kunu that we drink.","If you finish eating, if you want to push it down, you fit take kunu, or gruel, di local kunu dat we take." Drinking it will help with digestion.,Den you push it down wit it. "And this one... this uh... gote, right, is very good, not only for a medicinal pur-... diabetes.","And dis one, dis eh gote bah, is very good not only for ah medicinal pur-... diabetes." "People that have diabetes, you know, you will not be able to eat rice.","People dat have diabetes, you know you no go fit take rice." "You will not be able to ea-... eat uh... corn, but acha is good.","You no go fit ti-... take ehn maize, but acha is good." So it is recommended for them.,So it is recommended for dem. "And when you are sick, and you're recovering, it is another recommended food for convalescence.","And when you sick, and you just dey recover, it is anoder recommended food for convalescence." "That's what we give people because if you have no appetite, it'll give you an appetite.","Na him we dey give people because if you no get appetite, e dey do." "Even for small children, it is very good for every...","Even small children, it's very good for every..." "The... this word... gote, right, is the best for pregnant women because it strengthens the blood.","Di, dis word, gote ma, is di best for pregnant women because e dey add blood." "The leaves, they strengthen the blood.",Di leaves dey add blood. "Even if you go to this uh... kind of normal maternity, they do tell us that we should eat plenty of leaves, so this thing of ours, our blood, will be strong.","Even if you go for dis dem ehn normal maternity of a ting, dem dey tell us make we take plenty of leaves so dat our dis ting, our blood go come." "So, it is not only for the rich people as... even if you are as poor as anything, you can cook this gote.","So is not only for di rich people as even if you are as poor as anyting, you fit make dis gote." "Very little money, very little money.","Very small money, very small money." "If you have two hundred naira, or five hundred naira, you can cook gote for the household.","If you have two hundred naira, or five hundred naira you can make gote for di househood." "Buy these leaves o-... one hundred naira, two, two hundred; the garden eggs, fifty naira; hip-... spinach, fifty naira; the other leaves.","Buy dis kashi o-... hundred naira, two, two hundred, di garden egg fifty naira, hip-... spinach fifty naira, di oder leaves." That is all.,Dat is all. "And the acha, a little.",And di acha small. That is all.,Dat is all. So it's very affordable.,So is very affordable. You can afford it.,You fit afford am. It's not expensive.,E no dey expensive. "So everybody can make this and have a good meal, a balanced diet, that at least won't hurt your wallet.","So everybody can make dis, and have a good meal, balanced diet wey at least your pocket no go suffer." Look at the buildings here and there.,Look at di building here and dere. "Everywhere is full of houses, houses... beautiful houses... beautiful houses... beautiful houses.","Everywhere na about house, house, better house, better house, better house." Ours is not wi-...,Our own no be wi-... We are not different from them.,"We no dey different dan, like dem." The same thing do... we are the same.,"Na still di same tin wey de be, na im we be." "So all those kinds of things, it's not good.","So all dose kind ting, e no good." "It's good if you... if... that... they should give a helping hand to your people, they should help those... the people who are better... help people who are better than you because you don’t know where the help will come from.","E good meh, if, sey make e dey help your people, dey help di one, di people wey better pass, dey help people wey better pass you cause you no know where di help go come from." So this year... I know that this year... this year will not pass me by.,"So dis year, I know sey dis year, dis year no go pass me by." "And this year, I already know that this is my year.","And dis year, I don already know sey dis year na my year." "And it's my year of testimonies, my year of blessings, my year of divine... made... uh, uh, uh mercy, that’s what this year is.","And na my year of testimony, my year of blessing, my year of divine med-... eh eh eh mercy na im be dis year." "So I know that as this year is moving on, myself, I am moving along with it.","So I know sey as dis year dey carry on so, me, I dey carry on dey follow am." I am following it closely.,I dey bumper dey follow am. "Because I know that the way this year is presently... the way I am looking at this year, I know that the year is sh-... will bring good fortunes to me.","Cause I know sey di way dis year be now, di way I dey look di year, I know sey di year dey sh-... go shine for my head." "So, so this year, I have committed everything to the hands of God",So so I don cover everyting put for God hand dis year. That... I know that there's no way this year will not be good for me!,Sey I know sey no how wey dis year no go better for my life. "So I am praying that as this year goes on, let it begin.","So I dey pray sey as dis year be now, moh we start am." "People with no professional training (because working as a security guard is not a profession), if you know that you are still young enough to learn a trade, you'd better go for the training.","People wey no learn work (because security work no be work), if you know sey your age still dey you for make you learn work, you better go learn work." "If you prefer to go into business, you go into it.","If na business, you enter business." He should introduce you to anyone he feels comfortable with.,"Anyone wey e know sey im go carry you, e carry you go." Because people have worked as security guards... I have met some people.,"Because security work, people don do am, I don jam some people." "Myself, it's been three months now.","Me, na three months now." "That I've been on the job, but those three months feel like a hundred years to me.","Na me, I don do am, but dat three month don dey me like sey na hundred years." "Some people said they have been on this job for twenty years, got married with the proceeds, had five children... had ten children, without a house.","Some people don say de don do am twenty years, carry am marry wife, born five children, born ten children, no house." "They don’t even have a place to lay their heads, which is not good.",De no even get place wey de dey put head dey lie down which no good. So whoever knows that...,So anybody wey know sey... The things he will do will bring him good luck.,"Tings wey im go do, e go favour am." "If it is work, you will go and learn.","If na work, we go learn." "If it is houseboy and you still have enough time, you go and be a houseboy.","If na boy, time still dey your hand, you go do boyi." "Being a houseboy does not bring good luck, but it does bring some people good luck.","Boyi no dey favour, but e get people wey im dey favour." But when you're well behaved... but it's better to go for some vocational training.,"But when you calm your hand down, but it's better meh you go learn work." Engage yourself!,Spend time! "In the next four or five years, you'll have become your own boss.","Like four, five years, you don get your own." "Before you know it, in two or three years and you'll have eased off.","Before you know, two to three years, you don relax." "He's started living large, bought equipment or tools, rented an apartment, bought land to build a house on, begun to enjoy life like the others.","E don dey do big boy, don buy machine, rent house, buy property put for house, begin dey bubble like oders." But now wa-... the way we feel nowadays... we need quick money.,"But now wa-... di way im dey us now, we need quick money." Bringing in money is what we need now.,"Ego buta, na im we need now." We need to go and bring in money.,"To go carry di money come, na im we need." "Because the way we are looking at the world, it looks as if it is late already.","Because di way we dey look di world now, e be like sey don even late for us sef." But I know that it's not late yet.,But I know sey e never late. But I know that God will do it.,But I know sey God go do am. God will do it because we were destined to help our mother who is in the village.,"God go do am for us because our moder for village, de born us meh we help dem." "And since we were born into a poor family, there's no money.","And as we born for poor family, no money." We were not even given money for a soft landing here.,De no even give us money moh we take carry come. They are looking up to us.,Na our hand na im de dey look. "December is over, we didn't go.","December don pass now, we no go." "New Year's is over, we didn't go.","New year pass, we no go." And they're still looking out for us.,And de still dey look for us. There's no way you arrive the village without taking bread along... you can't go to the village without taking bread along.,"No how wey you land now, you no go buy bread, no how wey you go village, you no go buy bread." "You will buy the traditional wear for your mothers, and you'll still give your mother some pocket money worth between five thousand to ten thousand naira.","You go buy wrapper for your moders, still give your moder pocket money like five thousand, ten thousand." "So the woman will be smiling as she takes from it, saying that uh... her son is back.","Meh di woman dey take am, dey smile say ehn im son come back." Imagine that you go empty handed.,And you con come go empty handed. No money; nothing.,"Money no dey, noting dey." "My brother, it will like if your case is different.",Nna e go con be like sey your own dey different. "But I know that this year, all those things will become a thing of the past.","But I know sey dis year, all dose tings go pass." "This year, any boy who will be travelling this year...","Dis year, any boy wey dey go travel dis year..." We're in January now.,"Now January, na im we dey." "From now on till December, everyone will buy cars.","From now till December, everyone go buy motor." "In fact, before you go home, if you will be driving down, tippers... about fifty tipper loads of sand will follow you.","Before you go go home sef, if dey go dey drive dey go, tipper, about fifty tippers wit sand go dey follow you." "One trailer of uh... cement, they'll follow you so that people will know that yes, God has remembered the people they've forgotten about for many years.","One trailer of eh cement dey go dey follow you so dat people go know sey yes people wey de forget for many years, God don remember dem." Isn't this the case for us?,Sey no be our own case? Our case is no different.,Our own case no dey different. And our God's reach is long enough to save us.,And our God hand no dey too short to save us. "And uh... he, he hears our cry every day.","And ehn im, im dey hear our cry everyday." "He hears our prayers every day, but I know that there is time for everybody when God blesses, blesses them... there is time for everyone when God says, ""ti-... today is your day.""","Im dey hear our prayer everyday, but I know sey everybody get im own time wey be sey God dey dey bless am, everybody get im own time wey be sey God say ti-... today is your own day." The day you get your own blessings.,Sey you receive your own. And I know that God will do it for us.,And I know sey God go do am for us. So we won't...,So we no go. "If we are looking up to someone as the one to bless you, that means you will not get blessed.","If we dey look person meh person do you, dat mean sey you no go get am." "Rather than your brother looking to you to bless you, he will bless another person.","Instead wey your broder go do for you sef, e go carry am go do for anoder person." "Or he will ask you to go find your own blessings, since he found his own.","Or e go tell you sey meh you waka go find your own, sey im ma, don find im own." "So if you're looking up to someone to get blessings from, that means you will won't get blessed in life.","So if you dey look for person now meh person do for you, dat mean sey you no go get am for life." So go anywhere you know that your breakthrough will come from.,"So anywhere wey you know sey you go put to head, you put to head o." And the way...,And di way... Any strong place.,Anywhere hard. Go there right away!,Put to head now! Not just anywhere.,No be sey anyhow head. Some places will lead you to death while others will lead you to victory.,"E get place wey you go put head sef, dat place go kill you, e get place wey you go put head kwa, dat place go favour you." "But with the situation of things in Nigeria at present, nobody knows where to get solace.","Ehn di way Nigeria be now, nobody know where im go put head." "You don’t know whether to go into politics or go into business or which person should become a bus driver, or go into business, or become an errand boy, or what exactly?","You no know wheder you go put your head for politics, or make e put head for business, or moh we put head for conductor, abi na business, abi na boyi, abi na which one?" What we've gotten ourselves into has become a problem.,Di one wey we put head now don dey put our head. It's even killed... it's brought death to us already.,"Dat one wey even kill, e don already kill us." "But we will still have a way out, and the way out will make for a good escape.","But de will still remain one bar, and one bar now go still be full bar." Yes!,Hm! "So as I speak, I have put it into God's hands for Him to settle us this year.","So as I dey talk now, na God hand na im I carry am put sey God go do it for us dis year." "And as we are talking about it today, the tenth day of January, twenty eighteen, God is... will surely keep going until the year two thousand and twenty.","And as we dey talk am today wey be di tenth of January two eighteen, and na so God dey, go take carry am on till di year two thousand and twenty." "And as we have started talking about it today, boy, it's reaching God's ears, and He is listening to us.","And as we dey start today dey talk am so, boy, im dey reach God ear, and im dey hear am." And that's how...,And na so... "He said anything we say in Jesus' name, so be it.","E say anyting wey we talk say in Jesus name, na so shall it be." And that’s how he will mark it.,And na so im go mark am. "And as we are talking about it in this moment, we have put it into God's hands so He will do us good in Jesus' name.","So as we dey talk now, we don put am for God hand say im go do well for us in Jesus name." Amen!,Amen! "They take sports very seriously, very important, and they want Nigerians to uh... watch the matches.","De take sport very serious, very important, and de wan meh Nigerians ah dey watch di match." "Alright, as it is, the NNL [Nigeria National League] has bad news for us this morning because uh... we heard that the bus carrying NNL, Nigeria National League side, Osun United... hey, it was attacked by armed robbers... hey, they were attacked at night when they were leaving uh... Calabar for the venue of yesterday's match.","Alright o, as e take be, bad tory dey inside NNL dis morning o because eh we dey hear sey di bus wey carry NNL, Nigeria National League side, Osun United, hey o di arm robbers, hey de attack dem for inside night o for when de dey travel comot eh from of course Calabar dey go yesterday venue." "As gathered, it was along the Ore - Ondo - Akure express way.","As e take be, de say along Ore Ondo Akure expressway." So these men who were operating in the middle of the night attacked this team.,Na im dese men wey de waka for inside midnight come kpake dis team o. "It was reported that they beat the players and their coach, they even cut uh... butchered the head of the driver with cutlass.","De say de beat players, beat coach, even come cut e cutlass cut di head of driver." "According to the story we got this morning from Osun United's spokesperson, Tunde Samshudeen, he said the bus driver is in critical condition.","Hey o according by di tory paper wen be sey we get dis morning from Osun United spokesperson wey de call Tunde Samshudeen e say di bus driver now, de say na critical situation na im be im own." He said he's in the emergency unit uh... in the General Hospital in Ondo town.,Sey im dey for emergency unit eh inside general hospital for inside Ondo. "Most of the players were said to have sustained different degrees of injury from the attack, including the goalkeeper.","Most of di players sef, de say de get injury of different degree inside di level plus including goal keeper." Ayo Ojo and Olabisi Olagunju said their bodies were mutilated by these armed robbers in the attack.,"Ayo Ojo, and Olabisi Olagunju say all of dem o, na im dese arm robbers carry take come butcher deir body ahah for inside di arm robber attack wen de suffer." "Yes, it was reported that Osun United's coach, Rier Duke Udi, was beaten mercilessly in the attack.","Yes o Osun United coach, Rier Duke Udi sef, de say de beat am wella inside di level." "The Omoluabi guys, as they are being called, travelled in a thirty two seater bus on their way out of Calabar after they played with you-... uh, uh... Unicem Rovers in U.J Esuene Stadium.","Di Omoluabi guys wey de dey call dem, yes na thirty two seater bus na im de carry dey travel comot from inside Calabar after de don play you, eh eh Unicem Rovers for UJ External Stadium." "They lost two - zero, but they said their car had a minor problem.","De lose two zero, but de say deir car get small problem." That’s why their journey was delayed.,Na im make deir journey come delay. So the night fell on them while they were still in Ondo.,Naim na night come catch dem for inside Ondo. Then these p-... bad people... these bad people doing evil things at night came into the scene.,"Naim dis p-... bad people, dese bad people wey dey do badness for night come enter inside di waka." Hey!,Hey o! "May Father God help these people, so that they get well very soon because uh... as it is currently, they need to continue with their job which is...","Meh Baba God help dese people, meh de well quick, quick o because eh as e take be so, de need to continue to dey do deir trade wen be sey..." "Now football... alright, before we take our leave this morning, let me confirm that presently, Real Madrid players are really happy.","Now football, alright, before we go dis morning, meh I confirmate una sey as e take be so, players of Real Madrid, na Asonto dem dey dance dis morning." Why?,Why? "Their president, Florentino Pieres, has confirmed that because they did well, they won... they won the Super Europa... the Super League, they won the FIFA Club World Cup, they won La Liga, and they won the Champions' League; he said he will hit each of them two million pounds.","Deir presido wey de dey call Florentino Pieres don confirmate sey because of sey de do well, de win, de win Super, Europa Super League, win FIFA Club World Cup, win La Liga, win Champions' League, e say oya, sey im go slap each of dem wit two million pounds." "Wow, so much money!",Chai see money! "Oh, on top of this money story, I have another story for you this morning which involves money.","Oh ontop dat money level, na im I go kput you come dis morning because anoder money level dey." "Manchester United... oh, this football club!","Manchester United, oh dis ball club!" "Now, I know news club.","Now, I sabi news club." "Yes, as it is, they are the richest club in the whole world because they are in the top position.","Yes, as e take be so, now dem be di club wen im get money pass for obodo world because according by force, na only dem sit down on top number one position on top di level." They made three point two seven billion dollars just this year.,De get three point two seven billion hey o dollars inside dis year only. "Wow, so much money in Manchester United!","Kai, too much money Manchester United!" This is where we draw the curtains this morning.,Na here we be to come inside di waka dis morning. We’ll bring you more stories tommorow morning.,"Tomorrow morning, we go bring onto una." "Meaning that, you'll get to hear everything happening in the world of sports.","E come to mean sey every, inside ministry of sportology, una get to hear am." "Most importantly, my name is Triple A.","On to di behalf of di biggest one ah, my name na Triple A." "Please, help me tell someone close to you and those ones who are far away that nobody should get lost and no one should fight any time.","Abeg, help me tell somebody wey dey near you, and dose one wey im far meh people no lost, meh im quarrel for no day." God is in charge.,Baba God dey. He blesses your heart!,Bless your heart! "Good morning, Port Harcourt!","Port Harcout, una good morning!" My name is Silver Vick.,My name na Silver Vick. "You know, I'm telling you, very soon, I'll celebrate my one year anniversary of coming teaching you.","You know, I tell una sey very soon, I go celebrate one year anniversary wey I don dey come, I don dey teach una." Do you understand?,You understand? "And there is w-... where I stopped last week, that’s where I want to start from.","And e get w-... where I bin stop last week, na dere I want start." I...,I... "Porico, I've been talking about something.","Porico, I bin talk someting." "I've been... I've been giving an analysis of the average child in Africa, or Nigeria precisely, who studies in a Nigerian University, in fact, most of the Nigerian Univerisities.","I bin, I bin dey give analysis of di average pikin for Africa, or Nigeria precisely wey dey go Nigerian university, in fact most of Nigerian university." "And I'm talking about it, I'm saying it aloud; I said I'm angry.","And I dey talk am, I dey talk am loud, I say I dey vex." "I said, number one, it's totally irrelevant for a kid to go to university in a country where we know that there are no jobs.","I say number one, it's very irrelevant for pikin to dey go university for country wey we dey sure sey no job dey." Do you understand?,You understand? "You know that as you graduate from the university, there are no jobs waiting for you.","You know sey as you come out, no job just dey wait for you." That's a stupid investment.,Dat na stupid investment. That's what the white people call it.,Na so Oyibo call am. "Then in Pidgin English, that's an 'anyhow investment'","Den for Pidgin English, na anyhow investment be dat." Do you understand?,You understand? "Now if kids are to go to school in this country, then the people in authority should really make sure that they provide jobs so that the gratuating students will employed immediately.","Now if children go dey go school for dis country, den people wey dey top go try very, very well make de dey provide job make de dey come out come work." Because every average child is a p-... is their mom's investment.,Because every average pikin na im p-... na im mama investment. How are they their parents' investment?,"How e take be im mama, and papa investment?" "Currently, some parents are working as what we call civil servants.","Currently now, some parents dem dey work wetin we dey call civil servant job." "They'll start work by seven am, and finish by four.","De go resume work by seven am, de go dey close by four." Some of them have been on this job for almost forty years.,"Some of dem don dey di job, e don dey go forty years." Where's the salary going?,Where di money dey go? "They spend it on training kids in schools, and all the Nigerian universities that turn out students who will never be economically relevant.","De use am dey train some children for schools, and Nigerian universities wey dey graduate students dem wey no go everly dey economically relevant." How?,How? "You studied mechanical engineering, you graduated, and you didn't even open a hood.","You do mechanical engineering, you graduate, you no open bonnet." How did you study engineering?,How you take do di engineering? You haven't even set your eyes on an engine.,You no even see engine sef. "You studied math but on the average, you are better than the lecturer teaching you.","You do mathematics, di lecturer wey dey teach you, on di average, you better pass am." "Only one or two... a few private universities, are helping matters, and some that even if you want to go there and then you check the process to get into the school...","Na just one, or two few private universities just dey help di matter, and some wey be sey even if you want enter den you con even check di process to enter di school sef." "The brilliant ones, with sharp minds, don’t get into the schools because if you don’t pay for all the malpractices involved in the process, you don’t get in.","Di real one wey deir brain strong no dey reach enter because if you no pay for di malpractice, you no reach enter." Then the ones who get in corrupt the lecturers by giving them money; sorting everything out.,"Den di ones wey enter, na money de take dey even corrupt di lecturers, dey sort everyting." Then I started taking an assesment of an average child.,Den I come dey take assessment on average pikin. How are they an investment?,How e take be investment? "The budget for an average three month old... just the food budget alone, for their first three months after birth, is over three hundred and fifty thousand.","An average pikin wey dey three months old, on feeding budget alone, for three months from nine months pregnancy, you dey look budget of over three hundred, and fifty thousand." That's what the father has spent.,Na im im fader don spend. "So if you see a child of ten years old, you are actually looking at a food budget of over fifteen million naira.","So if you see pikin of ten years old, na over fifteen million naira feeding budget you dey see so." "Then when you see a man of twenty five years old, that is over sixty five million naira's worth of food budget.","Den when you see man of twenty five years old, dat is over sixty five million naira feeding budget." "That's what was spent on a child, just to keep them alive... feeding alone.",Na im dem put inside head of one pikin mey e just dey alive feeding alone. "Clothing, and housing.","Clothing, and housing." Then housing and clothing is sixty five million.,Den housing and clothing of sixty five million. "And then you go to a Nigerian university where you'll spend close to three million to graduate without any trace of what you studied, to start with.","Go con go one Nigerian university now wey you go spend close to three million to graduate, wey you no even see wetin e study to start with." Do you understand?,You understand? Then you will graduate,Den you go con graduate. And you will be worth over seventy million.,You go con worth over seventy million. "So what I mean is that only... every avera-... average graduate out there, roaming on the streets, is worth over seventy million naira in hard Nigerian currency and maybe you have about four graduates in your house.","So wetin I mean be sey only, every avera-... average graduate wey dey out dere for street dey roam about is worth over seventy million naira in hard Nigerian currency and maybe you get like four graduate for your house." That's your life savings loafing around your house.,Na your life savings just dey loaf around for your house. "Now, where are the available jobs in this country?",Now where di available job wey dey di country? Do you understand?,You understand? "So... if they eventually find jobs, do they get jobs for fifty thousand naira?","So if de kuku see di job, de dey see job of fifty thousand?" A hundred thousand?,Hundred thousand? "Tell me, a chid that graduates, that is worth seventy million, and a food budget budget, and education, including schools that lack lecturers (only a few have lecturers), who graduates and gets a job for fifty thousand, if that child is truly a financial investment to their parents, it means that child will not be able to pay back their mom until they, they die and are reborn seven times over.","Tell me, pikin wey graduate, wey worth seventy million, plus feeding budget, and education, plus school wey lecturer no kuku dey (na few wey just get di lecturer), now wey graduate con dey work job of fifty thousand, if dat pikin na truly financial investment from di parents, na im be sey dat pikin no go fit pay im mama till e, e die reincarnate even seven times." So it's called a wasted investment.,So it's called wasted investment. "Now they tell them there that any business you do in Nigeria, which keeps you up with the local currency, my brother, you are on top of the world.","De now come dey tell dem dere now sey any business wey you dey do for Nigeria now, wey dey regulate you to local currency, my broder, you dey high jump so." You're supposed to get into businesses which will give you unprecedented returns that are higher than global inflational rates.,You suppose dey do businesses wey dey allow your financial flow come beyond di borders on a global slate. "Until the country fixes itself up... since the country doesn't let in foreign investors, we ourselves will bring the foreign investors in.","Until di country kuku fix insef, since di country no dey allow foreign investors enter, we, we go bring di foreign investors in." "But first of all, you have to change your means of making money.","But first of all, you get to change your means of earning." "You have to change the fact that you must go to work by six a.m., leave by six... by six in the evening.","You get to change di fact wey you must go work by six a.m., close by six, by six in di evening." "Because nowadays, if you are working for another person, what do we call that?","Because now, if you dey work on anoder person job, we dey call dat one wetin?" Bribing you for your destiny.,Bribing you for your destiny. "Before you figure it out, you're already forty.","Before you go realize, you don turn forty." Is it at the age of forty you want to realize that you can make shoes or bags?,"Na at forty na im want con dey realize sey you fit make shoe, or you fit make bag." So is it the first point we need to solve this problem?,So wetin we take dey solve dis problem be number one? "The first problem in this country now is poverty, and hunger.","Di number one problem for dis country now, na poverty, and hunger." Then the second problem is misplacement of priority.,"Den number two problem, na misplacement of priority." "Because if you go to a Nigerian university, just go and study a course that's relevant to this present day country!","Because if you go university for Nigeria, go study course for dis current country o!" I'm not talking about another country.,I no dey talk for anoder country. "If you are in Nigeria and you study sociology, philosophy... that's a misplacement of priority because those kinds of things don’t have value in this nation right now.","If you dey Nigeria, your course na sociology, philosophy, dat's misplacement of priority because e no get value for dis nation right now." You mean you're studying political science?,You dey do political science where? In these chaotic politics?,For dis scattered politics? And those are the co-... CRK... why don't you go to Bible School?,"And na dose co-... CRK, you no go Bible school?" And those are the courses with the highest number of students.,And na dose courses get di highest number of students. "And if you take a close look at these students, you'll see they're not too bright.","And if you check dese students very well, na students wey deir brain don lock." They just want to get through school so they can say they got through school.,De want just pass school anyhow make e be sey dem pass school. Why aren't you able to advise these children?,Why you no fit advise dese children? "They should be doing things that will put money in their pockets, being aware of the fact that the more unemployed graduates we roll out, the more problems we create in this country.","Make dem go do tings wey go dey put money for deir pocket knowing sey di more graduates wey no get job we dey roll out, na di more problem we dey create for dis country." Everybody wants to obtain certificates.,Everybody want get certificate. "So first of all, you who's listening to me, you will solve your financial problem and then you will attend my training so that you will know how to place your priorities right.","So first of all now, you wey dey listen to me, you go solve your financial problem, den you go attend my training so dat you go know how to place your priorities right." "And if you've been working for another man for close to thirty years, my friend, it looks like you will be judged twice.","And if you don dey work for anoder man job, dey go thirty years, omo e be like sey your judgement na times two." "Because once you get to heaven, God will judge you first for your sins and then for wasting your life.","Because once you reach heaven, God go first judge you for your sins, den judge you for wasting your life." "He will ask you, ""the gift I gave you, how did you use it?""","E go ask you di gift wey I give you make you go practice, how you take use am?" """You helped fulfil another man's destiny.""",You go work for anoder man own destiny. So did the man not have his own plans?,So di man no get e own plans? "So first of all, if your problem in Nigeria at the moment is how to place three meals a day on your table... when you wake up every morning, your work (I wonder why you go to work) is to place three meals a day on your table, then the truth of the matter is that you don't exist.","So first of all, if currently your problem for Nigeria now na how to place three square meal for your table, every morning when you wake up, your work, why you dey go work be sey na you want place three square meal for your table, di truth about di matter be sey you never dey exist." The moment you start to exist is the moment you get to that level where you know that you don't have to worry over what you and your family will eat.,"Di moment you start to exist be sey di moment you don reach dat level wey be sey you wake up, you know sey wetin you, and your family go chop don ready." "That's the point where you can sit down and say, ""now, let us change the country!""","At dat point now, naim you fit siddown say oya make we change di country!" You can't tell a man who can't afford three meals a day to go and change the country.,"You can't tell a man who can not afford three square meals to go, and change di country." What will he change?,Change what? "Let hunger deal with him, he will change his decision in five seconds unless the hunger pangs are not strong enough.","Make hungry catch am, e go change im decision in five seconds unless dat worm wey dey im belle no strong." "As funny as it may sound, and as much as I'm joking, this is a serious matter.","As funny as it may sound, and as joking as I might be, na so serious di matter dey o." "Auntie, good morning!","Auntie, good morning." Good morning!,Good morning! How are you now?,How you dey now? I'm fine.,I dey fine. How was your night?,How your night? We thank God.,We thank God. Hope you slept well?,Hope sey you sleep well? "Ah, my sister, I slept well.","Ah my sister, I sleep well o!" You had electricity in your area last night?,Una get light for una area last night? We didn't.,We no get o. "Ah, what happened now?",Ah wetin happen now? It's NEPA.,Toh na NEPA o! "Aha, these people, I heard that they share the light.","Aha dese people, I hear sey de dey share di light." "My sister, it's tiring.","My sister, di tin tire me o!" Eh!,Eh! They share it yet they bring overestimated bills.,"De just dey share am, but de go dey bring big bill." Our ah...,Our ah... "In fact, that bill is another thing again.","In fact, dat bill na anoder tin again." "That it is, my sister.",Na so my sister. How much do they... how much... how much did they charge you on the bill?,"How much de dey, how much, how much de dey give una for una bill?" "Ah, my sister, it's seven thousand.","Ah my sister, na seven thousand o!" Jesus!,Jesus! Seven thousand for the light we don't have?,Seven thousand for di light wey we no dey see? That's right!,Na so o! "Ah, these people... eh, they won't kill someone.","Ah dese people, eh de no go kill person o!" My sister.,My sister toh. How are you managing?,Toh how you dey manage now? How is your business?,How your business? "My sister, I'm managing.","My sister, I dey manage am." Thank God.,Thank God! "Eyah, God will help us.",Eyah God go help us. Amen!,Amen o! There is one...,Toh e get one... There is a kind of dish that Mama Maro taught me.,E get one soup like dat wey Mama Maro bin teach me. The dish is good.,Di soup make sense. I heard that it's an Ibo dish.,I hear sey na Ibo soup. Uhuh?,Ehn? Uhuh?,Ehn? Ehn!,Ehn! I know you'll like it.,I know sey you go like am. Teach me too.,Teach me too now. Hope you know banga soup?,Shebi you know banga soup? I know banga soup.,I know banga soup. Ehn... it's the soup.,Ehn na di soup. Okay!,Okay! "So, it's like I'll come so you and I can do it.","So it's like I go come, me, and you go, go do am." Okay!,Okay! The dish will be good.,Di soup go make sense. You'll like it a lot.,"You go like am well, well." Okay!,Okay! Or should I give it to you?,Abi meh I give you. So...,So... Like can you tell me how they...,Like you fit tell me how de take dey... Do you know how they prepare the dish?,You know how de take dey cook di soup? "Ah, my sister... my younger sister taught me how they cook it.","Ah my sister, my junior sister bin teach me how de take dey cook am o." Can you tell me a little?,You fit tell me small? She said...,E say... She said you'll parboil the banga.,Eh e say you go parboil di banga. Uhuh.,Ehen. "After you've parboiled it, then you'll pound it.","After you parboil am, you go come pound am." Yes?,Yes? "When you pound it, you filter it.","When you pound am, you filter am." "Then, you add your ingredients.",Den you put eh your ingredient inside. That's how my sister taught me.,"Na so my teacher, my sister take teach me." Okay.,Okay na so. You like...,You dey like... You ch-... which... as in which food... like what do you eat it with?,"You ch-... which, as in which food, like which swallow you dey use like to eat am?" "Hey! My sister, I like...","Hey my sister, I dey like..." Is it starch or eba?,"Na starch, or na eba?" I like starch a lot.,"I dey like starch well, well." "Oh, good!",Oh confirm! "Starch hm, starch is what I like.","Starch hm, na starch I dey like." haha.,Hehe. F-... starch is what goes well with it.,Na f-... na starch dey go well. "Uh, that's what I like the most.",Ehn na dat one I dey like pass. Okay now!,Okay now! Alright.,Toh. "This morning, what did you eat before you came here?","Dis morning, wetin you eat before you come here?" "Ah, my sister, well, I ate eba!","Ah my sister o, mtschew toh I eat eba o!" Hey eba?,Hey eba? "Hehe, why didn't you drink tea?",Hehe why you no drink tea? "Hm, my sister, I don't really like tea.","Hm my sister, I no dey too like tea." Okay.,Okay. Who now?,Who sha? Swallow is what I like the most.,Na swallow I like pass. What did you eat before you went to bed?,Okay wetin you eat before you sleep for di night? "Ah, well, my sister, I just ate a litle rice.","Ah well my sister, I just take small rice." Okay.,Okay. Hm.,Hm. I hope the rice was tasty?,Hope sey di rice sweet sha? "It was tasty, aha!",E sweet aha! Okay.,Okay. "So, any, any news?","So, any, any news?" Did you hear any news about this place?,You hear any news for area? Ah! My sis-...,Ah my sis-... "Concerning this NEPA issue of ours, I heard that they said they want to come and disconnect the power tomorrow.","Concerning dis our NEPA issue, I bin hear sey de say de wan come cut light tomorrow." "My sister, that is how I heard it.","My sister, na so I hear am o." "They said, they want to come and disconnect the power tomorrow.",De say de wan come cut light tomorrow. Please!,Abeg o! They shouldn't come because we are tired of them!,Make dese people no come o because we don tire for dem! "Even me, I don't have money to pay.","Me masef, I no even get money to pay." This is a problem.,Hey dis one na wahala o. "That everywhere is dry, there is no money.","Dis one wey everywhere dry, no money." I just pray that they don't come.,I just pray make dem no come. "Ah, please!",Ah abeg o! Don't let them come!,Make dem no come! "Because if they come, it means it's the whole area that will have their lights disconnected.","Because if de come, dat means na all di whole area dem go cut deir light o." That's it.,Na so. Because people don't have money.,"Because people no, no money." Because there is no money.,Because no money. And we don't see any light.,And we no dey see light. At all.,At all! Please!,Ah abeg kai! Hm NEPA should not try us.,Hm meh NEPA no try us o! I'm not sure that they will even come.,I no sure sey dem go even come sef. Haha.,Haha. "Ma'am, I want you and me to go to the market next market day.","Madam, I wan make me, and you go market next market day." Okay!,Okay! Gwagwalada Market or Kwali?,"Gwagwalada Market, abi Kwali?" First we'll go to Kw-...,We go first go Kw-... What day is Kwali Market?,Which day be Kwali market? "Hm, it's tomorrow.",Hm na tomorrow. Tomorrow?,Tomorrow? Uhuh!,Ehn! "Ah, we'll try to go.",Ah we go try go o. What do you want to go buy?,Wetin you wan go buy now? There are some kind...,E get some kind... I want to go buy my shop items.,I wan go buy shop tins. There are some things that I need in my shop.,Mtschew e get some kind tins wey I need for my shop. I want you and me to go.,"I wan make me, and you go." Like what?,Like what? Like shampoo...,Like shampoo. Because you won't see provisions there.,Because you no go see provision dere o. It's true.,Eh na true o. Will I see shampoo and attach?,"I fit see shampoo, and attach ba?" "My sister, you won't see any.","My sister, you no go see o!" It's food products they have.,Na food product dey dere. Food products?,Food product? Ah!,Ah! Alright.,Toh. That means wo-...,Dat means wo-... "If we go, we'll just buy ingredients that we use to cook some dishes.","If we go toh, we would just buy tins wey we go take cook some kind soup." Okay now.,Okay now. "When I want to go, I'll come call you.","When I wan go, I go come call you." "Okay, no problem.",Okay no wahala! I'll be at home waiting for you.,I go house dey wait you. No problem then.,No problem now! "Me too, let me go hustle for money so that if we go I can buy enough things.","Me too, mey I go hustle for money so dat if we go, I go buy enough tins." No problem!,No problem! I'll call you.,I go call you. "Okay, no problem.",Okay no wahala! "Your number that you gave me last week, it's still the number you're using, right?","Dat your number wey give me last, eh last week, shebi na di number you still dey use?" It's what I still use.,Na im I still dey use. "X sometimes, I try to call the number.","X sometime, I dey try di number." The number doesn't connect.,Di number no dey go o. It's the network.,Ayah na network. "Ah, this network again!",Ah dis network again! Okay then.,Okay now. I'll give you my number before we leave here.,I go flash you with my number before we leave here. No problem then!,No problem now! I'm expecting it.,I dey expect am. What church do you go to?,Which church you dey go now? "My sister, it's CAC.","My sister, na CAC." CAC?,Cac? Hm.,Hm. You've left Pathfinders?,You don comot for Pathfinders? "Hm, mtschew, I've left.",Hm mtschew I don comot jor. I go to CAC now.,Dey go CAC now. How is the church?,Eyah how di church now?